Children fit spread coronavirus if schools reopen?
All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.
Live Coverage
Daniel Semeniworima
Coronavirus don spread reach Russia nuclear shipyard
Wia dis foto come from, Getty Images
Coronavirus don spread to one strategic shipyard for Russia’s Arctic north. Dis na place where dem dey keep dia nuclear-armed submarines which navy make.
Di place, Sevmash, wey dey di town of Severodvinsk, get nearly 30,000, staff but only half dey go work now, local tori agency Interfax tok.
By 26 May, 299 don test positive for coronavirus there.
For anoda town in Zvezdochki, where dem dey repair submarines, about 11,000 workers of di staff get coronavirus. At least one prson don die of Covid-19.
Russia defence ministry wan start clinical trials of Russian-made vaccine against Covid-19 on 50 volunteers.
But dem neva give specific details about di vaccine.
Thieves enta South African alcohol shop through tunnel
Thieves for Johannesburg South Africa don enta one shop where dem dey sell alcohol through tunnelled.
Dis happun wen dem bin ban di sale of alcohol sake of coronavirus lockdown restrictions.
Now dem don partially lift di restrictions.
Di manager of di shop just dey discovered wetin happun on Friday, wen she bin return to work to prepare to re-open on Monday.
Di thieves bin use di electrical and storm-water tunnels under another shopping centre and then break through di concrete floor wey dey solid, e come leave hole. Local tori South African news tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Dem come back several times to steal whiskey, brandy, gin, cider, vodka and beer wey fit cost 300,000 South African rand ($17,000).
Coronavirus patients for Mozambique dey threatened with killing
Wia dis foto come from, Getty Images
Health officials for Mozambique say discrimination against people wey dem suspect to get coronavirus dey grow.
In di central city of Beira, reports dey come say dem dey threaten those wey dey infected with killing.
Dis don lead to di fall in di number of pipowey dey go hospital to report sickness.
Health workers dey try convince communities to get medical help when needed.
Dis wahala don also make health ministry to reduce di amount of informate wey dem dey release about di disease, plus including not disclosing locations of places where dem confirm cases.
Nigeria get di second highest Covid-19 cases for Africa - WHO
Nigeria don record di second highest cases of coronavirus
for Africa, according to World Health Organization.
Di health join body announce dis one on Tuesday.
WHO say di Covid-19 cases for Africa don rise to over 150,
000, as of June 2.
According to dem na over 150,000 confirmed COVID-19 cases
dey for Africa – more dan 63,000 pipo don recover from di disease and 4,200
pipo don die,’’
Di latest informate from di health join body show say South
Africa, Nigeria, and Algeria don report di highest cases for di continent.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
According to di report, South Africa get 34,357 cases and
705 deaths, followed by Nigeria with 10, 578 confirmed cases and 299 deaths,
while Algeria get 9,513 confirmed cases and 661 deaths.
Ghana don report 8,070 cases and 36 deaths, while Cameroon
record 6,397 confirmed cases and 191 death.
Na Lesotho, Seychelles and Namibia get di lowest confirmed
cases for di region.
Tori be say Lesotho get only two confirmed cases with no
death, while Seychelles get 11 reported cases and zero death, Namibia record 25
confirmed cases with no death also.
Tokyo draw ear give after sudden increase in coronavirus cases
Wia dis foto come from, EPA
Authorities in di Japanese capital, Tokyo, don issue alert after 34 new coronavirus cases dem confirm on Tuesday.
Dis dey happun one day after dem ease restrictions on businesses like gyms and department stores.
"Di purpose of dis alert na to make residents dey aware of our situation and urge dem to be careful," Governor Yuriko Koike tok.
She tok say if cases continue to dey increase, she go consider to bring back di shutdown for di kontri.
Dis is di first time di number of infections rise above 30 since mid-May. Officials say di cause include nightlife in di Shinjuku area.
Japan don confirm more than 16,800 cases and 900 deaths from Covid-19.
Plenti traffic as Abu Dhabi dey enforce entry ban to dia kontri
Wia dis foto come from, EPA
Fotos from Tuesday in Abu Dhabi dey show plenti queues of cars for one security checkpoint between di emirate and dia neighbour Dubai.
