
Wia dis foto come from, Getty Images
Thousands of protesters don enta di streets of central Sydney in solidarity with demonstrations for US over police brutality and di death of African American George Floyd.
A day to di rally, di New South Wales supreme court decide say make e no go ahead because of concerns over di spread of Covid-19.
But court of appeal overturn di decision at di last minute
Authorities dey worried say di mass gatherings fit spoil wetin di kontri don achieve so far in controlling di spread of di virus.
But organisers and supporters, many from di indigenous Australian community, insist say dem go come out. Not just in solidarity with di protesters for America, but also to draw attention to indigenous deaths for police custody for Australia.
Marches don dey happun across Australia, including for Brisbane, Melbourne, Hobart, Adelaide and oda places.







