We thank una!
We don come to di end of our live coverage of di Wafcon 2022 match between di Super Falcons of Nigeria and Bayana Bayana of South Africa.
You fit scroll down for di minute by minute breakdown of how di game go.
Nigeria chop defeat for dia opening match against South Africa on Monday.
Jelilat Olawale and Fiona Equere
We don come to di end of our live coverage of di Wafcon 2022 match between di Super Falcons of Nigeria and Bayana Bayana of South Africa.
You fit scroll down for di minute by minute breakdown of how di game go.
South Africa beat Nigeria for dia opening group C match for Wafcon.
Nigeria pull one goal back through Rasheedat Ajibade.
Defending champions Nigeria need to go back to di drawing for dia next group match against Burundi on Sunday
Substitution, Nigeria. Francisca Ordega replace Asisat Oshoala sake of injury.
Since dem take di lead for di second half dem dey manage di game well.
No risky pass dem dey calm in possession.
South Africa dey comfortable wit dis score line but Nigeria dey shake.
Nigera defence collapse again afta anoder neat pass from South Africa.
Super Falcons don send players for bench to warm up.
54' South Africa neva test Nigeria goalkeeper for dis game.
Asisat Oshoala (Nigeria) left foot shot from di centre of box dey saved again by di goalkeeper.
49' Halimatu Ayinde (Nigeria) win free kick for di defensive second half.
47'Corner for Nigeria. Noko Matlou of South Africa concede am.
Nigeria and South Africa group c for di Women African Cup of Nations.
No changes for di two teams
No goal for di first half between Super Falcons of Nigeria and Bayana Bayana of South Africa.
For dia Group C WAFCON match.
Short corner kick as dem work di ball from side but di cross land for Nigeria goalkeeper hand.
0-0