Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style

Live updates from Nigeria, Africa and across di world.

Live Coverage

  1. Scroll down for Tuesday tori!

    We dey hail una for staying wit us throughout our live coverge of tori from around di world including Nigeria, Ghana plus oda kontris.

    Make una scroll down for all di ogbonge tori wey you for don miss today.

    Join us again on Wednesday.

  2. Mali migrants die for sea off Libyan coast

    Mali migrants die for sea off Libyan coast

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Twenty-two migrants from Mali, including three pikin, don die afta dia boat get into difficulties off di Libyan coast.

    Di Malian goment tok say dem dey part of a group of more dan 80 migrants wey bin dey stuck on dia vessel for much of di last two weeks.

    Wit di help of di United Nations' migration agency, dem rescue sixty-one pipo from di boat.

    One tok-tok pesin for di agency say "significant increase" dey in migrant flows through Niger and Mali towards North Africa in di first quarter of dis year.

  3. Pope go visit South Sudan if im health permit

    Pope intend to visit South Sudan if im health permit

    Wia dis foto come from, Nichola Mandil/BBC

    Pope Francis still intend to visit South Sudan if im health improve, one top Vatican official wey dey help am tour di kontr tok.

    Last month, di pontiff bin postpone im trip to South Sudan and di Democratic Republic of Congo on di advice of im medical team sake of knee pains.

    Im send Cardinal Pietro Parolin, di Vatican’s secretary of state, to di neighbouring kontris instead.

    “Na great joy for me to be wit you and to be able to stay for days and pray wit you on behalf of Pope Francis,” di cleric tell bishops and goment representatives on im arrival at Juba International Airport on Tuesday morning.

    “Di Holy Father dey follow development[s] wey dey take place [in South Sudan] and im go like to assure all of you - di population, di Church and di authorities - of im prayers and im spiritual support,” im tok.

    As part of im four-day visit, Cardinal Parolin go travel to Bentiu town on Wednesday.

    Di capital of oil-producing Unity state, in di north of di kontri bin recently experience flash floods wey force thousands of pipo from dia homes and destroy dia livelihoods.

    Di senior cleric go also celebrate one mass on Thursday and lay a foundation stone for di new Vatican Embassy in South Sudan.

  4. PM Abiy say Oromia attack na massacre

  5. Premier League player receive question sake of two more rape claims against different woman

    Premier League player receive question sake of two more rape claims against different woman

    Wia dis foto come from, Getty Images

    One Premier League and international player wey chop arrest for north London on Monday on suspicion of rape don receive questions ova two further rape allegations against a different woman.

    The 29-year-old wey dem neva name bin enta custody on Monday morning ova alleged attack in June.

    The Metropolitan Police on Tuesday tok say di man don chop anoda arrest on suspicion of two incidents of rape for 2021 against anoda woman.

    Dem don release am on bail till August.

    Di Met Police tok for inside statement: "On 4 July, an allegation of rape of a woman in her 20s dey reported to police.

    "E dey reported di alleged rape happen for June 2022. On 4 July, a 29-year-old man chop arrest at one address in Barnet on suspicion of rape and im enta custody.

    "While in custody, e chop further arrest on suspicion of two incidents of rape that wey e allegedly commit for April and June 2021 against a different woman in her 20s.

    "E don dey released on bail to a date in August. Enquiries into di circumstances dey go on."

  6. Ethiopian president accuse rebels of new ‘massacre’ for di kontri

    Ethiopian president accuse rebels of new ‘massacre’ for di kontri

    Wia dis foto come from, Getty Images

    A fresh round of attacks against ethnic minorities for western Ethiopia don leave "many" villagers dead - di second such attack in a little over two weeks.

    Dem target faming villages where members of di Amhara community dey live, according to witnesses wey speak to di BBC.

    Prime Minister Abiy Ahmed don call di incident a "massacre" and vow say e go "eliminate" di armed group - di Oromo Liberation Army - wey e blame for di violence.

    Di group neva respond to di accusations.

    Di attacks begin around dawn on Monday for Oromia region’s Hawa Gelan district and continue for at least three hours.

    Dem kill men and women, children and di elderly pipo, witness tell BBC.

