Children fit spread coronavirus if schools reopen?
All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.
Live Coverage
Daniel Semeniworima
COVID-19 Live updates from Ghana wit 173 new cases today
Article Information - Author, Daniel Semeniworima
- Role, BBC Pidgin, Lagos
COVID-19 Live updates from Ghana: Minister say dem no request for Madagascar herbal tonic.
Information Minister Kojo Oppong Nkrumah clear di mata on Thursday morning wen authorities brief Ghanians on coronavirus.
Oga Nkrumah also tok say goment no dey plan to re-open schools soon.
Oda goment officials take time out to address oda issues like:
-Update on case count and case management
- Dynamics of the virus in Ghana-Confronting stigma-Update on Corona virus Alleviation Program, Business Support Scheme
Facebook go begin take down fake news on coronavirus
Article Information - Author, Olaronke Alo
- Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

Wia dis foto come from, Getty Images
Facebook founder and CEO Mark Zuckerberg bin dey follow BBC tok on how social network dey resond to di challenges wey coronavirus don cause.
E bin get serious concern about misinformate wey dey spread on di platform during dis pandemic.
“Things like make pipo dey say something na proven cure for di virus and e no be am, we go take down di post.” He tok.
He even add am say fake post wey dey give pipo wrong informate about 5G dem go take am down.
As di global outbreak start, di World health organisation bin warn of “infodemic” of fake news wey dem dey spread online.
173 new Covid-19 cases push Ghana total go 6,269
Article Information - Author, Favour Nunoo
- Role, BBC Pidgin

Wia dis foto come from, Ghana Ministry of Health
Newly confirmed 173 Covid-19 cases for Ghana push de country total go 6,269.
Ghana Health Service (GHS) official data dey show say 125 patients also recover from de disease which take total to 1,898 recoveries.
See regional distribution of covid-19’cases for Ghana
Greater Accra Region – 4,582
Ashanti Region – 921
Central Region – 285
Western Region – 170
Eastern Region – 106
Western North Region – 57
Volta Region – 41
Northern Region – 31
Oti Region – 26
Upper East Region – 26
Two-day-old baby die from coronavirus
Article Information - Author, Olaronke Alo
- Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

Wia dis foto come from, AFP
One two-day-old baby don become di youngest victim of coronavirus for South Africa afta dem born am premature to one woman wey e test positive to coronavirus.
Dis na di first new born to die from di virus. Health Minister Zweli Mkhize say di premature baby get lung problems and e need ventilation immediately dem born am.
“Di mother bin test positive for Covid-19 and di child come test positive for COVID-19 as well. E dey important to appreciate how complex of di condition wey come with premature babies,” he tok on Wednesday.
South Africa, get di highest coronavirus infections for Africa, dem report 27 new deaths wey bring di total number of pipo wey don die from di virus to 339.
Dem announce 803 new coronavirus cases on Wednesday evening and e carry di total number of confam cases for di kontri to 18,003 and 8,950 pipo don recover.
Corona or no corona, BBNaija wan return - See how you fit sidon for your house do audition for Nigeria biggest reality TV show
10 new rules pipo must obey afta Gov Wike relax Port Harcourt lockdown
Una goodnight!
Na here we go march break today on top our live coverage of di coronavirus and how e affect di world.
No forget to scroll down for Wednesday tori dem.
We go leave una with dis cartoon wey NCDC bin put for dia twitter page.
Make una remember to dey wash una hands. Covid-19 dey real.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Wike don relax lockdown for Port Harcourt, Obio Akpor - See wetin you suppose know
As Nigerians dey find herb wey go cure Covid-19, NAFDAC go test four made in Nigeria remedies
Hydroxychloroquine fit protect you from Covid-19?
in case you just dey join us...
Dis na di latest tori from across di world ontop how coronavirus dey cause palavakh
- PM Boris Johnson say UK go get "world-beating" tracing system from June.
- Di number of pipo for Brazil wey don die from Covid-19 jump by 1,179 – dis na daily record.
- Mask-wearing na by force inside and outside wia social-distancing no dey possible.
- Kenya send back 182 foreigners with virus to Tanzania.
- World Bank dey warn say more dan 60million more pipo fit "poor well-well"
- Di number of confirmed cases worldwide don reach 4.9m, with almost 325,000 deaths
Kano don release guideline for Friday prayer and Sunday church service

