Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style
Live updates from Nigeria, Africa and across di world.
Live Coverage
Wetin cause di katakata for Sri Lanka?
Court dismiss suit wey seek to disqualify Osun State Govnor Oyetola
Article Information - Author, Dooshima Abu
- Role, BBC Pidgin, Abuja

Wia dis foto come from, Facebook / Govnor Adegobyega Oyetola
Federal High Court for Abuja don dismiss suit wey dey seek to disqualify Osun State Govnor Adegboyega Oyetola as di All Progressives Congress (APC) candidate, for di July 16 governorship election wey di hold for di state.
Delivering Judgement, Justice Inyang Ekwo say di plaintiff ( Moshood Adeoti), fail to support di process wit relevant laws, and as such, show no cause of action and dat wan mean gross abuse of court process.
Justice Inyang add say di suit dem bring forward fall outside di scope of section 87(9) of di Electoral act and section 22 of di 1999 constitution as amended.
Di govnorship election wey dey happun on Saturday 16 July, 2022 go see ogbonge contenders battle to become di number 10 govnor since di creation of di state for 1991.
Na fifteen candidates dey di race to become di next govnor of di South Western state.
Di current sitting govnor, Adegboyega Oyetola dey di race as im dey seek re-election into office for second term.
For candidate of di main opposition party, PDP dis na di second time im go contest for Osun govnorship election.
Fotos: Baba Ijesha arrive court on judgement day

Nollywood actor Olarenwaju James alias Baba Ijesha land for court for di judgement on im sexual assault case.
Presiding Judge, Justine Toyin Taiwo, dey expected to pass di court decision on di sexual assault on charges wey Baba Ijesha dey face.
See some fotos of di Nollywood actor for court today.



Mozambique declare five-day mourning for ex-Angola leader

Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, José Eduardo dos Santos died on Friday last week Mozambic don declare five days of national mourning sake of di death of former Angolan president José Eduardo dos Santos.
Di mourning period start for midnight on Thursday.
During di five days, di national flag go dey flown at half mast in di kontri and for all diplomatic representations abroad.
Di Council of Ministers take di decision on Wednesday night afta one extraordinary session.
Dos Santos die for one Barcelona hospital last week Friday last week wia im bin dey undergo treatment.
Santos na president of Angola for nearly 40 years, until 2017.
INEC dey investigate PVCs dem discover inside drainage for Port Harcourt, INEC say statistics of PVCs with Electoral Officers dey intact

Wia dis foto come from, Screenshot
Wetin we call dis foto, Some permanent voter cards dem bring out from gutter for Port Harcourt Di Independent National Electoral Commission INEC for Rivers State don begin investigate one viral video wey show some permanent voter cards some pipo allegedly discover for one drainage for Apa-Ogwu Estate, Rumuodara for Port Harcourt, di Rivers State capital, Southern Nigeria.
Di Head Voter Education and Enlightenment INEC Rivers State, Mark Usulor tell BBC Pidgin say di commission dey aware of di video wey dey trend and dem dey find di PVCs so dem fit test dem wit dia BVAS machine to find out weda dem be proper voters card for Rivers State or dem be cloned voters card.
“We dey see am say those cards no belong to Rivers State and na cheap blackmail. How dem go find those kain cards and e no dey for police, e no dey any wia for us to find am. We still dey investigate. We don inform security agents to help us find am so we fit test dem with our BVAS machine.”
“From our investigations, di statistics of cards we give to EOs all dey intact. So e fit be say no be cards from Rivers State or na cloned cards but our investigations go find out.” E tok.
IMF promise bailout as Ghana inflation hit 29.8%
Court dey ready to deliver judgement on Baba Ijesha case

Di Domestic Violence and Sexual Offences Court for Ikeja go deliver judgment on Olanrewaju Omiyinka aka Baba Ijesha case today.
Di Nollywood dey face accuse on six-count charge of indecent treatment of a child, defilement of a child, sexual assault by penetration, attempted sexual assault by penetration and sexual assault.
E bin plead not guilty to di charges afta Lagos State goment drag am go court.
Dis na fotos from court wia judgment go dey delivered today.

