Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style
Live updates from Nigeria, Africa and across di world.
Live Coverage
Chelsea dey target Sevilla Kounde as Barca close in on Lewandowski - Saturday football tori
Una bye-bye!
Na here wey go end today live tori!
Make una join us again on Monday by 9:00AM.
Osun Election: 'Make una go polling units wit only PVC' -Amotekun tell members, "Make una no forget to cari una tested and confirmed African science materials" Amotekun

Wia dis foto come from, Amotekun Facebook
Ahead of di Govnorship election for Osun State on Saturday, Amotekun Corps for di state don draw ear for all di Commanders for di State.
For Inside letter wey Field Commander, Amotekun Corps Osun Command, Comrade Amitolu Shittu sign, e tell all Commanders for di state to comport diasef and make dem dey forward, peaceful and dey law abiding.
"Make Area Commanders and Local Govment Commanders for Osun State conduct and organise di men under dem peacefully.
"Make una no wear Uniforms go vote, make una no cari anytin go any polling Unit apart from una Permanent Voters card(PVC)"
"Make una no forget to cari una tested and confirmed African science materials.
E add say make dem send all dia observations and reports to dia Amtekun Osun situation base and make dem report any katakata to Police or oda accredited security pipo around dem.

Wia dis foto come from, Amotekun Facebook
First time voters, police tok ahead of Osun election
Manchester Utd sign Denmark midfielder Christian Eriksen, Christian Eriksen na di player wey bin collapse for field during Euro 2020 wey dem play for 2021
Manchester United don complete di signing of Denmark midfielder Christian Eriksen on free transfer.
Di former Ajax, Tottenham, Inter Milan and Brentford player sign contract to stay for Old Trafford for three years.
Christian Eriksen wey be 30 years tok say im still get major ambitions for di game.
"I still get major ambitions for di game. E get huge amount wey I know say I fit achieve, and dis na di perfect place to kontinu my journey," Eriksen tok.
"Manchester United na special club, and I cannot wait to get started, 'I dey happy well well for di future'
Earlier July, Eriksen agreed in principle to sign for Unitedafta im short-term contract for Brentford ewey end for June.
Eriksen, return to football afta dem put Implantable Cardioverter Defibrillator (ICD) inside im chest afta e get cardiac arrest for Euro 2020.
Na United second signing under new manager Erik ten Hag afta Netherlands full-backTyrell Malacia from Feyenoord.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Christain Eriksen Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Court stop Amotekun from election duty, INEC say dem no enlist dem befor

One Federal High Court for Osogbo, Osun State capital, don restrain Osun Security Network, codename Amotekun Corps from participating for Saturday govnorship election.
Di court order also mandate Independent National Electoral Commission (INEC) not to use Amotekun Corps as part of im personnel wey dem go use as security for di election.
Di order warn Amotekun make dem no serve as security officers or volunteer for di election.
“Di 1st defendant (INEC) dey hereby restrained from requesting deployment of di second defendant (AMOTEKUN) as part of im security personnel deployable for di purpose of Osun 2022 govnorship election pending determination of di originating summons for di suit.”
Di Resident Electoral Commissioner for di state, Prof. AbdulGaniy Raji say di order no too get many sake of say di commission no dey use Amotekun for election befor.
E say true-true dem recieve di order but e dey surprising becos Amotekun na state security ouftit and INEC no dey do collabo wit any state outfit.
Court order Federal goment to review salary of Judicial workers, Dem neva review dia salary since 2008
Article Information - Author, Tamara Ebiwei
- Role, BBC News Pidgin

