Children fit spread coronavirus if schools reopen?
All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.
Live Coverage
Daniel Semeniworima
Kano state don get first case of covid 19
Wetin we call dis foto, Covid 19 taskforce meeting for Kano
Kano state for northwest Nigeria don record dia first case of covid 19 according to special adviser to di govnor, Salihu Tanko Yakassai.
Wia dis foto come from, Kano state government
Wetin we call dis foto, Kano index case
Di adviser wey use Twitter to release di informate add say di medical team don rush di pesin to isolation centre for Kwanar Dawaki town and dem don also test im family members.
Kano don become di 19th state for Nigeria wey record covid 19 case after Niger and Anambra state announce case on Friday.
Lagos discharge four new patients of COVID-19 plus 11-year-old boy
Lagos goment don discharge anoda four new COVID-19 patients, wey test negative to di virus afta dia treatment for isolation centre.
Governor Babajide Sanwo-Olu na im confam dis for im Twitter pageon Saturday.
Di governor tok say four male patients, plus including one 11-year-old boy, na di pipo dey discharge to reunite wit dia family.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
As e be, 50 pipo don dey discharged for Lagos State isolation centre.
But di governor beg Lagosians make dem stay for house and do social distancing.
“I dey beg residents to stay for house, practice #SocialDistancing and observe personal and hand hygiene. We dey steady course to victory, make we all add little sacrifice for di greater good,” he tok.
Covid-19 Explainer: How Coronavirus dey test faith and religion for Africa
All over di world, streets dey empty, businesses dey
collapse, recession dey according to di IMF because of di coronavirus pandemic.
Creating awareness using religious teachings
Di power wey religious institutions across di continent get
don make dem di best platforms to follow pipo tok as goment dey try stop make
di virus for no spread.
Ethiopia state TV dey
host programmes by religious groups to raise awareness on di pandemic.
Winners’ Chapel International bin donate ambulances, test
kits, personal protective device (PPE) to Lagos and Ogun State goments to help
dem fight di pandemic for Nigeria.
Traditional healers for Zimbabwe dey part of how goment plan
to handle di pandemic.
Di archbishop of Tanzania's Catholic Archdiocese of Arusha,
Isaac Amani, tell members make dem no laff di disease for social media “Some
pipo dey write for social networks say coronavirus no dey catch black persin,
say Africans dey immune. That one na lie. Di truth be say di viruses dey affect
human beings, and Africans na human beings dem be,” he tok.
No movement for two weeks as Anambra get index case of Covid-19
Governor for Anambra State, Southeast Nigeria don declare
two weeks total lockdownas di State
recorddia first case ofCovid-19.
Wia dis foto come from, Anambra State Government House Press
Wetin we call dis foto, Governor Willie Obiano
Governor Willie Obiano give di announcement for special State broadcast, say di patient come from Lagos and im don begin treatment for one of dia Protective Care Centers and dem don begin serious contact tracing to bring every pesin im get contact with to get professional handling.
Di Governor thank all di traders for di 63 markets wey dey di state for dia cooperation as dem close down di markets come add say dem go add oda tight measures to prevent further spread wey include extension of restriction for movemt for two weeks with comprehensive lockdown for di State. Only pipo wey dey essential service go waka.
All di boundaries for di State go remain closed and only vehicles wey dey bring essential things fit pass after dem don do thorough checks.
Di Governor advise evribodi to stay inside dia house but if pipo must comot for any reason, dem must wear face mask and maintain 6 feet social distancing.
Wia dis foto come from, Anambra State Government House Press
Wetin we call dis foto, Emergency numbers
Governor Obiano come tell Anambra pipo say make dem no panic,as adequate preparations dey ground to tackle di disease, come advise dem to call di state emergency numbersin case dem no feel well.
Im also thank pipo wey don contribute for di coronavirus intervention for di State.
Ghana COVID-19 case jump catch 408, Health Officials say dem test 27,346 people for Ghana out of which 408 test positive
Coronavirus cases for Ghana jump catch 408 today after de
country record 30 news infections.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
According to Ghana Health Service out of de 408 cases, dem identify 205 from routine surveillance, 88 from dema enhanced surveillance den 115 from travelers under mandatory quarantine.
Health Officials say so far dem test 27,346 people for Ghana out of which 408 test positive.
So far 4 people recover from de disease, 8 people die, wey 394 people be mild cases who dey collect treatment for house den treatment facilities across de country.
Ghana dey inside week two of lockdown, but Prez Akufo-Addo extend de lockdown by one week starting from Monday, April 13, 2020.
Rivers goment don cancel full Easter Church service permit
Rivers State Goment don cancel di permit dem bin grant Churches to hold Easter service with dia full congregations.
