Lagos govnor match break for safe abortion guidelines
Lagos State Governor Babajide Sanwo-Olu don order di suspension of di “State Guidelines on Safe Termination of Pregnancy for Legal Indications” wey di Directorate of Family Health and Nutrition in for di Ministry of Health issue.
Na for inside statement wey di Commissioner for Health, Prof. Akin Abayomi, titled, “Retraction on guidelines relating to safe termination of pregnancy for medical reasons in Lagos State’.
Sanwo-Olu say dem no go implement di new until dem don torchlight di mata well well.
Di govnor add say di suspension go give dem enough time for public sensitisation and stakeholder engagement.
Dem go reach di required consensus for successful guideline development.
“Among di plenti factors wey contribute to maternal mortality, illegal abortions and high-risk pregnancies leading to unresolvable complications rank high.
“Di Lagos State Ministry of Health dey find different different methods to remove illegal abortions and ensure say any mother no die during childbirth, wey dey scatter di family unit.













