Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style

Live updates from Nigeria, Africa and across di world.

Live Coverage

  1. Oda times wen prison break don happun for Nigeria

  2. Five tins wey fit cause kidney to fail

  3. Asisat Oshola go miss di rest of WAFCON tournament sake of injury

    Asisat Oshoala

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Nigeria striker Asisat Oshoala go miss di res of di Women's Africa Cup of Nations (WAFCON) because of knee injury.

    Di four time African Women Footballer of di year get di medial ligament injury wen SOuth Africa flog Nigeria 2-1 on Monday.

    Oshoala get di wound for di early minutes of di game but still play for one hour before dem replace am for di 82nd minute of di game.

    Scans show say she get grade two medial collateral ligament injury and according to di Nigeria Football Federation (NFF) she go go back Spain on Thursday.

  4. UK PM say e go continue despite tension from Tory party

    Boris Johnson

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Boris Johnson dey fight to save im office, afta some of im ministers resign dia position.

    For Prime Minister Questions, e say im get "ogbonge mandate" from di 2019 election and go "continue im work ".

    But a large number of Tories dey quit goment or party positions, and backbenchers also dey withdraw dia support.

    Tory party boss dey due to meet by 16.00 BST, as questions ova di PM future continue to swell.

    Oga Johnson dey face threat from Conservative rebels wey want to change party rules to allow another no-confidence vote ontop im head.

    E bin survive dat vote last month, and under di rules as tins be e dey immune from another challenge for a year.

  5. UN agency say ova 8.79 million pipo don cross border from Ukraine since 14 February

    UN agency say ova 8.79 million pipo don cross border from Ukraine since 14 February

    Wia dis foto come from, Getty Images

    More dan 8.79 million pipo don cross di border from Ukraine since Russia's invasion in late February, di United Nations refugee agency tok on Wednesday.

    On dia website, dia agency tok say 8.793 million pipo don make di crossing since February 24, 2022.

    Di invasion of Ukraine by Russia still dey go on and many damages and deaths dey recorded.

    Sake of di invasion, Russia don chop many sanctions and di west dey tink of stronger sanction for dia action against dia neighbours.

  6. DR Congo Presido don draw ear say war fit start with Rwanda

    Congolese Army

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Congolese Army don dey fight plenti armed groups for di east of di kontri

    Di president of Democratic Republic of Congo don warn say im kontri fit enta war with Rwanda.

    Dis na as di relationship between di two kontris don dey worse dey go.

    Félix Tshisekedi tell dis one give UK newspaper Financial Times for interview, "dis possibility no fit comot, If Rwanda continue to dey provoke, we no go siddon look about am. We no dey weak".

    E bin accuse Rwanda say dem dey back di M23 rebel group. E also accuse dem say dem get "illegal economic intrest for DRC."

    Oga Tshisekedi suppose meet Rwanda president Paul Kagame on Wednesday or Angola.

    Di Congolese leader tell FT before di meeting say im wan make oga Kagame show "sincerity" for di toks and admit say na im goment dey back M23 rebels.

    Rwanda President don tok many times say di accuse no dey true.

    On Monday, e tok say di ongoing kasala na DR Congo mata and im kontri hand no dey inside.

  7. Hunger kill 13 pikin for southern Ethiopia

    Hunger kill 13 pikin dem for southern Ethiopia

    Wia dis foto come from, Getty Images

    At least 13 pikin dem for southern Ethiopia don die sake of hunger as drought and conflicts continue to affect di area, local authorities don tok.

    One local official from Konso district confirm di deaths.

    Im tell di BBC say crop failure continue to push many away from dia homes and farms.

    Di official tok say di number of malnourished pikin for di district dey grow and more dan 240 of dem dey hospital.

    Di goment relief agency tell BBC say dem dey provide aid to di pipo wey dey affected

    Ethiopia dey face di worst drought in decades and aid agency tok say seven million children under di age of five dey face acute malnutrition.

    Southern Ethiopia na one of di areas wey dey severely hit by di drought wey don leave at least 18 million pipo across di region witout enough food.

  8. Villager wey see gunmen attack president Buhari convoy tok how e happun

  9. More trouble as nurses, midwives and University of Ghana senior staff threaten strike over rising living costs

  10. Buhari assign position to new Ministers for cabinet reshuffle

    Di newly appointed ministers replace doz wey resign to contest di 2023 general elections.

