Commonwealth games 2022 open for Birmingham with style

Live updates from Nigeria, Africa and across di world.

Live Coverage

  1. Buhari hail Super Falcons afta dia qualification for 2023 Women's World Cup

    Buhari hail Super Falcons for 2023 qualifying for Women's World Cup

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Nigeria President Muhammadu Buhari don hail di Super Falcons for qualifying for di 2023 Women’s World Cup.

    Di Super Falcons qualify afta dem beat Cameroon 1-0 yesterday for di quarter final of di Women African Cup of Nations for Morocco.

    Wit dat win, di Nigeria women team also advance to di semi finals of di Wafcon tournament.

    President Buhari congratulatory message dey inside statement wey im special adviser on Media and Publicity Femi Adesina release.

    Di president assure di team and dia coach say Nigeria dey stand wit dem and go continue to to cheer dem until di final whistle for Morocco.

  2. ‘I no get eyes to see wife wey I just marry’

  3. Dem rescue stranded migrants for Nigerien desert

    Dem rescue stranded migrants for Nigerien desert

    Di United Nations say authorities rescue 44 West African migrants last week for northern Niger while dem dey try to enta Libya.

    International Organisation for Migration say dem dey stranded for di desert for two days afta dia vehicle break down.

    Dem find di 29 men,12 women and three girls near di town of Dirkou, for north-eastern Niger.

    For late June, di military for Niger say dem find di bodi of 10 migrants near di Libyan border.

    Many West African migrants try to reach Europe through Libya and di Mediterranean Sea.

    Many reports dey say pipo dey go through abuse for Libya detention centres and smuggling gangs dey abandon migrants in di desert.

  4. Kenya lose bid to host 2025 World Athletics Championships

    Kenya lose bid to host 2025 World Athletics Championships

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Kenyan athletes don dominate middle- and long-distance races for decades

    Tokyo go be di host of di 2025 World Athletics Championships afta dem beat competition from Kenya, Poland and Singapore.

    Di World Athletics President Sebastian Coe announce di decision and im say Tokyo offer very strong bid among extremely strong field of candidates.

    Dem make di announcement on di eve of di opening of di 2022 Championships for US state of Oregon.

    Last year, Tokyo host delayed Olympics games behind closed doors sake of di coronavirus pandemic.

  5. Who be Ivana Trump, Donald Trump first wife wey die at di age of 73 ?

  6. Sri Lanka political dynasty don end as Rajapaksa resign

    Sri Lanka political dynasty don end as Rajapaksa resign

    Wia dis foto come from, Reuters

    Sri Lanka parliament don accept di resignation of President Gotabaya Rajapaksa, and dis don end di nearly 20 years rule by im family.

    Oga Rajapaksa resign afta im run komot from di kontri wen im pipo protest against am.

    Sri Lanka dey currently experience economic kasala as dem dey face shortage of food, fuel and oda basic supplies.

    Oga Rajapaksa resignation don make way for di kontri to begin di process of electing a new president.

    Sri Lanka speaker of parliament, Mahinda Yapa Abeywardena tok on Friday say e don accept Oga Rajapaksa resignation, wey im receive late on Thursday.

    E don call for parliament to meet on Saturday to start di process of electing a new leader. Authorities don swear in PM Ranil Wickremesinghe as acting president.

    Parliament get up to a month to elect a new leader, wey fit be Oga Wickremesinghe.

  7. De Jong no wan join Man Utd, Munich and Madrid dey eye Ronaldo - Friday football tori

  8. Togo army tok sorry for killing seven teenagers

    Togo army tok sorry for killing seven teenagers

    Wia dis foto come from, AFP

    Togo Army don tok sorry for killing seven teenagers on Saturday night afta dem mistake dem for jihadists.

    For one statement, di army chief, Dadja Maganawe, say di army attack di group wit aircraft during night patrol.

    All di victims dey between 14 and 18 years.

    Media for di northern Savanes region report say di teenagers dey on dia way home from celebrating di Muslim holiday Eid al-Adha wen e happun.

    Di Togolese army bin dey on high alert afta di kontri first deadly militant attack in May, wen eight sojas lose dia lives near di border wit Burkina Faso.

  9. All you suppose know about Osun govnorship election 2022

  10. 'My 20 million fans go support me'

    Funke Akindele

    Wia dis foto come from, FUNKE AKINDELE

    Di deputy govnorship candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) for Lagos, popular Nollywood actor Funke Akindele don say her 20 million fans go support her political career.

    Di popular actress make di statement wen she appear on Channels TV programme on Thursday night..

    Akindele say she become member of di party three months ago and she dey run for deputy govnor sake of say she wan beta di lives of Lagos pipo.

    Akindele get ova 15 million fans for Instagram and ova 1 million fans on Twitter.

