Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. No Covid-19 deaths in London for over 24 hours

    London hospitals no record any death among those wey don test positive for coronavirus over 24 hours.

    Across UK, na 55 pipo don die afta dem testing positive for coronavirus, during di same period.

    Dat na di lowest number since before dem announce lockdown on 23 March.

  2. Students dey return to university for Wuhan China

    Inspectors dey disinfect one student schoolbag and suitcase inside Wuhan, China

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Chinese students dey return for di first time today to universities for di city of Wuhan, wia di coronavirus outbreak began.

    Since early May, di local goment don dey phase di return of students to academic institutions. Today, final year and postgraduate students wey specialise in scientific research dey able to return, state media tok.

    Di official People Daily newspaper dey share pictures of students weu dey return to universities with dia suitcases and masks. Dem don ask dem to show at particular times to maintain social distancing, and dem dey check dia temperature wen dem land.

    Na more dan 50,000 confirmed cases of Covid-19 dem get for Wuhan, and pipo fro di city spend 76 days for inside ogbonge lockdown. On Friday, authorities confirm say di city dey free of all cases of di virus wey get symptoms, but roughly 200 people wey no dey show symptoms still dey under medical observation.

  3. School resumption in Nigeria - See wetin go happun next

  4. How dis Nigerian Govnor of Abia State catch coronavirus

      • Author, Princess Igho Williams
      • Role, BBC Pidgin
    Governor Okezie Ikpeazu

    Wia dis foto come from, Abia state Government

    Govnor Okezie Ikpeazu don test positive for coronavirus making him di fourth governor to test positive for di virus.

    Govnor Ikpeazu of Abia State, south east Nigeria, na di number four govnor inside di kontri to catch di COVID-19 disease.

    Onyebuchi Ememanka, di govnor Im tok-tok pesin, na im confam dis tori give BBC.

    Di Commissioner for Information inside di state, John Okiyi Kalu, tok for one statement say di govnor don go isolation before dem confam im result positive.

    And im don order di deputy governor, to act on im behalf until di time e resume dut, di Commissioner add.

    On Saturday, 30th May, 2020, di Govnor bin volunteer im sample for COVID-19 test and direct members of di state Executive Council (EXCO) and those of di inter ministerial committee on COVID-19 to submit demsef for di same test.

    On Tuesday, 2nd June, 2020 di result of Govrnor Ikpeazu test return back negative.

    Then on Thursday, 4th June, 2020, di Governor submit anoda sample for di Nigeria Center For Disease Control (NCDC) lab for confirmation and di result return back positive.

  5. Good Morning!, Una welcome to today live tori dem as e concern coronavirus.

    We begin wit Nigeria wia di West African kontri record 260 fresh new cases of coronavirus for di kontri.

    According to Nigeria centre for disease control dis fresh 260 cases na from 19 states for di kontri, of which Abia get 67 inside. Dis don bring di total number for di kontri to 12,486.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  6. Na here we go march break!

    But before we go, check out some of di tori wey we tell you again.

    • Black Lives Matter demonstrations continue around di world despite health warnings against mass gatherings, protesters for Bristol pull down di statue of one slave trader also.
    • Di number of pipo wey don die from coronavirus for around di world don pass 400,000
    • For Brazil, gomet remove months of Covid-19 data from dia website as pipo begin dey criticise di way President Jair Bolsonaro handle di pandemic.
    • Di Vatican announce say no more cases of coronavirus among di Holy See employees and odas for di Vatican City.
    • Confirmed Covid-19 case count for Ghana hit 9,462
    • And Nigeria coronavirus cases climb to 12233

    Thank you for joining us and good night!

  7. Premier League clubs dey ready to return

    Bruno Fernandes of Manchester United in action

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Premier League clubs don dey hold inter-squad friendlies as dem continue dia preparation for di league to restart dis month.

    Di English top-flight don dey suspended since 1 March but go return on 17 June with action-packed schedule.

    To prepare, clubs don dey play matches among themselves or against lower-league opposition for di aempty stadiums recently.

  8. Italy case continue to dey fall but Russia own dey rise

    Man wey dey sell fruits

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Many businesses don start to dey reopen for Italy afta more dan two months of nationwide lockdown.