    Wia dis foto come from, Presidency

    Wetin we call dis foto, Di newly appointed ministers replace doz wey resign to contest di 2023 general elections.

    President Muhammadu Buhari don carry out minor cabinet reshuffle.

    Na 11 ministries di reshuffle affect.

    Di president also assign position to di ministers wey Senate just screen and confam.

    Di ministers and dia portfolios na;

    • Sen. Adeleke Mamora – Minister of Science and Technology
    • Mu’azu Jaji Sambo – Minister of Transportation
    • Umana Okon Umana – Minister of Niger Delta
    • Sharon Ikeozor – Minister of State, Niger Delta
    • Sen Gbemisola Saraki – Minister of State, Mines and Steel
    • Umar Ibrahim El-Yakub – Minister of State, Works and Housing
    • Goodluck Nanah Opiah – Minister of State, Education
    • Ekumankam Joseph Nkama – Minister of State, Health
    • Ikoh Henry Ikechukwu – Minister of State, Science and Technology
    • Udi Odum – Minister of State, Environment
    • Ademola Adewole Adegoroye – Minister of State, Transportation.

    Di newly appointed ministers replace doz wey resign to contest di 2023 general elections.

  11. US charge suspect wit murder ontop 4 July mass shooting

  12. Names, faces of victims wey die for Scenery Park tragedy

  13. Mumbai: Heavy rain bring life to standstill for Indian city

    Pipo dey struggle through di water

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Pipo dey struggle through di water

    India weather department don issue high alert warning sake of flood wey dey happun becos of heavy rains di kontri dey experience.

    E don reach dat time of di year wen heavy rains for di Indian city of Mumbai and nearby areas dey affect millions of pipo for di kontri financial capital.

    Many parts of di city remain flooded wit deep water as di non-stop rains dey fall for di city, causing flooding and waterlogging.

    National Disaster Response Force don deploy go several districts to respond to emergencies wey go happun.

    Monsoon rain dey common for di Maharashtra state – wia Mumbai dey – around dis time of di year.

    But sabi pipo say climate change don make di rain worse and e dey unpredictable in recent years.

    Di rain don cause heavy damage to pipo property

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Di rain don cause heavy damage to pipo property
    Children dey play in water wey no gree flow

    Wia dis foto come from, Getty Images

    India weather department don predict heavy rainfall for di city until di end of di week

    Wia dis foto come from, Getty Images

  14. Uganda adopt Swahili as official language

    Di cabinet also recommend di compulsory teaching of Swahili for primary and secondary schools

    Wia dis foto come from, Uganda goment

    Uganda cabinet don approve to use alias adopt Swahili as dia official language, according to one statement.

    Di cabinet also recommend di compulsory teaching of Swahili for primary and secondary schools.

    Swahili, wey originate from East Africa na one of di world 10 most widely spoken language wit about 200 million speakers.

    Pipo for Somalia down to Mozambique and across di Democratic Republic of Congo dey speak di language and di dialect.

    For statement di Ugandan cabinet say di decision follow directive by di East African Community to adopt di language to ease communication among member kontris.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  15. South Africa wan hold mass burial for nightclub victims

    Tori be say di teenagers dey celebrate di end of dia exams.

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Tori be say di teenagers dey celebrate di end of dia exams

    Di mass funeral for 21 teenagers wey die mysteriously for one South African nightclub more dan a week ago go happun Wednesday.

    Di funeral ceremony for di teenagers wey dey between age 13-17 go hold for one giant tent for Scenery Park, East London inside di rainbow nation.

    South Africa President Cyril Ramaphosa and government officials, friends, relatives and students dey among about 3,000 pipo wey go attend di burial.

    Wetin cause di death still neva clear - tori be say di teenagers dey celebrate di end of dia exams.

    Sabi pipo say early results show say di teenagers inhale or ingest dem sef wit some substance wey lead to dia deaths but di toxicology report still dey in progress.

    Dis don make goment review nightclub licences and premises for East London, and di Enyobeni tavern, wia dem discover di deadi body dem.

  16. Una good morning

    Welcome to our live page for today.

    Tanda here, follow all di tori wey dey happun for di world

  17. OPEC Secretary-General die hours afta visiting Nigeria President

  18. IS claim Kuje prison attack, Buhari blame intelligence system failure

  19. Two pipo injure as gunmen open fire on President Buhari convoy for Katsina

  20. 'I be one of de Black Stars' - Striker Inaki Williams switch nationality from Spain to Ghana