Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Una goodnight!

    Na here we go march break today ontop our live coverage of di coronavirus and how e dey affect di world.

    Abeg make una scroll down for Sunday tori dem.

    We go leave una with dis photo from Aso Rock, wia Nigeria President Muhammadu Buhari meet with di kontri Covid-19 taskforce.

    Covid-19 taskforce dey brief Buhari

    Wia dis foto come from, Nigeria presidency

  2. Kaduna state goment relax lockdown rules

    Kaduna state goment don adjust to Wednesday and Thursday di two-day window wia di restriction of movement dey relaxed.

    Residents go dey free to visit dia neighbourhood markets on 20th and 21st May 2020 to buy food and oda essentials according to di statement from goment.

    Di statement also add say no market go open next Saturday.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    As at Saturday 16, May, Kaduna get 138 confam cases of coronavirus.

  3. How Cross River Covid-19 taskforce stop couple wey dey wed, arrest pastor for Calabar

  4. Nigeria seize UK aircraft wey conduct 'illegal commercial flight'

  5. Madagascar don record dia first coronavirus death

    Pipo for street for Madagascar

    Wia dis foto come from, AFP

    Madagascar don record dia first coronavirus death, according to one official announcement wey dem do for television.

    Di 57-year-old medical worker wey die on Saturday, bin dey suffer from diabetes and high blood pressure, Reuters news agency wey report di tori quote di statement.

    Di President of Madagascar, Andry Rajoelina, dey promote one herbal tonic as treatment for Covid-19, wey several African kontries don already collect.

    Di World Health Organization don warn against di use of medicine wey dem never test.

    Madagascar get 304 confam cases of di virus, according to AFP news agency.

  6. Obama yab Trump twice in few days for im respond to coronavirus

  7. Use dis fotos from Bundesliga learn wetin football new reality look like

  8. Some of di Nigerians wey dem bring back from Dubai don catch COVID-19

    Some Nigerians wey goment carry come from Dubai don test positive for coronavirus.

    Na three of dem get di COVID-19 virus afta dem do test, according to Professor Akin Abayomi, di Lagos state Commissioner of Health

    Health authorities don carri di patients go Lagos Covid- 19 care centre for treatment.

    Oga Abayomi encourage pipo wey dey live for di state, especially dos wey dey land di kontri from obodo oyinbo make dem cooperate wit di Covid- 19 response team.

    Prof. Akin Abayomi

    Wia dis foto come from, Prof. Akin Abayomi/TWITTER

    Wetin we call dis foto, Lagos Health Commissioner Prof. Akin Abayomi
    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2

    End of X post, 2

  9. Dis group of 70 pipo bone lockdown say self isolation don tire dem

      • Author, Annette Arotiba
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
    Officers take foto of di group as dem comot di place

    Wia dis foto come from, @TELFORDCOPS

    Wetin we call dis foto, Officers take foto of di group as dem comot di place

    West Mercia Police for England don scata one group of 70 pipo wey gada do party for Granville Country Park for Telford, Shropshire.

    Di group disobey di lockdown rule, tell police say self-isolation don dey make dem sick.

    One police official tok say dem don work sotey and sacrifice so much, yet dis group no count any of dia effort.

    Di police say dem dey shocked say pipo no even care.

    Although England don dey relax some of dia lockdown restrictions but goment advise say make plenty pipo no too gada except wit dia family members only.

    Goment warn say di coronavirus infection rate go increase if pipo break di rules.

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

  10. See six important tins Gov Wike suppose reconsider before di next Rivers lockdown

  11. Rivers Lockdown go return by 8PM on Sunday

      • Author, Daniel Semeniworima
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
    Govnor Wike

    Wia dis foto come from, RVGH

    Except anytin change last minute, di total lockdown for di main bizness district inside oil rich Rivers State go return by 8PM on Sunday until further notice.