Abu Dhabi, wey bi di capital of di United Arab Emirates, don enforced one-week ban on traffic into and out of di emirate.
Di ban, wey start from today, no go also allow pipo to travel inside di kontri main cities. But dem allow movement within cities as long as pipo obey di night curfew.
People fit apply for permits in exceptional circumstances. And that one go include essential workers and patients wey get chronic diseases and wey get medical appointments.
Di emirate dey also reopen hotel beaches, museums and sports activities.
As e bi di UAE don record more than 36,000 cases of coronavirus and 66 don die.
Wia dis foto come from, EPA
Tokyo give stay at home alert as virus infection increase
Goment for Tokyo, di capital of Japan don tell im pipo to stay for dia house unless dem get urgent business, plus make dem practice social distancing.
Di authorities give dis order afta dem record 34 new coronavirus infections, di highest wey dem don record since early May.
Japan bin lift state of emergency for di capital on May 25.
Ethiopia need 131m face mask to fight Covid-19
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Ethiopia make wearing face mask mandatory
Ethiopia health minister say di kontri need 131 million face masks in di next four months.
Lia Tadesse, say na hospitals and clinics across di kontri need di face masks.
Di kontri don begin to manufacture am locally.
So far, Ethiopia get 1,257 confam cases of coronavirus and 12 deaths, according to World Health Organisation.
Senegal postpone school resumption as test positive
Senegal goment don postpone school reopening till further notice afta many teachers test positive to Covid-19.
Goment bin announce say schools go reopen on June 2, afta dem close for weeks sake of lockdown.
Di ministry of education say teachers test positive for some areas fro di southern part of di kontri but dem no to how many teachers or how many schools dey affected.
E say President Macky Sall "postpone di restart of classes until later to avoid any risk of spreading di virus for schools."
No new case of Covid-19 for Wuhan China
Authorities for Wuhan China say dem no get any new cases of coronavirus for di city wia di virus first appear.
Officials for di city bin test 9.9 million pipo from May 14 reach June 1, as dem begin see some new cases afta di first wave of infections.
China no dey count cases of pipo wey get di virus but no dey show any symptoms of di disease.
India record ova 8,000 coronavirus cases for one day
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Coronavirus cases increase for India
Coronavirus cases
for India increase on Monday as di kontri record 8,392 new cases.
Di number of
confamed cases for di kontri now don pass 190,000, including 5,394 pipo wey die
with di virus.
India recently don dey
record high number of cases almost every day.
Last week Saturday,
dem bin report new cases, just as India announce new relaxation of im lockdown.
Kenyan boy receive state award for im hand-wash invention
One Kenyan boy dey
among dos wey receive tuale from di goment sake of di hand washing machine im
build to epp for di coronavirus pandemic.
Nine-year-old
Stephen Wamukota use wood to lift jerrycan of water and e create handle from
which water and soap go dey comot from to avoid contact.
E tell im mama say, di available hand-washing facilities for im village for western Kenya, dey
expose pipo to coronavirus as dem dey touch each other.
Im father wey be
carpenter epp am build di handwashing machine.
Di boy dey among di
68 pipo wey di goment recognize say epp di kontri pull through di coronavirus pandemic.
Dem bin receive di inaugural Presidential Uzalendo (Patriotism) Award.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Uganda postpone school reopening as cases increase
Wia dis foto come from, reuter
Wetin we call dis foto, Di goment go continue im food distribution programme
Uganda President
Youweri Museveni don postpone di reopening of schools for final year students
for another one month.
Di president say to
reopen schools dey very risky as di kontri no get enough kits to test learners
every two weeks.
Oga Museveni say dem go give villages two television sets to
epp school children continue to dey learn book through television.
Public
transport go resume work but dem no go dey carry full load. Tricycles no go fit
begin carry passengers but go fit dey carry goods.
Churches,
mosques, bars, nightclubs and gyms go still dey closed for another 21 days.
Shopping malls go dey allowed to reopen as long as dem make sure say dia
customers dey observe social distancing.
Di distribution
of goment face mask go start dis month and anyone wey no get one to remain for
house.
