Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Breaking, Lagos don give green light for churches, mosques to resume but wit conditions

  2. Nigeria airports dey prepare to reopen, but e no go be business as usual

  3. Senegal police arrest pipo wey dey protest against curfew

    Senegal police don detain more dan 200 pipo afta pipo suddenly enta road dey do I-go-gree waka for different parts of di kontri.

    Di protesters want make goment make end di curfew wey dem put since 23 of March to fight di pandemic.

    Di demonstration wey bin start from di religious city of Touba on Tuesday, spread enta oda cities by Wednesday.

    Police tell BBC say dem dey question more dan 200 pipo and dem also confam say di protesters damage police motor.

    Early dis week, di kontri decide to postpone di partial reopening of schools wey dem bin plan for June 2, afta dem confirm say some teachers for di southern part of di kontri get Covid-19

  4. Iran report record number of new cases

    Authorities don confam anoda 3,574 cases of coronavirus for Iran over di last 24 hours, di health ministry don announce - di highest daily figure since di outbreak begin for February.

    Dis na also di fourth day running wey di number of new cases don higher dan 3,000.

    Previously, di highest daily number of new cases be 3,186 - wey dem record on 30 March, at di height of di kontri initial outbreak.

    Health Ministry Spokesman Kianush Jahanpur also tok for live phone interview with news channel IRINN say 59 pipo don die for di last day, and say di total death toll now stand for 8,071.

  5. Symptoms to look out for if na coronavirus or na cold dey do you

  6. Updates from around di world

    In case you just dey join us, dis na di latest from around di world.

    • Mexico report more dan 1,000 daily deaths for di first time
    • Brazil set new record of 1,349 daily deaths
    • For UK, Business Secretary Alok Sharma dey self-isolating
    • Prince Charles say he "get away lightly" wen dem diagnosed am for March
    • Austria dey reopen almost all dia borders on Thursday
    • Globally 6.4m infections naim dey around di world since di outbreak begin, and 383,000 deaths
  7. Religious and social centres for Lagos go need to register

    Lagos state goment don begin to register religious and social centres for di state as part of dia preparations for dem to reopen.

    Govnor Babajide Sanwo-Olu, bin order all religious and business centres for di state to first register wit di Lagos state safety commission before dem reopen for business.

    Dis instruction na part of di goment Register to Open initiative.

    Di registration dey compulsary for everi house of worship, weda church or mosque, social club, event centres, restaurants, bars, night club, spas, cinemas and gyms.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  8. George Floyd bin get coronavirus

    Di African American George Floyd, wey im death for police custody cause ogbonge protests across America, bin test positive for di virus weeks before im death.

    One 20-page autopsy report wey Hennepin County Medical Examiner Office release show saye he get di virus on 3 April.

    However, because di virus genetic code fit remain for pesin body for weeks, e dey likely say e bin no dey show symptom as at di time of im death but show according to di medical report.

    Dr Michael Baden, former New York City medical examiner wey be one of two doctors wey conduct private autopsy for Floyd, tell di New York Times say county officials bin no inform am say Floyd bin test positive for Covid-19.

    "If you do di autopsy and e dey positive for di coronavirus, e dey usual to tell everyone wey go dey in touch with di body. Dem go ned to dey more care," he tok.

  9. Una good morning

    Good morning.

    Welcome to our live page coverage of di latest tori on coronavirus for Africa and across di world.

    check out we today proverb from Peter Ugwu.

    No forget to like and follow us for:

    • Twitter
    • Facebook
    • Instagram
    Proverb of di day

    Wia dis foto come from, Pixaday

  10. Cyril Ramaphosa, Trump dey among 10 world leaders wey break coronavirus rules

  11. See di Nigerian airports wey don get green light to fly passengers on June 21

  12. Five tins you fit do to ginger yourself for house if di coronavirus palava still hold you down

  13. " Na rain water me and my pikin dem dey drink now"

  14. Barcelona dey carry coronavirus partients go beach as part of treatment

    Hospital del Mar medical staff and coronavirus patient.

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Hospital del Mar medical staff and coronavirus patient.

    For Barcelona, Spain, dem don start to dey carry coronavirus patients dem go beach as part of dia treatment.

    Doctors dem from di Hospital del Mar dey carry patients go beach so pipo go sabi say na human beings dey suffer dis virus.

    Dis dey come as di Spanish goment dey slowly ease lockdown even as dem be one of di kontris wey di pandemic sama pass with 239,932 confam cases and 27,127 deaths.

