Jerry Harris wey be Star of Netflix Cheer chop 12 years in prison

Wia dis foto come from, Getty Images
Jeremiah "Jerry" Harris, one of di stars of Netflix documentary series Cheer, don chop sentence to 12 years in prison on child sex abuse charges.
E plead guilty for February to charges of child pornography and travelling across state lines with di purposes of having sex with a child.
Dem also sentence am to eight years of supervised released afta prison.
Harris admit to exchange lewd pictures with 10-15 children for three states wey e know to dey underage.
Di Emmy-award winning series Cheer follow di lives of di Navarro College cheerleading squad inside Texas.
Harris' fame see am win one invitation to di Academy Awards as guest of TV host Ellen DeGeneres, where e interview celebrities on di red carpet.
Wetin lead to im investigation na one complaint from one Texas mother, wey her twin sons dey abused by Harris.
For one later season of Cheer, di boys go on to describe how di abuse sometimes take place for cheerleading competitions.
Di boys, wey now dey di age of 16,dey present for di sentencing hearing inside Chicago, according to USA Today.
Each of dem give statements, describing di lasting impacts of Harris' crimes.
