    Italy don report 53 new coronavirus deaths - down from 72 dem report di day before - and just 197 new cases.

    Di kontri total death toll since di outbreak wey start for February now stand at 33,899, di fourth highest for di

    world afta di United States, UK and Brazil.

    Tins also continue to dey improve for Canada, wey report 70 new deaths with di virus. Dat na overall increase of 0.9% - from 7,703 to 7,773. Canada also report 722 new cases on Saturday.

    Russia, for dia own part, record almost 9,000 new coronavirus cases for di last 24 hours. Dem also report

    134 new deaths, e make di overall total 5,859.

  9. Sell of alcohol for South Africa dey add to hospitals headache

    Man dey inside shop wey dem dey sell alcohol

    Wia dis foto come from, Reuters

    South Africa decision last week to lift di ban on alcohol wey dem impose to stop di spread of coronavirus - ddon lead to sharp rise in trauma admissions for hospitals, according to report.

    One specialist for one hospital for Durban tell South Africa Sunday Times newspaper say dem don record many many more stabbings, accidents and assaults,wey he say dey linked to di resumption of alcohol sales.

    Another member of staff, Prof Elmin Steyn, tell newspaper say patients wey dey await surgery dey need to to go intensive care units (ICU).

    "Di problem na say di ICU beds dey filled up with seriously sick Covid-19 patients," Prof Elmin Steyn tok.

    Hospitals too don see increase in car accident victims according to reports.

    During di first two months of di lockdown, wen dem ban di sell of alcohol, some hospitals report 70% reduction in trauma admissions.

  10. Small businesses for Algeria don reopen

    Algeria don allow some business to reopen today as part of di kontri plan to end di coronavirus lockdown.

    Vegetable and fruit markets, shops wey dey sell snacks and barbing saloons don resume business.

    Di second stage of di lockdown relaxation go start for June 14 wen dem go allow more businesses to resume.

    Algeria don get 698 deaths and 10,050 cases of coronavirus according to John Hopkins University.

    Man inside restaurant

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Restaurants still dey closed for Algeria but dem dey expected to reopen on June 14
  11. Wetin dey happun around di world?

    Pesin wey wear PPE dey street

    Wia dis foto come from, Getty Images

    See di latest headlines from around di world as di coronavirus death toll continue to dey rise, and while protests dey happun for US and many oda kontries against racism and police brutality.

    • Di number of confam pipo wey don die with coronavirus don pass 400,000, according to di latest from Johns Hopkins University.
    • Brazil don remove months of data ontop Covid-19 from one goment website sake of tok-tok about di way President Jair Bolsonaro dey handle di outbreak. Di kontri don record more dan 35,000 coronavirus-related deaths.
    • Big rallies don happun across US and don continue on Sunday for Rome and Copenhagen against racism and police brutality. Di death of George Floyd na im ginger di protests
    • Di Vatican don announce say dem no longer get any cases of coronavirus among Holy See employees - di governing body of di Catholic Church - and odas inside Vatican City.
    • Di pandemic na "devastating blow"for di world economy, according to World Bank President David Malpass.
  12. Saudi Arabia cases top 100,000

    Di number of coronavirus cases for Saudi Arabia don pass 100,000, according to official figures.

    Di ministry of health report 3,045 new cases on Sunday, dis wan take di total number of cases for di kontri to 101,914.

    Di number of new daily cases pass 3,000 for di first time on Saturday.

    Di official number of deaths from di virus na 712, according to di Sunday figures. Di figures dey clear from di ministry Twitter feed, wey get di details for English as well as Arabic.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  13. Abuja residents hold 'unusual worship' as churches begin open for Nigeria

  14. Confirmed Covid-19 case count for Ghana hit 9,462

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin
    Ghana Ministry of Information

    Wia dis foto come from, Ghana Ministry of Information

    Confirmed Covid-19 case count for Ghana hit 9,462 according to Ghana Health Service (GHS).

    Dis be after officials record some 294 new cases across de country.

    GHS in dema latest update reveal say some 90 people also recover from de virus, dis dey peg total recoveries at 3,547.