Wetin we call dis foto, Lawyers dey inside court wia dem go deliver judgement on Baba Ijesha case 
Wetin we call dis foto, Court room wia dem go deliver judgement on Baba Ijesha case Nollywood star Sobowale say she go appear for her first Bollywood movie

Wia dis foto come from, Sola Sobowale/Instagram
Wetin we call dis foto, Sola Sobowale Nigeria film industry star Sola Sobowale don announce say she dey set to feature for her first Bollywood movie role for India.
Di ‘King of Boys’ actress for her instagram post also add say she go play ‘dynamic’ role for di Indian project and no fit wait for fans to watch am.
Mrs Sobowale don appear for several Nigerian movies and soaps for plenty years now since she first hit limelight for Super Story in di early 2000's.
Skip Instagram postAllow Instagram content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Man chop arrest for raping 10-year-old girl wey dem deny abortion

Wia dis foto come from, FRANKLIN COUNTY JAIL
One man for US state of Ohio don dey charged wit raping one 10-year-old girl wey dem bin deny abortion.
Gershon Fuentes wey be 27 years old appear for court for Columbus on Wednesday.
Di plight of di unnamed girl draw international attention.
US President Joe Biden cite di situation for White House as im condemn abortion restrictions, but some pipo bin no believe di story.
Ex-Gambia spy chief chop death sentence

Wia dis foto come from, The Gambia Coalition
One judge for The Gambia don sentence to death di kontri former intelligence chief, Yankuba Badjie and four oda security agents for di killing of one political activist in 2016.
Dem kill Ebrima Solo Sandeng in di final days of brutal rule under former President Yahya Jammeh.
Sandeng na leading figure for di opposition United Democratic Party - dem bin arrest am during anti-goment protests.
Im die for prison two days later afta going through beating and torture.
Sandeng death cause anger wey eventually lead to di removal of President Jammeh afta 22 years in power.
Mr Jammeh run komot from di kontri for 2017 to Equatorial Guinea, wia im still dey in exile.
Baba Ijesha sentenced to prison for sexual assault - How di mata waka
Met Police dey investigate Mo Farah claim say dem traffic am to UK

Di Metropolitan Police say dem don begin investigation into UK athlete claim Sir Mo Farah say dem traffic am come di kontri to work as domestic staff.
Sir Mo say im enta UK under fake name afta escaping war for Somali Land.
Di 39-year-old runner say na one woman wey im no sabi force am into domestic work. Im bin previously tok say im na refugee wit im parents.
For one statement wey di Metropolitan Police release, dem say specialist officers don begin investigation.
"We dey aware of reports in the media concerning Sir Mo Farah. Dem neva make any report to MPS [Metropolitan Police Service] at dis time.
"Specialist officers don open investigation and dem currently assess di available information," di statement tok.
Elephants kill five pipo for Mozambique region

Wia dis foto come from, Getty Images
Elephants don kill five pipo inside a surprise attack on farmers wey dey harvest dia crop for one village for Macomia district for northern Cabo Delgado province.
Di victims include two children and one woman.
Odas wey manage to escape di elephant attacks return later to find di deadi bodi of dia relatives.
Di pipo na formerly displaced pipo wey just return to di village, according to local sources.
Cabo Delgado don dey at di centre of a jihadist insurgency since 2017 wey don force hundreds of thousands of pipo form dia homes.
“Dis na situation of conflict between humans and wildlife,” police tok-tok pesin Mário Adolfo tell Lusa news agency.
Di tok-tok pesin add say di victims no dey for protected area.
Ronaldo get offer to go play for Saudi Arabia for 300m euros - Thursday gossip
President Buhari say im no go leave inheritance for im pikin dem

Wia dis foto come from, @MBuhari/Twitter
Nigerian President Muhammadu Buhari say im don tell im pikin dem say e no dey leave any inheritance for dem.
Di president make di announcement wen e pay Sallah homage to di palace of Dr Faruk Umar Faruk wey be Emir of Daura for Katsina state, north-western Nigeria.
E say education na di best legacy wey e don leave for im children.
“We gass ensure say di children get proper education. Di knowledge dem acquire no suppose be to get goment jobs. We no get jobs for goment anymore. Wit technology, goments dey become more smaller, nimble and efficient," di president tok.
Una good morning!
Welcome to our live page.
Na here you go get all di latest tori from across Nigeria, Africa and di world.
Why police consider dis Nollywood actor death as 'murder'
Una bye-bye!
E don do for today live tori!
Make e be, so join us again on Thursday by 9:00AM
Tanzania experts dey investigate outbreak of strange illness

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Patients wey sick dey show symptoms wey dey similar to Ebola or Marburg Authorities dey investigate one sickness for di southern part of Tanzania.
Di Ministry of Health say 13 pipo dey infected so far.
Three odas don die while five dey isolation as two recover, officials tok.
Di13 cases don dey reported for Lindi region and patients get symptoms wey dey similar to Ebola or Marburg.
Dem dey experience fever, severe headaches, fatigue and bleeding, especially from di nose.
But di health ministry tok say di initial lab tests results rule out Ebola and Marburg viruses for hese cases.
Contact tracing dey go on and five pipo don dey for isolation, di ministry tok.
Chief medical officer Dr Aifelo Sichalwe beg Tanzanians to remain calm as investigations continue.
E encourage anyone wey dey show similar symptoms to immediately seek medical attention.