    Dem set houses on fire and survivors dey currently stay for mosques.

    Official death toll neva dey yet but fears dey say e fit dey on di high side.

    338 pipo die for one similar attacks against minorities around two weeks ago, according to official figures.

    Activists say di real figure even dey higher.

    Ethnic violence don rise for Ethiopia in recent years and e be like say tins dey worse.

  7. Egypt jail researcher sake of Facebook post

    Egypt jail researcher sake of Facebook post

    Wia dis foto come from, Getty Images

    One Egyptian court don sentence one researcher to three years in prison for one retrial over charges say im "publish false news".

    Researcher Ahmed Samir Santawy, 30, chop accuse say im publish "publish false news from abroad" on conditions in di kontri in a Facebook post on im personal account.

    One exceptional court nai sentence am for one verdict wey e no fit appeal.

    Santawy's lawyer, Ahmed Ragheb, tell di independent Mada Masr website say e go file a request wit di recently formed presidential pardon committee for im client release.

    Dem initially sentence di researcher to four years in prison over di same charges for July last year.

    However, dem overturn di verdict after im lawyers file a grievance.

    Dozens of domestic and international human rights organisations don dey call for Santawy's release.

    Santawy, wey bin dey study for Austria, cho arrest and detention from security forces on 1 February 2021 wen im dey on holiday for house.

    Im new sentence come one day before di start of political dialogue wit opposition figures in di kontri on Tuesday.

    Dem release dozens of political activists before di dialogue.

  8. Jermaine Baker: Met Police fatal shooting of unarmed man dey lawful - Inquiry tok

    Jermaine Baker: Met Police fatal shooting of unarmed man dey lawful - Inquiry tok

    Wia dis foto come from, PA Media

    Wetin we call dis foto, Dem shoot Jermaine Baker in Bracknell Close, near Wood Green Crown Court

    One Metropolitan Police operation where one officer fatally shoot one unarmed man for north London dey lawful but failings dey at almost every stage, one inquiry don find.

    Di office shoot 28-year-old Jermaine Baker during one failed attempt to free one inmate from a prison van near Wood Green Crown Court in 2015.

    Dem no find live firearm inside di car wey dem shoot Mr Baker.

    But Judge Clement Goldstone QC say race no be factor in di shooting.

    Mr Baker's mother, Margaret Smith, say she reject di conclusion say her son no die as a result of police failings, wey inquiry chairman Jugde Goldstone QC find at almost everi stage of di operation.

    Di Met Police tok say dem go take time to carefully study di inquiry's conclusions.

    Mr Baker na one of di three men wey wait inside a stolen Audi to free inmate Izzet Eren, a senior member of di notorious Tottenham Turks gang.

  9. Tunisian parties call for referendum boycott

    Tunisian parties call for referendum boycott

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Tunisians dey protest against President Kais Saied

    Two political parties in Tunisia don tell pipo say make dem no attend dis month's referendum on a new constitution.

    Di recently formed Work and Achievement party tok say President Kais Saied’s draft constitution “wan put in place individual rule” and threaten di independence of di judiciary.

    Di secular Democratic Current party also tok say draft constitution “threatens di existence of di state”.

    Speaking earlier President Saied deny say di proposed constitution go restore authoritarian rule. E insist say e go guarantee citizens rights and freedoms.

    Tunisia’s referendum dey expected to take place on 25 July.

  10. Uganda table bill on organ transplants

    Uganda table bill on organ transplants

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Di Ugandan Health Ministry don table Human Organ Donation and Transplant Bill in Parliament.

    If dem pass am into law, di east African kontri go become one of very few in Africa wit any legislation on transplant surgery.

    Di proposed law go make di Mulago National Referral Hospital in di apital Kampala as a transplant centre, establish organ banks, and a council to oversee transplant surgery.

    E go also provide for organ harvesting from both living and donors wey don die and prevent any payment for transplant organs or tissue.

    Di proposed bill dey try protect di rights of organ donors, prevent illicit trade in human organs, and provide environment where dem go fit do transplant surgery.

    Di House Committee on Health go review di bill before parliament fit debate and pass am.

    Ugandans wey dey in need of transplant surgery currently dey travel abroad to access am.