Wia dis foto come from, Abubakar Ibrahim
Kano govnor Abdullahi Ganduje meet with Friday mosques imam and pastors on Wednesday to tok to dem about di guidelines wey dem must follow as dem open dia houses of worship.
Di northwestern Nigeria state govnor also share face masks to di religious leaders and papers wey get information about coronavirus wey dem go share to dia followers.
“Before we decide to close places of worship we consult una first and now wey we decide to open dem na una we still call.” Dis na wetin Gov Ganduje tell di imams and pastors.
“Anybody wey wan enter place of worship must wear face mask and we go provide water, soap and hand sanitizer for every entrance.”
Kano get 842 cases of coronavirus and 32 pipo don die from di disease.
See some crazy tins footballers do wey break lockdown rule
Latest Chinese cases suggest say coronavirus fit dey change

Wia dis foto come from, Reuters
Experts for China say di Covid-19 patients wey dem dey see for north-east of the kontri dey show "different symptoms" and need "longer incubation" than those for di central city of Wuhan wey di outbreak for begin.
Qiu Haibo, wey be one of di kontri top critical care doctors inside di National Health Commission top medical team, tok for national CCTV-13 news channel about di fresh observations wey im team dey make.
Dr Qiu tok say im team dey see say new cases for north-eastern Heilongjiang and Jilin provinces get longer incubation period, and dia clinical symptoms no dey typical.
Dem no get fever, e tok, but dem dey suffer from either fatigue or sore throat. Some no get any symptoms at all.
E add say di new cases appear to dey carry di virus for much longer.
According to di national Global Times newspaper, "tests on Wuhan patients normally dey come back negative within one week or at most two weeks" afta patient show symptoms.
But now, even though di cases dey curable, e be like say pipo dey carry di virus for "longer periods".
According to di official Xinhua news agency, 25 pipo currently dey receive treatment for hospital inside north-eastern Jilin.
Heilongjiang province discharge dia last patient on Saturday.
'Make Nigerians prepare for di worst on coronavirus'
NAFDAC don begin process to test four made in Nigeria remedies for COVID-19
Article Information - Author, Olaronke Alo
- Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

Wia dis foto come from, NAFDAC
National Agency for Food Drugs and Administration Control (NAFDAC) say dem don begin work on four coronavirus remedy drugs for Nigeria
Di Director-General of di Food and Drugs Control ageny, Prof. Mojisola Adeyeye tok am for interview with tori pipo for BCOS TV on Tuesday.
Skip X postAllow X content?Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
“We bin call on pipo to submit their application for COVID-19 related medicine and we don get about three or four wey we dey chook eye and dem don begin process di drugs and we go expedite di approvals.” She tok.
Prof. Mojisola say she bin advice goment make dem no bother do clinical trial for Madagascar herbal remedy-wey dem claim say e fit cure coronavirus-.for di kontri.
Her reason be say some of di ingredients wey dey di herbal drugs na wetin dem fit see for Nigeria and e mean say we never pay correct attention to wetin di kontri get.
Di Director General of NAFDAC also tok say instead make goment spend plenty moni to get di COVID Organic from Madagascar, she go prefer make dem spend di moni on herbal remedies wey dem produce for Nigeria.
60 million pipo fit enta extreme poverty
Article Information - Author, Ogechi Obidiebube
- Role, BBC Pidgin, Lagos

Wia dis foto come from, Getty Images
Coronavirus fit push up to 60 million pipo to enta extreme poverty, World Bank dey warn.
Global economic growth fit reduce by 5% dis year as kontries dey battle wit di pandemic, David Malpass, di Presido of World Bank tok.
Di pandemic don alredi make millions of pipo jobless and businesses dey fail.
"Our estimate na say up to 60 million pipo go enta extreme poverty - dis one go dabaru all di progress wey we don make for di past three years," Oga Malpass warn.
Ghana don cross six thousand cases of COVID-19 infections
Article Information - Author, Favour Nunoo
- Role, BBC Pidgin

Wia dis foto come from, Ghana Information Ministry
Wetin we call dis foto, President of Ghana Nana Akufo-Addo Ghana Health Service data wey dem publish on Wednesday reveal say de case count hit 6,096.
So far 19 new people recover from de virus which dey take de total recoveries go 1,773.
Greater Accra Region dey remain de epicentre of infections for Ghana with 4,536 cases.
Meanwhile, Ashanti Region cases see sharp rise to 888 cases after major infections for mining town, Obuasi.
Number of people wey die still dey at 31 since de last update.

Wia dis foto come from, Ghana Ministry of Health
Una Good Moring!




