Activists dey careful on Sudan milirary promise to handover to civilian

Wia dis foto come from, AFP
Pro-democracy protesters for Sudan don react wit caution to di promise by di kontri military leader wey say im go handover to civilian goment.
Activists say General Abdel Fattah al-Burhan don change im mind for dis kain commitments before.
Di general neva give time for wen di transition go happun.
One campaigner tell BBC say im for like make Gen Burhan step down now.
Some dey also call for military leaders to face justice for di killing of more dan 100 protesters since di coup for October.
"No be exactly wetin we want becos wetin we dey actualy ask na for [Gen Burhan] to step down becos afta di protest wey don last for eight months over 100 pipo don die.
“We want make pipo stand trial for wetin happun so we want am to stand trial, not just to give up power."
Na so Hajooj Kuka, wey be feem maker and activist tok.
Di activists say dem expect demonstrations to kontinu until goment meet dia demands.