For statement wey Commissioner for Information Paulinus Nsirim sign, di decision dey come after dem don consult with pastors, civil society groups and oda Nigerians so e come direct dem to go back to 50 person's per service to maintain social distancing.
For State broadcast on Thursday 9 April, 2020, Governor Wike bin grant permission to Muslims to get full jumaat service for dia mosques and prayer ground on Friday and for Christians to get full congregation service to mark di Easter celebrations, but many churches like Catholic Diocese of Port Harcourt bin announce say dem go continue with dia arrangements before and no go hold full services.
Many muslim umar also no hold dia regular jumaat prayers on Friday.
Why Nigeria fit consider lockdown extension
In case you just dey join us...
Nigeria don record 305 confam cases of coronavirus.
See some of di oda latest updates from around di world.
For UK, authorities dey tell pipo to stay for house asdem dey expect say temperatures go go up.
UK announce 980 more hospital deaths yesterday, wey bring dia total to almost 9,000.
Spain daily death figures stiil dey drop, e don fall to di lowest level in nearly three weeks.
India go extend dia lockdown according to dia chief minister.
Dem don confam 1.7 million cases and 100,000 deaths around di world according to Johns Hopkins University.
US don become di first kontri to report more dan 2,000 deaths in one single day.
UK PM Boris Johnson don dey "able to do short walks" as part of im recovery.
One pesin don die from complications of Covid-19 for Lagos
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
One person don die from complications of coronavirus for one private hospital for Lagos state.
Di state Commissioner of Health Prof. Akin Abayomi na im confam di tori ontop im twitter page.
Di commissioner add say dem don discharge additional seven Covid-19 patients wey don fully recover afta dem test negative twice.
otal number of Covid-19 patients discharged in Lagos State now na 46.
Lagos get di highest number of covid-19 cases for di kontri with 166 cases.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
India go extend dia lockdown to control di spread of coronavirus,according to Delhi Chief Minister Arvind Kejriwal.
E bin dey on schedule to end on Tuesday.
But Prime Minister Narendra Modi, wey tok to several state ministers earlier today, go extend di national restrictions as di number of cases for di kontri dey rise, Mr Kejriwal tok.
E never dey clear how long di extension go last.
India get 7,600 confam coronavirus case and don see 774 deaths, according to figures wey one US university compile, but di fear na say di virus fit spread widely in di nation of 1.3 billion pipo.
Brazil don report over 1,000 deaths
Wia dis foto come from, Getty Images
Brazil don become di first kontri for di southern hemisphere to surpass 1,000 deaths with coronavirus.
Di South American kontri don record at least 1,068 deaths and 19,789 cases, according to Johns Hopkins University.
Most Brazilian state govnors don impose quarantine measures but President Jair Bolsonaro continue to dey challenge di restrictions.
Health officials say dem no expect say di outbreak go critical for a few weeks yet.
Wetin we know about Osinbajo visit with President Buhari?
Article Information
Author, Fiona Equere
Role, BBC Pidgin
Nigeria Vice President Yemi Osinbajo say goment major concern na to ensure say di economy dey stable and jobs dey protected during dis lockdown period.
Di Vice president do meeting with President Buhari to brief am on di economy situation during di lockdown as di kontri dey fight di coronavirus outbreak.
Osinbajo wey be di head of di high-powered Economic Sustainability Committee tell tori pipo say, President Buhari dey worried about di problems wey fit comot sake of di lockdown.
Osinbajo say dat na some of di issues im discuss with President Buhari.
We get di Economic Sustainability Committee and we go soon submit full report of our ideas to am. Na wetin im add put
Number of pipo wey die for US pass 2,000 in one day
US don become di first kontri for di world to record more dan 2,000 coronavirus deaths in a single day.
Numbers from Johns Hopkins University show say 2,108 pipo die in di past 24 hours while dem don also confam more than half a million infections.
Di US fit soon pass Italy as di kontri with di number of di most coronavirus deaths worldwide.
But experts wey dey di White House Covid-19 task force say di outbreak don start to dey to dey level off across US.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.
End of X post
Nigeria confam 17 new cases of Covid-19 on Friday night to ake di total confam cases for di kontri to be 305.
Di cases wey dem report na eight for Lagos, three for Katsina, two for FCT, one for Niger, one for Kaduna, one for Anambra and for Ondo state.
Dem don discharge 58 with 7 confam deaths
Una good morning!
Welcome to our live coverage of all di tori ontop coronavirus and how e dey affect di world.
For tori from Friday, make una scroll down.
But first, make dis proverb from Ochowechi Yakubu ginger you dis morning.
Wia dis foto come from, Getty Images
Una goodnight!
Na here we go march break ontop our coverage of di
coronavirus palava and how e dey affect di world today.
We go see you tomorrow. Make you no forget to scroll to
see Friday tori.
...And from Nigeria and Africa...
