Ebola outbreak don officially dey over for DR Congo

Wia dis foto come from, AFP
Di latest Ebola outbreak don dey contained within three months thanks to "swift" and "robust response" for Democratic Republic of Congo, World Health Organization (WHO) tok.
Four pipo don die since dis outbreak - wey be di kontri14th since 1976 - and wey dem declare for April inside di western city of Mbandaka.
Three of those wey die dey considered as "confirmed cases" and one dey considered as "probable" case, di global health body tok.
WHO go continue to monitor di situation in case of any "flare-ups", but for one statement dem praise Congolese authorities. Di UN organisation work together with di goment to roll out vaccinations, testing, contract tracing, infection prevention and control plus community engagement.
"Dis outbreak response show say by bolstering preparedness, disease surveillance and swift detection, we go fit stay one step ahead," WHO Regional Director for Africa Dr Matshidiso Moeti tok for statement on Monday.






