Cameroon health minister, Manaouda Malachie don tok say from
de calculations from sabi pipo, dis moon end to July go bi de worse taim, peak for coronavirus infection .
Cameroon na de kontri wit highest cases for Central Africa
wit 8312 cases, 4794 pip recover, 208 don die.
For June 8, out of 1627 test, 252 bi positive, 46 recover
and two pipo die.
For enta dis kana wowo period mean say plenti pipo go fit
die for one day, plenti cases for one day, space no go bi for hospital and oda
tins for dis taim.
For make sure say pipo no di die laik for oda kontris abroad
Italy, America, goment di take some actions.
-
Five private clinics don join for test pipo fast, two for Yaoundé
and three for Douala, before na only public hospitals di do test.
-
More labs too di test, CPC Yaoundé, Chantal Biya research
centre, Central hospital, CRESA for Yaounde and for Douala, Laquintini, Garoua,
Bamenda and Bertoua.
-
Goment open plenti centres for collect samples for de whole
kontri. For Yaoundé na about ten centres go test now, CSi Simbock, Omisport,
CMA Oyomabang, CMA Ahaha, CSI Ekounou, Warda sport complex and specialised
centre for police and army health units.
More dan half for coronavirus cases dey na for Yaoundé.
Cameroon di test about 800 pipo for one day now and kontri
don 30,000 pipo, since weh kontri confirm de first case for March 6.
“We target na for hit 50,000 tests for June 15”. Manaouda
Malachie tok.
For reach dia target, health boss say deh don buy 100,000
quick test for add to de 45,000 weh deh don first buy’am.