Man wey shoot and kill pipo for im former high school face death penalty

Wia dis foto come from, Getty Images
One gunman wey kill 17 pipo for im former high school don go on trial for Florida.
Court dey set to decide whether im go face di death penalty or life in prison.
Nikolas Cruz, 23, plead guilty last year to 17 counts of first-degree murder ontop di 2018 Parkland shooting.
As prosecutors seek di death penalty, defence lawyers dey push for life in prison without parole.
Di trial dey expected to last four to six months and dem go show am for TV.
Dis na rare case of one mass shooter wey appear before a jury for di US.
Di shooting for Marjory Stoneman Douglas High School on Valentine's Day 2018 na also di deadliest to go before a jury for di kontri.












