Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style

Live updates from Nigeria, Africa and across di world.

Live Coverage

  1. Heat apocalypse fit happun for France, authority sama warning

    One firefighter dey work on fire for Louchats

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Authorities for western France don sama warning of one "heat apocalypse" for 15 regions as heatwave continue to cover much of Europe.

    Temperatures fit reach record levels for di southwest of di kontri as firefighters dey battle wildfires and thousands don dey forced to comot.

    Fires for Spain, Portugal and Greece don forced thousands more pipo to run.

    Record temperatures also dey expected in parts of di UK, wey also get im first ever red extreme heat warning in place.

    Wildfires for France in recent days don force over 16,000 pipo to run comot di area, as authorities don set up emergency shelters dem set up for evacuees.

  2. Passengers rescue afta plane crash in Somalia

    One Jubba Airways plane don crash during landing for Aden Adde Airport inside Somalia capital Mogadishu.

    Authorities say dem don rescue all 30 passengers and crew on board.

    Di airport staff dey currently dey work to clear di runway.

    Pipo dey share online dramatic images of fire and smoke from di incident, including these ones from Somalia state TV.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  3. Actors Guild of Nigeria confam death of Nollywood actress Adah Ameh

  4. We don register 85 million pipo for NIN

    nin

    Wia dis foto come from, NIMC

    Authorities for Nigeria don announce di number of pipo wey don register for dia National identification number.

    NIN na wetin Nigeria goment dey use establish di identity of every Nigerian.

    "We don enrol more than 85 million persons into di National identification number database now."

    Dis na wetin Nigeria president Muhammadu Buhari tok.

    "E say di work go continue, to leave behind credible and robust foundation of digital identity for di security and prosperity of Nigeria."

  5. WHO confirm two cases of Marburg virus for Ghana - what de virus be plus how person fit catch am

  6. Jennifer Lopez marry Ben Affleck for Las Vegas

    Ben Affleck and Jennifer Lopez

    Wia dis foto come from, Reuters

    Hollywood stars Jennifer Lopez and Ben Affleck don marry.

    Dis wedding dey come 17 years afta dem bin break up dia first engagement.

    Tori say di couple don come back togeda bin totori dia fans afta dem publicly display dia rekindled love on social media.

    "We do am, Love dey beautiful. Love dey kind. And e turn out say love dey patient. Twenty years patient," Jlo write am ontop website.

    Di Clark County Clerk Office for Nevada show for dia record system say Jennifer Lopez go change her name to Jennifer Affleck.

    "Dem dey right wen dem say, 'all you need na love'," JLo tok.

    "We dey so grateful to get in abundance, a new wonderful family of five amazing children and a life wey we never get more reason to look forward to."

    Di two meet on di set of di movie Gigli for 2002, and dem engage for 2003, but dem break am off di following year, blame am on "excessive media attention".

  7. Ugandan Joshua Cheptegei win 10,000 metre race for di World Athletics Championships

    Joshua Cheptegei don win 10,000 metre race for di World Athletics Championships

    Wia dis foto come from, EPA

    Di defending champion and world record holder Joshua Cheptegei don win 10,000 metre race for di World Athletics Championships wey dey hapun for Eugene, Oregon, for di United States

    Im win am in time of 27 minutes 27.43 seconds.

    Im fellow Ugandan Jacob Kiplimo come third.

    Dem, and di second placed Kenyan Stanley Mburu enjoy di applause from spectators.

    Di American Brooke Anderson claim gold for di women hammer event, as dem add am to dia home nation success.

  8. Ukraine president sack im security chief and top prosecutor say dem dey collabo wit Russia

    Di sacked officials, Ivan Bakanov and Iryna Venediktova, neva comment on dia sacking.

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Ukraine President Volodymyr Zelensky don sack di head of Ukraine security agency (SBU) and di prosecutor general, ontop many cases of treason for di two powerful organisations.

    Im say more than 60 former employees now dey work against Ukraine for Russian-occupied areas.

    Dem don open a total of 651 collaboration and treason cases against law enforcement officials, Im add.

    Di sacked officials, Ivan Bakanov and Iryna Venediktova, neva comment on di accuse.

  9. Wetin to know about di kidnap gang leader wey dem give chieftaincy title for Zamfara

  10. De Jong make U-turn on Man Utd, Bayern dey eye Kane

  11. How Nigeria, South Africa odas perform for African Track Cycling Championship 2022

  12. 'Give us one or two years and you go see wats up' - Davido

  13. Buhari react as Ademola Adeleke win for Osun govnorship election

  14. Five tins you fit no sabi about Ademola Adeleke

  15. How Adeleke win Osun govnorship election

  16. Ademola Adeleke win Osun govnorship election

  17. Adeleke clinch 17 out of 30 local goment areas for Osun govnorship election

  18. Adeleke clinch 17 out of 30 local goment areas for Osun govnorship election

  19. How dog help to catch ogbonge Mexican drug lord Quintero

  20. 'Dem see credit card details wey no be Naira Marley own for im phone' - EFCC