Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Leicester City oga Brendan Rodgers bin get coronavirus

    Leicester manager Brendan Rodgers liken im battle with coronavirus to climbing Mount Kilimanjaro

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Leicester City manager Brendan Rodgers tok say "im don well" afta he catch di coronavirus for March.

    Rodgers na di second Premier League manager to confam say im get Covid-19, as Arsenal oga Mikel Arteta test positive for March

    Di 47-year-old say im suffer with "breathlessness" before im fully recover from di virus.

    "I no fit waka well," he tell BBC Radio Leicester.

    "We get one week off wen we were suppose to play Watford [14 March] and den di week after dat, I start to struggle.

    "For three weeks I no get smell or taste. I no get strength, and one week after, my wife na di same. Dem test both of us and detect say we get di virus.”

    Brendan say di sickness don make am really appreciate being fit and healthy.

  2. Coronavirus: SA politician Malema warn say make churches no reopen

    Di opposition figure  for South Africa say make religious leaders no reopen churches

    Wia dis foto come from, AFP

    South Africa opposition politician Julius Malema don tell pipo to stay for house and not fall for trap of going to church sake of say dem go die if dem catch coronavirus.

    Place of worship go reopen starting from 1 June after President Cyril Ramaphosa announce say im go ease lockdown restrictions to level three - but na only 50 or less pipo go fit dey inside at any time.

    On Thursday, oga Malema say di reopening of churches go expose worshippers to infections and beg religious leaders to keep them close if dey care about dia pipo.

    He give warning to di members of im Economic Freedom Fighters party make dem no attend worship. He say, "na set-up".

    He say restaurants get better hygiene practices but dey remain close and so worship places no need reopen.

  3. Austria reopen hotels as dem ease lockdown

    Austria reopen cafes and restaurants earlier dis month

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Hotels don begin reopen for Austria today as di kontri continue to dey ease restrictions.

    For now, na only di citizens of di kontri fit go resturants and hotel but later, wen tourist don begin to travel enter di kontry, dem go fit enter.

    Plan also dey to test plenty hotel staff to try reassure tourists, and commot fear of coronavirus.

    Di kontri hope say dem go test 65,000 hotel workers for one week by di beginning of July and na goment go pay.

    Theatres and concert halls sef don dey reopen, but audiences dey limited to 100 pipo and strict social distancing rules dey.

  4. 5 tins wey go change when Premier League resume for June 17

  5. Nigeria deny claim say Oga Trump don send ventilators

    Information minister for Nigeria, Lai Mohammed, don deny claim of America President Donald Trump say im send 1000 ventilator to di kontri.

    Oga Trump promise say im go send ventilators wen im be follow Nigeria President, Muhammadu Buhari tok on 28 April.

    Oga Lai say do kontri neva receive ventilators promised by di US President in April.

    He say if Nigeria receive di ventilators, di goment go tok am for public.

    Oga Trump tok again for last week. Wen im dey tour Ford motor plant for Mitchigan, say im don sent 1,000 ventilator go Nigeria.

    Nigeria don record 8,915 cases of coronavirus and 259 don die.

  6. Nigeria record 182 new cases of Covid-19

    Lagos na im still get di highest number of Covid-19 cases for di latest report wey di Nigeria Centre for Disease control bin release for Thursday night.

    Out of di 182 new cases, Lagos record 111 confam patients.

    So far 2592 patients don dey discharged.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  7. Una Good morning!

    Thank God is Friday! Yes o. We go begin our coverage wit dis better proverb.

    How una see am. Oya go drop your own for we comment section on our Facebook, Twitter and Instagram page @BBCNewsPidgin. Make you also follow us and continue di conversation.

    POTD
  8. Una goodnight!

    Na here we go march break ontop our live coverage ontop coronavirus and how e dey affect di world.

    Abeg join us again tomorrow for more tori.

    No forget to scroll down for Thursday tori dem.

    Goodnight!

  9. Coronavirus deaths for US top 100,000

    America don pass 100,000 deaths for di coronavirus outbreak in less dan four months.

    Di kontri don record more deaths dan any oda kontri, while dem get 1.69 million confirmed infections wey be about 30% of di total for di whole worldl.

    On Thursday, one day afta dem reach di figure, President Donald Trump tweet say na "sad milestone".

    Di president also express im "sympathy and love" for di families and friends of those wey don die from Covid-19.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  10. France wan reopen bar and restaurants

    Restaurant for Paris

    Wia dis foto come from, AFP

    France go allow restaurants, bars and beaches to reopen from June 2.

    Prime Minister Edouard Phillippe say di only clause be say, dem must observe minimum of one meter distance between tables.

    Dis na as dem tok say dem go still dey chook eye well-well for Paris even though dem no be virus hotspot.

    However dem dey still keep di public gathering rule of only ten pipo.

    E don pass 28,000 pipo wey don die of coronavirus for France.

    But on Wednesday, authorities confam say, di number of pipo wey die no reach one hundred for di seventh day in a row.

    France go also reopen dia borders to oda European kontries for 15 June.