Uganda
for Saturday record 84 new cases of Covid- 19, di highest di kontri get inside
one day.
Lagos record nine coronavirus deaths in one day
Lagos state goment for Nigeria say dem record nine Covid-19 deaths in one day.
According to one tweet from di state Ministry of Health, update as at 31st May, 2020 show say di state confam 188 new cases of coronavirus infection.
Di total confam cases for Lagos now na 4,959 wey bring di total number of coronavirus related deaths to 59 for di state.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Tanzania goment say dia coronavirus cases dey reduce
Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Schools reopen on 1 June even as pandemic dey
Tanzania Health Minister, Ummy Mwalimu say coronavirus cases don dey reduce as di kontri commercial
centre Dar es Salaam get only four active cases.
Madam Ummy for one
event for Monday say na God save Tanzania from di pandemic. Prime Minister Kassim
Majaliwa dey di event wey happun for Tanga region.
Di goment stop to dey
release coronavirus data since April afta di President John Magufuli accuse
health officials say dem dey exaggerate di crisis.
Di minister say Tanga
and Mwanza regions no get any case of coronavirus.
She tok say coronavirus
infections still dey active but she no give any numbers.
Madam Ummy encourage
pipo to continue dey observe all di preventative measures.
Older students for di
kontri go back school for Monday afta di goment say make colleges reopen for
final year students.
Una good morning!
Welcome to our live page coverage of all di latest tori on coronavirus for Africa and across di world.
Before we begin tell una about di big tori dem, make una reason dis proverb from Isaac Nababa Chonoko.
No forget to like and follow us for
Twitter
Instagram
Facebook
Wetin we call dis foto, Proverb of the day
Una Goodnight!
Dis na wia we go march break ontop our live coverage today.
No forget to join us tomorrow again.
You fit scroll down for Monday tori dem.
Remember, make you dey wash your hands. Covid-19 dey real.
Ghost schools for Bamenda, Yaoundé start even as Coronavirus cases di increase
Na ghost schools for Bamenda for Northwest Cameroon, school pikin dem remain but Yaoundé start school even as Coronavirus cases di increase.
Goment bi close school for March 17 as one measure for reduce spread for Coronavirus.
Afta two and half-moons goment decide say make pikin dem for exam class turn back for school dis June 1 for write dia exams.
Schools di open for taim weh kontri don confirm 6143 cases of covid-19 and fear na say de virus fit spread for schools.
For Bamenda, Vivian, teacher for government primary school Santa tell BBC News Pidgin say deh no even komot for house as na ghost town.
“Na only tomorrow we go try go school, today so we for fear say separatist fighters fit kidnap or kill we and deh di stop pipo for go school”.
For Buea, for Goment Bilingual Grammar School, only seven pikin dem go school even as taxi di move for town and business pipo open dia shops, Mesumbe, teacher, tok.
Since weh Anglophone crisis start for 2016, some schools dem nova open for more dan three years even before de Coronavirus sick enta kontri.
But na different story for Yaoundé for public schools, examination classes go school and teaching even start for teach.
Principal for GBHS Etoug-Ebe, Ngomba Briget Namondo show BBC News Pidgin taps for different part for school for wash hand, how dey di respect social distance for classroom, only 24 students for one class.
De only challenge bi na say some pikin dem weh deh no suppose go school today bi also dey and school administration tell dem for go back for school.
Oda private schools for Yaoundé no get taps, but deh get buckets and wata wit soap for wash hand and any man di kam wit e mask from house.
Churches, Mosques, Curfew, Flights fit re-open? See di new goment guidelines on lockdown easing
Rwanda don do about turn on easing of lockdown
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Okada riders for Rwanda suppose enta back roads todayy
Rwanda don change dia plans to comot coronavirus restrictions today afta den record dia first death from di virus and new cases start to rise.
Di kontri suppose drop restrictions of travel within provinces and movement for di capital of Kigali as well as okada wey suppose enta back roads today.
But di prime minister office announce say dem go look di mata again tomorrow.
According to di health minister, di decision come on top 11 new cases and di death of a 65 year old lorry driver wey become sick for Tanzania.