    She say wen di PDP govnorship candidate Abdulazeez Olajide Adediran call am to be im running mate, she accept immediately sake of say dis na wetin she always want to do.

    “Dis na wetin I dey always want. And I also don tire wit di way tins dey go on for Lagos,” she tok.

  11. Una good morning!

    Una welcome to our live updates.

    Na here you go get di latest from across Nigeria, Africa and di world.

    Stay wit us.

  12. Rabiu Kwankwaso pick Bishop Idahosa as running mate for 2023 vote

  13. Ghana teachers, public sector workers call off nationwide strike

  14. Una bye-bye!

    E don do for today live tori!

    Make e be, so join us again on Friday by 9:00AM

  15. Nigeria, Ghana, 14 odas compete for Africa Track Cycling title, South Africa top table afta Day 1

      • Author, Tamara Ebiwei
      • Role, BBC News Pidgin
    BBC
    Wetin we call dis foto, Tombrapa Grikpa wey dey represent Team Nigeria

    South Africa dey ontop di medal table of di 4th Africa Track Cycling Championship wey Nigeria dey host.

    Di tournament dey take place for di Velodrome, inside di Moshood Abiola National Stadium, Abuja, di kontri capital.

    15 kontris dey participate for dis championship wia dem go gada points wey go qualify dem for 2024 Olympics.

    Di kontris wey dey compete na South Africa, Algeria, Morocco, Togo, Benin Republic, Tunisia, Egypt, Rwanda, Burundi, Zimbabwe, Ghana, Burkina Faso, Guinea and host Nigeria.

    President of di Cycling Federation of Nigeria, Giandomenico Massari beg goment to dey invest for sports.

    Massari want special investment on on Cycling as dem dey hope to qualify for di 2024 Olympics for France.

    Dis na di second time Nigeria dey host di African Championship.

    Di competition go end on Sunday 17 July, 2022.

    BBC
    Wetin we call dis foto, Women's race
    BBC
    BBC
    Wetin we call dis foto, Team South Africa
    BBC
    BBC
    Wetin we call dis foto, Giandomenico Massari, President, Cycling Federation of Nigeria
    BBC
    Wetin we call dis foto, Waghih Azaam, Vice President, International Cycling Union
    BBC
    BBC
    BBC
    Wetin we call dis foto, Team Egypt
    BBC
    Wetin we call dis foto, Team Togo
    BBC
    Wetin we call dis foto, Team Benin Republic
  16. Cameroon 0-1 Nigeria - Wafcon 2022 quarter final match report

  17. President Rajapaska don resign afta e run from Sri Lanka - What next?

  18. Political party rally make pipo stranded for Osogbo

      • Author, Victor Ezeama
      • Role, BBC Pidgin

    Political party rally make pipo stranded for OsogboPipo don dey stranded for Osogbo, di Osun state capital sake of heavy traffic of di South western state.

    Na di final campaign rally of di People's Democratic Party (PDP) cause di traffic wey federal road safety officials dey try control.

    Di Independent National Electoral Commission (Inec) go on Satuday 16 July hold di governorship election for Osun state.

    Today na di final day of rally for all political parties wey dey participate for di elections.

    Di PDP claim say dem bin plan to hold dia rally for di stadium for Osogbo but di state goment deny dem approval. BBC Pidgin no fit verify dat claim.

    Di opposition party say dis na why dem decide to do di rally for main road - Biket area of Osogbo wey lead to oda states for di kontri.

    Di traffic don make passengers dey use leg waka to reach wia dem dey go. Police and oda security agents dey to help di road safety officials.

  19. Osun Guber Election: Inec share sensitive materials, say 76 percent voters don collect PVCs

    Pesin carry box

    Wia dis foto come from, Jelilat Olawale/BBC

    Di Independent National Electoral commission Inec don distribute di sensitive materials wey dem go use for di July 16 gubernatorial election for di state.

    Di state resident electoral commission, Prof Ganiy Raji wey oversee di distribution for di presence of party agents and security officers say di commission go dey transparents wit di process.

    Di distributed sensitive materials wey include ballots papers and result sheets dey go to all di 30 local goments areas of di state.

    Prof Raji dem don already share di non sensitive materials wey include ballot boxes, BVas, among odas to di RACs for onward distribution to polling unit on di of di election.

    Earlier for one interview wey e grant BBC Pidgin, Prof Raji tok say about 76% prospective voters don collect dia pvc wey e tok say show say pipo don ready wella to vote for di election.

    Di INEC oga for di state say im dey optimistic say di July 16 election go dey conclusive unlike wetin happun for 2018 governorship election wey dey dem declare inconclusive.

    Na 15 candidates go participate for di Saturday election.

    Gboyega Oyetola, di incumbent govnor na im dey represent di APC while Senator Ademola Adeleke dey rep PDP.

  20. ECOWAS Court declare Buhari Twitter ban unlawful, make e no repeat am