    Death toll however rise catch 44 after two people unfortunately die of de disease.

    Both of de deceased be females, aged 62 and 63 from de Ashanti Region.

    Regional Breakdown

    Greater Accra Region – 6,282Ashanti Region – 1,645Western Region – 580Central Region – 478Eastern Region – 163Volta Region – 102Western North Region – 74Upper East Region – 42Northern Region – 37Oti Region – 26Upper West Region – 22Bono East Region – 7North East Region – 2Savannah Region – 1Bono Region – 1Ahafo Region – 0

  15. Brazil stop di publishing of key COVID-19 informate for dia goment website, Plus oda updates

    Brazil don already record more than 35,000 coronavirus-related deaths

    Wia dis foto come from, Reuters

    • Goment for Brazil don comot di number of coronavirus cases for di kontri website

    Na sake of criticism ontop di president head on how im dey handle di virus. Di health ministry for di kontri say dem no go dey give total number of cases for di kontri again. Dem go only dey report number evriday. Brazil don already record more than 35,000 coronavirus-related deaths. And di south American kontri na one of di places wey don suffer di hardest blow from Covid-19 pandemic.

    • Anoda 389 coronavirus cases don comot for Nigeria in di last 24 hours, according to di kontri centre for disease control.

    Di state with highest numbers na Lagos and Abuja. Tori be say in 100 days, Nigeria record over 12000 cases of coronavirus infection.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    • All di latest 1195 coronavirus test weyPremier Leaguedo no get positive any case.

    Di league bin dey test players and staff as e dey prepare to resume football matches on 17 June

  16. Una Good Morning!, We still dey torchlight di coronavirus tori around di world.

    First we begin wit today Pidgin Proverb; "Grass wey dey middle of road no dey live long"

    D'Boss Ating say make we reason dis Pidgin Proverb today wey be Sunday.

    Pidgin

    Wia dis foto come from, Other

  17. Kenya extend nationwide curfew, plus oda lockdown updates

    • Kenyan President Uhuru Kenyatta don extend di nationwide morning to night curfew and oda restrictions for di kontri.

    Dis dey come as di kontri continue to dey battle wit di rise in covid-19 cases.

    • Duke of Cambridge Prince William don tell world pipo say im be secret volunteer for one crisis helpline.

    Di prince say im don dey answer text messages from pipo wey get mental health challenge during dis lockdown.

    • “We no fit enta Manhattan, we go sleep for airport hotel, na only one pesin we fit carry enta club”

    Na tennis champion Novak Djokovic dey complain say di coronavirus safety protocols wey dem put for di US Open to start, dey extreme.

  18. Why African Development Bank approve 111. 7 billion loan to Nigeria - See wia di money go enta

  19. Protest across Australia, 50 cases of gender-based violence for Edo plus oda latest tori dem

    Protest across Australia

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Protest across Australia
    • Plenti pipo don dey protest across Australia to show support for di Black Lives Matter movement.

    Although na di death of di African American George Floyd start di march, protesters dey also use am torchlight di anyhow treatment wey Aboriginal pipo for di kontri dey face.

    • Sudan don report 151 fresh cases of coronavirus in di last 24 hours.

    Dis one go make di total number of infections 5,865 inside di kontri.

    But good news be say 1924 pipo don recover so far.

    • Authorities for Edo state south-south Nigeria don tok say dem record more than 50 cases of gender-based violence during di coronavirus lockdown for di state.

    Di ministry of Social Development and Gender Issues say almost 20 of di cases wey happen between April and May, na rape, incest and defilement.

    • Some scientists for UK dey warn say dis coronavirus outbreak no go be di last pandemic wey humans beings go face.

    Di scientists say we don open door for diseases from wild animals to dey transfer to human beings and spread fast.

  20. Updates from Africa...

    As of June 6, 2020, na 176 confam cases of coronavirus dey Africa.

    Di highest number of cases dey northern Africa with over 51,000 cases.

    Southern African and West Africa follow for back while Central Africa get di lowest number inside di continent.

    4,902 pipo don die and 78,267 pipo don recover.