Wia dis foto come from, Aliyu
Di National Industrial Court for Abuja don order di Revenue Mobilisation and Fiscal Commission to do upward review of salaries and allowances of Judicial Officers for di kontri wit immediate effect.
Justice Osatohanmwen Obaseki-Osaghae wen e dey deliver judgement say, wit di current socio-economic realities both locally and internationally, di salaries of Judicial Officers dey embarassing.
Di Industrial Court for Abuja say make goment pay beween 7 to 10 Million Naira as monthly salaries for differnt level of Judicial officers for di kontri.
E deliver di judgement for di suit wey seek di increase of di salaries and allowances of Judicial officers wey Sebastian Honour wey be Senior Advocate of Nigeria file against Federal Govment, National Assembly and odas wey get hand for di mata.
Court hold say di failure of concerned authorities to review di salaries of Judicial officers since 2008 dey unconstitutional.
E order di Attorney General of di Federation wey be di third defendant for di mata to make sure say dem enforce di judgement sharp sharp.
Dis four-year-old dey among di pipo wey die in Russian attack for Ukraine

Wia dis foto come from, LOGOCLUB CHILDREN'S CENTER
A four-year-old Liza na one of di three young pikin wey die on Thursday wen Russian missiles hit di centre of Vinnytsia.
Her mother, Irina Dmitrieva, dey seriously injured for di attack.
Na Twenty-three people dey known to loss dia lives and anoda eight still dey missing. Dozens more still dey for hospital.
Shortly before di missiles struck, Irina bin post video online. Na beautiful sunny day and little Liza dey smile, pushing her pink chair wey dey front of her, as dey chat about heading to see her speech therapist.
She dey run di LogoClub centre for special needs wia Liza bin dey attend a session dat morning, as she dey do most days.
Di four-year-old get Down's syndrome and her mother's Instagram account dey filled wit pictures of di girl's life wey she begin posting soon after she born her only child.
Osinachi pikin dem testify for Court, Court adjourn mata to 11, 13 and 14th of October, 2022
Article Information - Author, Dooshima Abu
- Role, BBC Pidgin, Abuja

Wetin we call dis foto, Osinachi husband for court Di hearing of di alleged culpable homicide case against Peter Nwachukwu, di husband of di late gospel singer, Osinachi continue for di Federal Capital Territory High Court Abuja on Friday.
Osinachi first born and im younger broda testify under close door as di court no allow journalists and oda lawyers access inside di court.
Di prosecution counsel, Aderonke Imana for di last sitting bin raise one ogbonge motion wey border on di duty of care to di pikin dem wey go testify against dia papa for di ongoing trial.
She pray di court to protect di pikin dem by granting make dem close dia face alias blindfold and wear dem shield wen dem dey testify.
She quote di Child Rights Act and di evidence act to back her point.
Di presiding judge N.K Nwosu-Iheme come grant her prayers and say those wey no get hand for di mata like journalists no go dey court wen dem di testify.
Di pikin dem dia testimonies today don make am five pipo wey don testify for di ongoing trial.
Osinachi husband, Peter Nwachukwu dey face 23 count charges around culpable homicide wey lead to di singer death.
Nigerian goment arraign Nwachukwu on top di case wey border on domestic violence and homicide for May dis year.
Im plead not guilty to culpable homicide ontop im wife death, wen di case first come up in court.

Wetin we call dis foto, im pikin dem testify against am Southern African regional block agree to extend peacekeeping mission to Mozambique

Wia dis foto come from, Getty Images
Kontries from di Southern African regional block SADC don agreed to extend di mandate of a peacekeeping mission to Mozambique by a month to continue the fight against Islamist militants.
Jihadists don step up attacks for north of di kontri.
More than eight hundred thousand pipo don dey displaced since di violence begin five years ago.
Di Cabo Delgado province na stronghold for fighters wey dey link to di Islamic State group.
Attacks don also spread go Niassa and Nampula provinces where officials dey concerned about young pipo wey jihadists dey recruit.
Rwanda don also send hundreds of soldiers to assist di Mozambican military.
World Athletics Championships: We no go fit solve some US visa issues, Lord Coe