    Govnor Nyesom Wike na im give di order on Wednesday 13 May, 2020 afta e bin allow for six days break from di first total lockdown for di southern Nigeria state wey begin on Thursday 7 May till Monday 11 May.

    Dis restriction order go mainly affect Port Harcourt City and Obio Akpor Local Goment Areas wey be di two LGAs wey get more population out of a total of 23 local goment areas inside di oil rich state.

    Di total lockdown na to stop di spead of coronavirus insde Rivers State wey don record 35 cases of COVID-19 disease infection.

    BBC Pidgin Picpost on Rivers lockdown
  12. Kenya extend nationwide overnight curfew, close Tanzania and Somalia border

      • Author, Annette Arotiba
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
    Compulsory testing for di border wit Uganda don already cause long queues

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Compulsory testing for di border wit Uganda don already cause long queues

    Kenya President Uhuru Kenyatta don order di closure of land border wey dem share wit Tanzania and Somalia except for trucks wey dey carri goods.

    Presido Kenyatta order take effect from Saturday midnight.

    Di Kenyan leadet tok say e don become by force alia compulsory to do coronavirus test for drivers for border posts.

    78 truck drivers na im test positive to di virus last week and dem no allow dem enta di kontri.

    Long queues na im dey between Uganda and Kenya border now, wia compulsory COVID-19 test don begin.

    E dey quick and easy for dem to sabi lorry drivers wey dey at high risk sake of dia experience and knowledge on how dem handle HIV/AIDS.

    President Uhuru Kenyatta also don extend di nationwide overnight curfew and ban on all movement in and out of plenty towns and cities including di capital, Nairobi.

  13. Dis U.S based Nigerian doctor dey use Igbo worship songs ginger COVID-19 patients

  14. Una Good Moring!

    Welcome to Sunday 17 May, 2020 tori dem as e dey hot ontop coronavirus

    We go begin wit today proverb:"Apple of your eye fit get pesin wey don chop am for back."

    If you sabi di meaning just enta awa social media platforms -BBC News Pidgin - for Facebook, Instagram and Twitter to interprete am.

    BBC Pidgin Proverb

    Wia dis foto come from, Getty Images

  15. Breaking, Ghana confirmed cases of COVID-19 don catch 5735 pipo

    Ghana confirmed cases of COVID-19 don catch 5735 pipo

    Wia dis foto come from, Ministry of Information

    Ghana confirmed cases of COVID-19 don catch 5735 pipo.

    According to latest informate about di coronavirus infections wey drop from Ghanaian authorities early Sunday morning, na 29 deaths di West African kontri don record so far wit 1754 recorveries

    For di break down, na di Greater Accra Region still get di highest COVID-19 infections for Ghana, with 4314 cases.

    Ghana confirmed cases of COVID-19 don catch 5735 pipo

    Wia dis foto come from, Ministry of Information - GH

  16. We go march break here!

    Na here we go stop Saturday tori dem as e concern Coronavirus tori dem.

    Sunday 17 May, 2020 we go show again!

    Make we leave una dis night wit dis follow-along 5-minute African Dance workout with Kukuwa Fitness video.

  17. Double joy from Lagos Coronavirus palava

    Double joy from Lagos Coronavirus palava

    Wia dis foto come from, LSG/Twitter

    Na double joy Lagos, Nigeria commercial centre record ontop dis coronavirus palava on Saturday, 16 May.

    Doctors deliver baby of COVID-19 patient for di Gbagada isolation centre inside Lagos mainland.

    Lagos State discharge 67 COVID-19 patients, including two Indians and one Chinese national

  18. Doctors declare dis politician dead but family say na lie, e go spiritual retreat

  19. No post Covid-19 air travel guidelines for Nigeria

    Nigeria Airport Authority FAAN don deny say dem don release any post Covid-19 air travel guidelines.

    For statement FAAN say dem still dey work on di guidelines and go release am for di normal official channels.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  20. Buhari give condition before Nigerians fit use Madagascar covid-organics tonic