Raheem Sterling leave Man City to Chelsea afta seven seasons
Raheem Sterling don confam say im don leave Manchester City.
Chelsea don also confam im move to join di Blues afta e dump City.
Di 27-year-old dey make £50m move to Premier League rivals Chelsea.
Sterling say e arrive Manchester wen e be 20-year-old and today e dey leave as a man.
E say e play seven seasons, win 11 major trophies for City.
And im dey walk away wit a lifetime of memory.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post











