Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style
Live updates from Nigeria, Africa and across di world.
Live Coverage
Why Elon Musk dey pull out of $44bn deal to buy Twitter
All you need know about UK-Nigeria Migration Agreement
Students protest with deadi bodi of dia mate Amotekun official allegedly shoot dead for Owo
Una bye bye!
Na here we go march break ontop our live updates of tori dem from across Nigeria, Africa and di world dis week.
Make you scroll down for all di tori dem from dis week.
Court jail husband and wife wey kill dia house help
Article Information - Author, Andrew Gift
- Role, BBC Pidgin, Lagos

High court for Lagos state southwest Nigeria don send husband and wife to jail unto say dem kill and conceal di death of dia house help Joy Adole for Bariga area of di state.
Justice Oyindamola Ogala sama Mrs Fortune Nwankwo 14 years jail term and sentence her husband Steve Nwankwo to two years imprisonment.
Di judge rule say di couple dey guilty of manslaughter, conspiracy and attempt to pervert Justice plus misconduct.
Di court say testimonies wey witnesses give dey strong enough and show fact say di deceased die sake of beating wey e collect from her madam Mrs fortune Nwankwo wey be di first defendant.
Di court convict di husband for conspiracy, misconduct and attempt to pervert Justice.
Justice Ogala say di couple stage di hanging of di bodi, say wen di husband Mr Steve Nwankwo wey be di second defendant find out say im wife don kill di girl through beating, e helep di wife commit crime unto say e help her use rope hang di body, dat na attempt to pervert Justice.
Di judge rule say na di beating wey di first defendant give di deceased kill am. Dis na sake of say di deceased bin no dey feel well before di incident.
Di couple Mr and Mrs Nwankwo bin dey accused say dem kill dia house girl for April 2020. But di couple deny di accuse say di girl commit suicide by hanging herself for her room.
According to di court, wen dem find out say she done die, dem no inform di deceased family from 5:00am till afternoon wen dem call di sister to demand her full name wey dem go use embalm am for mortuary.
Di judge say dem commit offense wen dem embalm di body wey make am dey difficult to do autopsy. Dat one na tampering of evidence.
Wike trend afta fotos show top APC govnors visit am for Port Harcourt

Wia dis foto come from, RVGH Press
Some govnors of di All Progressives Congress on Friday cary waka go di private residence of Govnor Nyesom Wike of Rivers State for a closed door meeting.
Di govnors wey visit Wike for im kontri home for Rumueprikom, na Kayode Fayemi of Ekiti State, Babajide Sanwo-Olu of Lagos State and Rotimi Akeredolu of Ondo State.
Also present for di meeting na former Ekiti State governor, Ayodele Fayose.
Details of di closed-door meeting neva dey known yet.
Dis na di latest of di high level visit by political stakeholders to Govnor Wike recently.
Di Labour Party presidential candidate, Peter Obi also recently visit Wike for im state.
Biden sign executive order on abortion access

Wia dis foto come from, Getty Images
President Joe Biden don sign one executive order to boost protections for abortion and contraception access.
Oga Biden has face pressure from fellow Democrats to respond with bolder action afta one recent Supreme Court ruling overturning Roe v Wade.
E open di way for individual US states to decide if and how to allow abortions.
Di order includes measures to safeguard access to abortion medication.
E increase protection against potential penalties wey women wey wan do abortion fir face if dem travel across state lines for di procedure, protects access to contraception, and take steps to protect patient privacy.
Di order directs Health and Human Services Secretary Xavier Becerra to submit one report within 30 days on those efforts.
Oga Biden don maintain say e ability to institute abortion rights dey limited without action from di US Congress.
"Until den, e don dey committed to do everytin within im power to defend reproductive rights and protect access to safe and legal abortion," White House tok for statement on Friday.
Dis action dey come nearly two weeks afta di Supreme Court rule to overturn Roe v Wade, di landmark 1973 ruling wey guarantee di constitutional right to an abortion across di US.
Since den, at least nine states don institute near-total ban, with di only exception being danger to the life of di mother.
Oda states now dey scramble to protect abortion access as legal challenges dey plenti, while abortion clinics dey struggle to navigate patchworks of new laws.
10 tins to sabi about AU Covid vaccine passport wey go allow you travel abroad and inside di continent
Fotos of mourners as dem dey pay dia respects for di place wey dem shoot Shinzo Abe
Pipo don dey leave flowers near di site of di shooting.
See di scene for Nara now:

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Mourners pay dia respects for Shinzo Abe 
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Mourners pay dia respects for Shinzo Abe 
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Mourners pay dia respects for Shinzo Abe 
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Mourners pay dia respects for Shinzo Abe Medical student allegedly kidnap imsef to collect ransom from parent