    Di lockdowns na one of di strictest for world wey refuse for pipo to no comot for exercise and tok say make children no comot house for any reason.

  15. More than 800 health workers for Nigeria don catch coronavirus

    coronavirus

    Wia dis foto come from, AFP

    More than 800 health workers for Nigeria don catch coronavirus, according to di kontri Centre for Disease Control.

    Dat na significant number of di total number of 10,800 confirmed cases for di kontri.

    Tori be say medical officers dey complain about lack of protective equipment. Some unions don threaten to go on strike over di issue.

    Authorities for Nigeria say dem get enough supplies wey dem don already distribute.

    Private hospitals no dey allowed to treat Covid-19 patients as goment say dia staff no dey properly trained. Dem don do u-turn on dat dia decision.

    More dan 300 pipo don die from di virus for Nigeria.

  16. Covid -19 Response Team threaten to stop work over non payment of salary

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, BBC Pidgin, Abuja
    One Covid-19 response team member back camera

    Members of Abuja Covid-19 response team don cry out say di FCT minister neva pay dem for two months despite say dem dey work like jaki.

    Some of di team members wey gada for dia area 3 office, say since dem start work three months ago, na only one month salary dem don receive.

    But di director of public health for FCT, tell BBC Pidgin say dia case na small tin and dem dey try solve.

    E tell our reporter say e get important meeting as plenty ogbonge issue dey ground.

    Some members of di Covid-19 response team wey no want make we call dia name say for dem to come work without moni everyday dey challenging.

    Even to get transport fare daily to come to work da yaws.

    Di team wey comprise of sample collectors, case investigators and drivers di suffer the same fate and dat a few of dia members don even catch di virus.

    NCDC oga, Chikwe Ihekweazu say 821 health workers for Nigeria don catch di virus because of dia exposure to covid 19 patients everyday.

    BBC pidgin learn say di leadership of di Federal Capital Territory to promise dem say dem go pay dem, but e no clear wen dem go get dia pay, sake of dis, dem di beg goment to do something about dia pay to ensure say dem put dia mind for dia work.

    Meanwhile those for contact tracing, say dem no get both call and transport allowance and dat na dia moni dem dey since.

  17. Sabi pipo dey test Ibuprofen as treatment

    Pesin hold drugs for hand

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Scientists dey run one trial to see if ibuprofen fit help hospital patients wey dey sick with coronavirus.

    Di team from London Guy and St Thomas hospital and King College believe say di drug, wey be anti-inflammatory as well as painkiller, fit treat breathing difficulties.

    Dem dey hope say di low-cost treatment fit keep patients from di ventilators.

    For di trial wey dem call call Liberate, half of di patients go receive ibuprofen in addition to usual care.

    Di trial go use special formulation of ibuprofen rather dan di regular tablets wey pipo go usually buy. Some pipo already dey take di lipid capsule form of di drug for conditions like arthritis.

    Studies with animals suggest say e fit treat acute respiratory distress syndrome - one of di complications of strong coronavirus.

    Prof Mitul Mehta, one of di team for King's College London, say: "We need to do trial to show say di evidence actually match wetin we expect to happen."

    In di early days of di pandemic some concerns bin dey say ibuprofen fit dey bad for pipo to take, in case dem get di virus with small symptoms.

    But one review by Commission on Human Medicines quickly conclude say, like paracetamol, e dey safe to take for coronavirus symptoms. Both fit bring temperature come down and help with flu-like symptoms.

  18. Una welcome!

    Good morning.

    Welcome to our live page coverage of di latest tori on coronavirus for Africa and across di world.

    check out we today proverb from Peter Ugwu.

    No forget to like and follow us for:

    • Twitter
    • Facebook
    • Instagram
    POTD

    Wia dis foto come from, Other

  19. Una Goodnight!

    Dis na wia we go march break ontop our live coverage today.

    No forget to join us tomorrow again.

    You fit scroll down for Tuesday tori dem. But make we leave you with dis video from NCDC on how coronavirus take start.

    Remember, make you dey wash your hands. Covid-19 dey real.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  20. Coronavirus: Water companies warn Britain pipo to manage water

    Water pipe

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Water companies for UK dey tell pipo make dem avoid to dey use horsepipes to fill pools during lockdown.

    Di kontri dey suffer dry weather for sometime now and suppliers dey tekk pipo to use water carefully to help to prevent shortage.

    Water UK, wey represent water companies, say dem notice big increase for of demand" - up 25% for some areas - as pipo dey spend more time for house.

    Long-term weather forecasts dey suggest say more dry summer months dey come.