Wia dis foto come from, Getty Images
World Athletics President Lord Coe say no be all visa issues wey competitors get dem go fit solve quick quick.
Dis one mean say some atheletes no go compete for di World Athletics, wey be 'Athletics World Cup'.
Dozens of athletes don get delays to get permission to enta United States to compete for Eugene.
African champion Ferdinand Omanyala fit miss di heats of di men's 100m afta di Kenyan manage to get im visa one day before di championships start.
"We go work right up till di last minute but we no go dey able to resolve all those issues in time bifor di competition start? No, we no go fit," Lord Coe tell BBC Sport Africa.
Around 100 athletes, coaches and officials still dey wait for dia cases to dey resolved - and many of dia applications fit fail.
Multiple world and Olympic gold medallist Michael Johnson don criticise di organisers for im homeland.
Dis year's World Championships for Oregon na di first wey United States dey host and di strict entry requirements dey give foreign competitors plenti wahala.
Kenyan 10,000m runner Sheila Chepkirui suppose run on Saturday, but she say she never still get di required stamp for her passport despite say dem don approve her visa since May.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Constance Wu, Crazy Rich Asians star say she bin try to kill herself

Wia dis foto come from, EPA
Constance Wu don tok say she bin try to kill herself afta facing backlash ova comments wey she make about di renewal of her TV series Fresh Off The Boat.
Di US actress reveal dis for one statement wey mark her return to Twitter afta almost three years.
She add say she dey "afraid of coming back on social media because I almost lost my life from am".
Di Crazy Rich Asians star explain say she experience "internet shaming" afta her "careless tweets".
"Three years ago, wen I make careless tweets about di renewal of my TV show, e ignite anger and internet shaming wey come dey serious," she write on Thursday.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Sri Lanka wan persuade China to borrow dem over up to four billion dollars

Wia dis foto come from, Reuters
Sri Lanka say dem dey hope to persuade China to hand over up to four billion dollars to help dem manage dia financial and economic crisis.
Di kontri ambassador for Beijing, Palitha Kohona, tok say e dey confident China go agree.
About ten percent of Sri Lanka external debt na China dem dey owe. And dis figure dey estimated to be at least five billion dollars.
Di ambassador say dem don also ask oda creditors -- including Japan, di International Monetary Fund and commercial lenders -- for help.
Sri Lanka dey experience economic palava as dem dey face acute shortage of food, fuel and oda basic supplies.
Meanwhile, di kontri don swear in prime minister Ranil Wickremesinghe as acting president as di kontri dey try get back on dia feet from economic crisis and unrest.
Oga Wickremesinghe replace Gotabaya Rajapaksa wey run go Singapore afta mass protests wey demonstrators use force tear enta di presidential palace.
Nigerians carry complain go police station, not Twitter - Police PRO

Nigeria Police public relations officer, Lagos state police command, don advice Nigerians make dem dey carry dia complain go real police station.
Inside one post wey im do for im Twitter page, Superintendent of Police Benjamin Hundeyin say "pipo need to learn to channel dia complain correctly to real police stations, not Twitter stations."
E tok dis one in reaction to one post wey one Lagos resident post do for Twitter say robbers raid houses for Aguda, Sururele, Lagos.
Di complainant wey one Kelechi Bernard tweet, also call out di Lagos PPRO to make sure im "pipo tackle di menace before sometin unfortunate happun.
But SP Hundeyin say from in investigate, im don confam from di DPO of Aguda say nobody report di di alleged incidents.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Tins you fit do and those wey go land you for trouble on election day for Osun
'My wife die of heart attack ontop debts to buy dis house, years afta we neva see am'
Security agents tanda for Osun as residents prepare to vote on Saturday

Wetin we call dis foto, Over 1.5 million prospective voters don collect dia PVCs for Osun State Less dan 24 hours to di govnorship election for Osun state, security agents don full ground to secure di process and di pipo.
Di 21,000 police officers wey force headquarters deploy for di Osun state election don begin prepare to go dia postings.
Officers of di Department of State Security also dey parade Osogbo, di state capital.