    Uganda Medical Association and the Medical Board gass review patient case before dia trip fit dey approved.

  11. Pesin wey pretend to be one family son for 41 years after dia son miss

  12. Sierra Leone FA dey investigate two matches wey dem score 187 goals

    Sierra Leone fans watch di men national side for di Africa Cup of Nations early dis year

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Sierra Leone Football Association (SLFA) dey investigate di outcome of two matches wey dem for score 187 goals.

    Di football governing body say dem go look into both officals and players wey dey involve for di fixtures.

    For di match Gulf FC thrash Koquima Lebanon 91-1 and Kahula Rangers knack Lumbenbu United 95-0 for di Premier League qualifiers on Sunday.

    Di SLFA say dem get zero tolerance for match manipulation or anything of dat sort.

    "We no fit stand by and see embarrassing situation like dis go unpunished," SLFA president Thomas Daddy Brima tell BBC Sport Africa.

    "We go launch immediate investigation and bring to book all those wey dey responsible for dis mediocrity."

    "We go deal with all those wey dey guilty in accordance with di SLFA laws, and also hand dem ova to di kontri anti-corruption commission."

    Di chief executive of Kahunla Rangers "strongly condemn unsportsmanlike behaviour" and Lumbebu general manager say e no dey "aware of any match manipulation".

    Meanwhile, di chairman of Koquima Lebanon claim say di match wey involve im side na actually friendly one and officials from Gulf FC no gree comment on dis mata.

    If di SLFA confam say di goals happun true-true, di two scorelines go rank among di highest recorded in soccer history.

  13. Doctor chop prison sentence for killing patient during careless procedure

    Doctor chop prison sentence for killing patient during careless procedure

    Wia dis foto come from, REACH

    Wetin we call dis foto, Dr Isyaka Mamman bin chop suspension before for lying about im age

    One doctor wey kill mother of three pikin during careless procedure don chop three years prison sentence.

    Dr Isyaka Mamman bin dey careless about di procedure e perform on di victim wen she come for routine appointment.

    Di doctor wey dem believe say na 85 admit gross negligence manslaughter over di death of Shahida Parveen, 48, at di Royal Oldham Hospital in 2018.

    Im use di wrong needle and insert am in di wrong place, piercing di sac wey hold Mrs Parveen's heart.

    Mrs Justice Yip at Manchester Crown Court say Mrs Parveen's death na im fault and give am three years jail term.

    She also criticised di NHS trust sake of say Mr Mamman bin don lie about im age and don dey involved for two critical incidents wey dey similar to di one wey lead to Mrs Parveen's death.

  14. Suspected jihadists kill 27 for Burkina Faso attacks

    Suspected jihadists kill 27 for Burkina Faso attacks

    Officials for Burkina Faso say suspected jihadists don kill at least 27 people for attacks on villages in di north of di country at di weekend.

    They tok say 15 pipo - some of them children - die for one attack late on Sunday in Kossi province.

    Some witnesses say as many as 20 pipo don die.

    For di oda attack, 12 pipo die for Yatenga province on Saturday.

    Burkina Faso, wey be one of di poorest kontris in di world dey struggle wit jihadist insurgency wey come from neighbouring Mali in 2015.

  15. Zimbabwe wan begin issue gold coins as legal tender

    One troy ounce of gold - wey go dey for di Mosi-oa-tunya coin - costs more than $1,600

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Zimbabwe central bank say dem go start to dey sell gold coins later dis month as way to protect pipo against inflation wey dey increase more-more.

    Central Bank Governor John Mangudya say dem go name di 22-carat coin di Mosi-oa-tunya, dat na di Zimbabwean name for Victoria Falls, and e go contain one troy ounce of gold - dey a little heavier than imperial ounce and equivalent to 31.1g.

    Di coin go dey easy to convert into cash and pipo fit also fit use am for transactions, di bank tok.

    But most pipo wey dey struggle in difficult economic circumstances go find am hard to afford di coin. Currently, one troy ounce of gold costs more than $1,600 (£1,300).

    Di gold price dey fluctuate but authorities see am as secure investment.

    High annual inflation - wey dem measure last month at nearly 192% don reduced di value of di local currency. So pipo fit see gold as alternative store of value.