Wia dis foto come from, Getty Images
Police for Kenya capital, Nairobi, don arrest one medical student wey allegedly fake im own kidnap to demand ransom from im parents.
Dem accuse di 23-year-old say e "disappear" on Sunday and call im mama days later to ask for 70,000 Kenyan shillings ($593; £494) as ransom money.
Dem pay di first instalment of di ransom on Wednesday, but police say di student bin go dey drink upandan for di outskirts of di city wit one woman wey put something for e drink and later steal im money.
On Thursday, im allegedly demand and dem pay am second instalment of di ransom.
Police later arrest am and dem see wia e keep di money for inside shoe.
Police say di student confess say im don squander di money wey im suppose use pay last semester fees and fake im kidnap to raise more funds.
Dem go later arraign di suspect for court.
Key points from police press conference afta assassination of Shinzo Abe

Wia dis foto come from, Reuters
Wetin we call dis foto, Police outside di hospital wey dem carri Shinzo Abe go Police don do press conference afta dem assassinate Japan former Prime Minister Shinzo Abe, for di city of Nara today.
Dem catch di suspect, 41-year-old Tetsuya Yamagami, near di site of di shooting, police tok.
Afta Abe die around 17:03 local time, police say dem turn di case into a murder investigation.
Dem don establish one 90-person investigation taskforce.
See oda tins we learn:
- Di suspect, 41-year-old Tetsuya Yamagami, admit say e shoot di former prime minister with a homemade gun
- E tell officers say e get grudge against one "specific organisation" wey e believe say Abe be part of
- E dey unemployed and travel to Nara by train, but police no fit tok we e arrive.
- Dem don find several handmade weapons, similar to those wey dem use for di attack for im house

Wia dis foto come from, Takenobu Nakajima/via REUTERS
Wetin we call dis foto, Di moment di suspect dey detained by police Abe bin dey di southern city of Nara dey give speech to back di candidate of di Liberal Democrat Party wey e be member of ahead of Sunday upcoming elections wen for about 11:30 local time dem shoot Abe twice from behind, e injure for im to his chest and neck.
As di 67-year-old collapse, security guards tackle di gunman to di ground and arrest am. dem come carri Abe go Nara Medical University Hospital wia doctors spend hours dey try to save im life.
President Buhari send condolence to Japan over Shinzo Abe death

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria President, Muhammadu Buhari don extend im heartfelt condolences to di family of former Japanese Prime Minister Shinzo Abe, and di goment plus pipo of Japan.
President Buhari dey send im condolence over di passing of Shinzo Abe, wey die afta dem shoot am as e dey give one speech for one event.
Di President say e join all Japanese in mourning di loss of di kontri longest serving Prime Minister and outstanding leader.
E assure di family of Abe of di prayers and thoughts of all Nigerians during dis difficult time.
President Buhari recall say Abe go dey remembered for im strong commitment to strengthening trade and investment between Africa and Japan through various initiatives and partnerships, using di instrumentality of Tokyo International Conference on African Development (TICAD).
Di president also tok say under Abe, Nigeria and Japan enjoy strategic partnership, supporting each oda shared aspirations on economic cooperation, healthcare, human resource development, disaster risk reduction, peace and security.
Angola former President Dos Santos don die
Tariq Lamptey, Inaki Williams, foreign players wey switch to play for Ghana
Peter Obi running mate Datti Baba-Ahmed profile
Muslims across di world dey observe Arafat Day - Dis na wetin e mean

Wia dis foto come from, BBC Hausa
Day of Arafat dey happun every 9th day of Dhul Hijjah month wey be di last 12th and last in di islamic calendar and di day na di holiest day of di year for muslims.
Di day get im name from mount arafat wia di prophet Muhammad (PBUH) give im last sermon to muslims for di year wey e pass on.
Na day wey muslims wey travel to Saudi Arabia for Hajj go converge for Mount Arafat for Mecca to pray for Allah’s forgiveness and blessings.
For muslims across di world wey no travel to Saudi Arabia, imams advise dem to fast for di day and to dey recite prayers in order to also benefit from di blessings wey those in Hajj go get.
According to di prophet saying no any oda day of di year wey get as much blessinngs and forgiveness from God to im worshippers like Arafat Day.
Names, faces of all Boko Haram terrorists wey escape Kuje prison
Police for South Africa destroy over 40,000 guns and parts
The South African Police Service (SAPS) don permanently remove Fourty-Six Thousand, Five Hundred and Ninety-Two (46,592) firearms from circulation within six months.
Dis na afta one firearms destruction process wia firearms, ammunition and firearm parts wey police seize during crime prevention operations, or dem voluntarily surrender or forfeit dem to di state .
Dem destroy di firearms for Vanderbijlpark, Gauteng.
Na 20, 590 firearms police destroy today,15, 465 of di destroyed firearms na handguns.
2, 686 na rifles, 1, 855 na shotguns and di rest na firearm parts.
For March dis year, Police destroy 26, 002. Di total number of firearms and firearm parts destroyed na 46 592.https://www.saps.gov.za/newsroom/msspeechdetail.php...

Wia dis foto come from, South African Police

Wia dis foto come from, South African Police
Marburg virus kill two people for Ghana - Dis for concern you?