Nigeria Presido,Muhammadu Buhari say im dey sure say Nigeria go win COVID-19 wit all di tins goment don do.
President Muhammadu Buhari say di Vice President, Yemi Osinbajo don brief am on di work wey di Economic Sustainability Committee, to find di best economic response to di COVID- 19 pandemic.
Lagos State don discharge seven new patients from di Infectious disease centre for Yaba.
World Health Organisation confam new case of Ebola for DR Congo
See di latest update from across di world...
Di number of pipo wey don die from Coronavirus now don tanda
for 100, 376 according to John Hopkins University.
Italy na im pipo die plenty, followed by US and Spain.
UK health secretary, Matt Hancock say di number of pipo wey
don die from Coronavirus for UK don reach 8,958.
America Presido, Donald Trump say di kontri don complete two
million coronavirus tests.
Republic of Ireland don record 288 deaths from Coronavirus
and more than 7,000 confamed cases dey di konti.
For Germany and for other parts of Europe, Christians dey
worship through internet as churches dey closed.
Di ban on movement for Ireland don extend go May 5. -World Health Organization say
lifting social distancing restrictions fit make Coronavirus mata dey worse.
Coronavirus fit increase if goments remove lockdown - WHO
World Health Organisation don warn say to begin remove
coronavirus lockdown measures too early fit "make am increase"
infection again.
Wia dis foto come from, Dare Idowu
Wetin we call dis foto, Social distancing
Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus say kontris need to dey careful about easing restrictions, even as some dey struggle with di economic impact.
E say news about di slow spread of di epidemic for some European kontris dey "welcome".
But "sharp increase" for oda kontris including Africa na cause for concern.
1.6 million cases of coronavirus na im dey for di world and 97,000 pipo don die.
Dr Tedros say di WHO dey work with kontris to form strategies to ease restrictions.
"I know say some kontris dey already plan di transition out of stay-at-home restrictions. WHO want see make dem lift restriction as much as anyone," na so im tok for online news conference for Geneva.
"At di same time, lifting restrictions too quickly fit bring back di disease . Di way down fit dey dangerous as di way up if we no manage am properly."
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Health workers
Im tok dey come as di goment for Spain, wey dey part of kontris wey don suffer di most, dey prepare to allow some non-essential workers for sectors including construction and factory production to return to dia jobs on Monday.
Spain record dia lowest daily death toll in 17 days on Friday, with 605 deaths. According to di latest figures, Spain now get 15,843 registered deaths related to di virus.
However, di goment don tell pipo to kontinu to observe social distancing rules as di kontri dey celebrate Easter weekend.
Speaking on Friday, Dr Tedros welcom signs wey show say di spread of di virus dey slowdown for some of di kontris wey di virus affect di most for Europe - namely Spain, Italy, Germany and France.
Di number of pipo wey don die for Italy rise by 570 on Friday, down from daily figure of 610 di day before, and di number of new cases also slow small to 3,951 from 4,204.
But Dr Tedros warn say di virus now dey spread fast for some oda kontris and highlight Africa, wia im tok say di virus don reach villages.
"We now dey see some cases and community spread in more than 16 kontris" on di continent, im tok.
"We anticipate serious hardship for already overstretched health systems, particularly in villages, which normally no get di resources of those in cities."
Covid-19 Explainer: How Coronavirus dey test faith and religion for Africa
Di spread of Covid-19
don scata some religious rituals for Africa where believe for God or gods dey
very important for di life of many pipo.
Di ones wey dey popular na Easter, Ramadhan and Eid, wey be
say their celebration dey make plenty pipo gada.
But as di number of pipo wey catch Coronavirus dey increase,
goments begin close churches, mosques, and other institutions.
Goments also ban large gatherings wey include weddings,
burials, or anytin wey go make many pipo gada togeda.
Initially resistance dey to di directive, but some
institutions later adjust come find other ways to connect to their members, dem
also help to comot fear for their mind. _
Spiritual bonding despite social distancing
Catholic churches for Kenya, Ghana and Rwanda bin do some
changes to some rituals including how members go dey collect Holy Communion and
dem comot holy water from churches.
One Seventh Day
Adventist Church for Kenyan capital, Nairobi, advised members say to come
church no be by force but encourage dem to follow services online.
Di Jamia mosque for
Nairobi bin don stop all congregational prayers even before goment give order
say make religious centres close.
For their daily calls to prayer (adhan), mosques for Kenya
don tell Muslims say make dem pray for house instead of make dem do di normal
gada for prayer.
For neighbouring South Sudan, di Episcopal Church don follow
members tok say make dem pray for house.
Some churches for Nigeria advise their followers say make
dem practise social distancing and use sanitisers as part of di measures to
contain di spread of di virus. “Stay house and join di church service online.