    Dem dey also use US dollars as legal tender but dollar shortage dey for di kontri and pipo dey hope say di gold coins fit reduce dat demand.

  16. 'Age fraud' footballers face punishment for Cameroon

    'Age fraud' footballers face punishment for Cameroon

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Dem don use MRI scans in di past to catch pipo wey dey lie about dia age

    Forty-four footballers dey undergo investigation in Cameroon on suspicion of faking dia ages or dia identities.

    Most of di players hail from amateurs and some of dem come from local leagues, Cameroon's football-governing bodi Fecafoot tok.

    If dem find dem guilty, dem face a six-month suspension from matches, one Fecafoot official tell di BBC.

    Some number of club presidents wey chop accuse say dem follow do di fraud receive invitation to dis Fecafoot hearings, wey dem dey do behind closed doors.

    Accusations of age fraud dey common in Cameroon.

    In 2016, 14 Cameroonian players chop suspension by di kontri for some days before di before di U17 Africa Cup of Nations.

    Their true ages dey revealed wit di help of MRI scans, wey provide detailed images of di inside of dia body.

  17. PSG sack Mauricio Pochettino

    Paris Saint-Germain [PSG] don confam say dem don end dia contract with Mauricio Pochettino.

    Di Club for tweet on dia verified Twitter handle announce di informate.

    "We go like to thank Mauricio Pochettino and im staff for dia work and wish dem di best for di future." di tweet read.

    Dem no give any immediate reason for sacking di coach.

    Na 18 months ago na im di Argentine football manager join PSG.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  18. Catholic church fault 'Edo police rescue' of kidnapped Italian priest

  19. Nigeria winger Chidera Ejuke leave Russia for career progression'

    Ejuke

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Nigeria international Chidera Ejuke don become di latest African footballer to leave di Russian Premier League sake of di ongoing invasion of Ukraine.

    Di 24-year-old winger don take advantage of Fifa ruling wey allow foreign players to comot di kontri and don suspend im contract wit CSKA Moscow until 30 June 2023.

    Ejuke, wey im deal go expire for di end of June 2024, don score 10 goals and provide eight assists inside 65 appearances for CSKA Moscow since e join from Dutch side Heerenveen for 2020.

    One of Ejuke advisers say di reason why im move be sake of progress for im career.

    But e no gree comment on reports say di Super Eagle player dey set to join one German club on loan.

    "E be one important decision for Ejuke to go place where im fit continue to make career progress," di adviser tell BBC Sport Africa.

    "E bin start well for di national team but don fall since di pecking order and di new new Nigeria coach no look im side.

    "If e move somewhere and play regularly, e fit hopefully get back to di national team and continue im development."

    Ejuke has been capped eight times by Nigeria since making his debut in a 1-1 friendly draw with Tunisia in October 2020, and he made two appearances at this year's Africa Cup of Nations as the Super Eagles exited in the last 16.

    However, Ejuke dey overlooked by di three-time African champions for di two-legged 2022 World Cup play-off against Ghana for March.

    And new coach Jose Peseiro no select am for di first two qualifying matches for di 2023 Nations Cup.

    CSKA Moscow confam say dem suspend Ejuke deal, but add say dem plan to "defend dia interests against Fifa decision".

    Di 13-time Russian champions consider "discriminatory and contrary" to di world governing body statutes.

    Back in March, Fifa bin announce say foreign footballers wey dey play for Russia fit suspend dia contracts and temporarily comot for di kontri.

    Di move come afta Russia clubs and national sides dey suspended from all competitions "until further notice" by Fifa and Uefa.

  20. India don ban service charge for hotels and restaurants

    Pesin dey pay money for POS

    Wia dis foto come from, Getty Images

    India consumer protection authority don ban hotels and restaurants to add service charge for ontop dia bills.

    Dis order come afta authorities hala say customers dey complain give dem say dem dey forced to pay.

    Restaurants dey normally add 5% to 15% tip on top customer bill say na service bill nut for di new lar e no det allowed.

    Na for 2017 dem bring comot guidelines say na only price wey dey menu card customer need pay.

    And e don cause kasala for years for restaurants as customers dey say dem no dey tell dem about di extra charge.