  11. See di rules wey Nigeria civil aviation set for international flights to happun

  12. Call to increase fight against coronavirus for Africa

    Apply hand sanitizer

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Head of Africa Centres for Disease Control and Prevention dey ask for more effort for di fight against coronavirus as evidence show say di disease dey spread more for community dem for kontries across di continent.

    John Nkengasong say dis na time to test pipo with flu-like symptoms and to increase measures like social distancing, wearing of masks and hand washing.

    So far, di virus dey multiply slowly for Africa pass Asia or Europe.

    Sabi pipo believe say dis fit be because of Africa young population.

    But to make predictions for di continent dey difficult wia dem get around 120,000 cases, from a population of more than one billion.

  13. Madagascar tok say plans no dey for anti-coronavirus injections

    Artemisia as tea

    Wia dis foto come from, Getty Images/Andry Rajoelina

    Wetin we call dis foto, E don pass nine kontris for Africa wey don buy dis cure

    Madagascar Presido Andry Rajoelina fit don do about turn on top di coronavirus cure im say im kontri make.

    Na last moth di presido launch di local tea wey im sa fit to prevent and cure coronavirus.

    But since then, World Health Organization don chook mouth for di mata say scientific proof no dey.

    Also di Madagascar National Medical Academy also tok say di drink wey dem make from artemisia fit damage pipo health.

    Even as dat one dey happun, Oga Rajoelina comot on Tuesday to tok say Madagascar wan launch injections of artemisia and say clinical trials don start.

    But Michelle Sahondrarimalala wey be medical doctor and director of di Madagascar’s judicial studies department tok say tori pipo dem no really understand oga presido announcement.

    She say no pesin dey think to put artemisia for injection and say e no be mata wey scientific community dey consider.

  14. Breaking, Premier League football go return for June 17

    Mohammed Salah

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Premier League football go return back on June 17, according to informate wey BBC don get.

    Di first games na Aston Villa v Sheffield Utd and Manchester City v Arsenal- dia game wey dem postpone.

    Di full fixture list dem go play am for di weekend of June 19. Clubs still dey discuss di idea for meeting now, but tori be say all di clubs dey in agreement for now.

    Na since March 13 dem suspend di Premier League because of coronavirus.

    100 days don pass since Leicester City 4-0 win over Aston Villa on March 9, di league go resume with games now without football fans.

    Goment neva release safety guidelines yet and di decision go dey subject to di fight against coronavirus pandemic.

    On Wednesday all di clubs vote to resume full training, afta dem start to train individually last week.

    So far 12 pipo don test positive for coronavirus afta dem do 2,752 tests across di league.

    Tori be say dem go test Premier League players and staff two times a week, di capacity go increase from 50 to 60 tests per club for di fourth round of testing.

    Any player or staff wey test positive must self-isolate for a period of seven days.

    Plans for di third phase of Project Restart go include step towards normal training and build-up to competitive games.

    Liverpool currently dey 25 points clear ontop di table while Bournemouth, Aston Villa and Norwich City dey relegation position.

    Di Reds, dey chase dia first league title for 30 years, and dem fit win di title if dem win for dia first game back and second-place Manchester City lose to Arsenal.

  15. See Nigerian private universities wey don ready to resume

  16. 'We no dey aware of any Covid-19 case for Kogi State'

  17. Hundreds of pipo escape from Malawi quarantine centre

    About 400 pipo don escape from one coronavirus quarantine centre for Malawi second biggest city, Blantyre, afta dem complain say di facilities dey bad.

    Local media report say those wey escape bin dey quarantined afta dem land from South Africa but dem never test dem for coronavirus.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Dem complain say di stadium, wey goment turn to quarantine centre, no get water, toilet and food to chop.

    Di goment never tok pim ontop di mata.

    Malawi so far don record 101 coronavirus cases including four deaths.

  18. President para as im son snub COVID-19 curfew, attend night party for town

      • Author, Ogechi Obidiebube
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    Kenya Presido Uhuru Kenyatta don tell pipo say im son bin disobey night to morning curfew - wey goment order to prevent di spread of coronavirus.

    Oga Kenyatta say one of im two sons, wey im no gree mention name, bin go out for night party for Mombasa - di headquarters of infections for di COVID-19 inside di kontri.

    E dey ban for pipo to do party of any kind for di East African kontri.

    Di goment also restrict movement in and out of di capital, Nairobi and three oda coastal counties including Mombasa.

    Di presido tok for interview say nobodi dey above di coronavirus preventive measures, although pipo don yab am say im no carry im son go quarantine centre like oda Kenyans wey don break di curfew.

    Oga Kenyatta say im para for im son no be small sake of how im risk im grandmama life Ngina Kenyatta wey dey stay wit dem.

    Uhuru Kenyatta

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Di president family currently dey Mombasa
  19. See how Nigeria goment dey plan to reopen schools

  20. Una goodnight!

    Na here we go march break ontop our live coverage of di coronavirus and how e dey affect di world.

    Abeg join us again tomorrow for more live updates.

    No forget to scroll down for Wednesday tori dem.

    Goodnight!