Wetin we call dis foto, Election go happun for all di 3,763 polling units wey di 30 local goment areas of Osun State. Voters say dem don ready to cast dia votes and di election umpire INEC sef say everytin don ready for di process.
Election go happun for all di 3,763 polling units wey dey di 30 local goment areas of Osun State.
Over 1.5 million prospective voters don collect dia PVCs for Osun State.

Sri Lanka swear in Ranil Wickremesinghe as acting leader afta mass protests

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Sri Lanka swear in Ranil Wickremesinghe as acting leader afta mass protests Sri Lanka parliament don swear in prime minister Ranil Wickremesinghe as acting president as di kontri dey try to come out of economic crisis and katakata.
E dey replace Gotabaya Rajapaksa wey run go Singapore afta mass protest like di kontri neva see before.
Di protesters bin takeover di presidential palace.
Protesters refuse to observe curfew to celebrate im resignation during di night.
Sri Lanka dey experience economic palava as e dey face serious shortage of food, fuel and oda basic supplies.
Di process of parliament electing new president go begin on Saturday, and members of parliament dey likely to vote in one week time.
As per say di governing party get majority, e dey likely say MPs fit back Wickremesinghe, wey get close links wit di Rajapaksa family.
But weda Sri Lanka public go accept am na anoda mata becos Wickremesinghe resignation as PM na key demand of protestors.

Wia dis foto come from, EPA
Earlier dis week, crowds storm di former prime minister compound, clashing wit security forces.
One demonstrator, Manuri Pabasari, tell BBC during dat time say dem dey expect say protest rally against Ranil Wickremesinghe go happun soon.
"Im no get di mandate of di pipo [and] na well known Rajapaksa supporter," she added. "I mean di new president and new prime minister no suppose be Rajapaksa supporter."
Di govnor of Sri Lanka central bank, Nandalal Weerasinghe, don warn say di kontri fit shut down if dem no form stable goment soon.
"Plenty uncertainty" dey ova weda dem go fit find enough foreign to pay for essential petroleum, e tell BBC Newsnight programme, and add say di progress on getting international bailout package depend on having stable administration.
Meanwhile, Singapore say di expelled president Gotabaya Rajapaksa no ask for political asylum wen im enta dia kontri.
Di former president, wey enta Singapore wit im wife and two bodyguards, no longer get legal immunity as head of state and im position now dey more risky as im dey try to find safe kontir to shelter.
Di expectation be say im go saty for Singapore for some time before im possibly move go United Arab Emirates, Sri Lanka security sources tell tori pipo AFP news agency.
Rivers PDP drag APC to court for disqualification of NASS candidates
Article Information - Author, Karina Igonikon
- Role, BBC Pidgin, Port Harcourt

Wetin we call dis foto, Rivers PDP ask court to disqualify APC NASS candidates as dem do primaries after INEC timetable don pass Di Peoples Democratic Party (PDP) for Rivers State don drag National Assembly candidates of di All Progressives Congress (APC) before di Federal High Court for Port Harcourt.
Rivers PDP dey ask di court to disqualify APC NASS candidates as dem do primaries afta INEC timetable for political parties to do primaries don pass, so dem ask make di court cancel di party primaries wey produce di candidates.
Di PDP dey claim say APC for di state conduct dia delegate congress and primaries on di 18th and 19th of May, 2022 wey dey contrary to INEC electoral guideline and timetable for parties to do so.
Di case dey before Justice Stephen Daylop-Pam of di Federal High Court, Port Harcourt and e adjourn to Friday, 22 July, 2022 becos di lawyers never finish to file court processes.
Assistant Publicity Secretary of APC Rivers State, Darlington Nwauju express confidence say di suit dey dead on arrival, becos di PDP file di process out of time.
E say di right time to file any objection na 14 days afta di primaries but dem dey do so wen di 14 days don pass so e dey status barred and dem get confidence in di court to do di right tin.


