Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. WHO say 250m Africans fit catch coronavirus within one year

    WHO study dey reason say up to 190,000 Africans fit die sake of Covid- 19

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, WHO study dey reason say up to 190,000 Africans fit die sake of Covid- 19

    Scientists for di World Health Organization say close to quarter of one billion pipo for Africa fit catch coronavirus in a year.

    For dia study wey dem publish for BMJ Global Health, dem tok say Africans wey go die sake of Covid- 19 fit dey between 150,000 and 190,000.

    Di study say 5.5 million pipo go need hospital treatment, but even now di continent still dey struggle to treat malaria, tuberculosis and HIV.

    Coronavirus no quick spread for Africa but now, pipo wey don catch di virus for internally displaced persons camp for South Sudan don many.

  2. Children fit spread coronavirus if schools reopen?

  3. Una good morning!

    Welcome to our live coverage ontop coronavirus and how e dey affect di world.

    But first make dis proverb ginger una.

    Proverb

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Proverb
  4. How coronavirus di affect Anglophone IDPs for Yaounde

  5. Una Goodnight!

    Na for here we go gbab break with our today live coverage ontop coronavirus and how e dey affect di world.

    No forget to scroll down for today tori dem and no also forget to join us tomorrow.

    But before we go, make we leave you with dis NCDC new info if you need to ask questions about coronavirus.

    Make you dey remember to wash your hands.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  6. "Allowing Muslims di chance to pray on Friday to God fit heal coronavirus in no time"

  7. Kano launch female only isolation centre

    Di govnor for di launching

    Govnor Abdullahi Ganduje of Kano for northwestern Nigeria on Thursday launch isolation centre wey go take only female covid-19 patients for di state.

    Di isolation centre wey dey Nasarawa local goment for di state go fit hold 100 patients wey catch coronavirus.

    Govnor Ganduje for di launch warn di staff to always try dia best so dat e no go hear any complain from di patients wey go come.

    At di moment Kano state get 707 cases of coronavirus, dem don discharge 79 pipo and 33 don die.

  8. Wetin community spread mean?

  9. Nigeria dey plan to employ 774,000 jobless Nigerian youths afta Covid-19

    Nigeria Presidency don announce plan to employ 774,000 jobless youths for short term work in different sectors like rural infrastructure, extension services, environmental sanitation and odas.

    Dis na part of wetin federal goment say dem dey plan to do afta Covid-19.

    Inside statement wey di State House release today, President Muhammadu Buhari go employ 1000 youths per local goment area for di kontri.

  10. Only exam classes go start school for June as Covid -19 cases di increase

    PM di ope national dialogue

    Cameroon Prime Minister, Joseph Dion Ngute don say schools go start for school pikin dem for exam classes for primary and secondary school only for June 1.

    Na de decision weh e komot for tele conference meeting weh Prime Minister di hold wit e ministers every week.

    Dis mean say pikin dem weh deh no dey for exam class go remain for house till new school year.

    Goment don set date for all de exams and de new school year go start for October 5, for primary and secondary school and universities go start for October 15.

    Parents deh go get for give face masks even as goment go also take oda measures for fight Covid-19 for schools.

    Just now Cameroon don confirm 2800 cases for Covid-19, 1121 of dem bi active, 1543 pipo don recover, 139 don die.

    For Foumban West region de cases di da so increase and health authorities di call population for join dis fight against Covid-19.

  11. Nigeria set up economic team as coronavirus dey worry

    Nigeria don set up economic team to check how di coronavirus pandemic dey affect di economy.

    Di Minister of Finance, Budget and National Planning n aim go lead di team.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    Di Economic Sustainability Committee wey di kontri Vice President, Prof. Yemi Osinbajo dey lead go help explain how di economy go take shape after coronavirus.

    Dem go also chook eye for di 2020-2022 Medium Term Expenditure Framework and dem do alredi revise di 2020 Budget as di pandemic really worry.

  12. India president go bone 30% of im salary for one year

    India President Ram Nath Kovind go bone 30% of im salary for one year and im go also reduce spending ontop travel and party to increase di funding for di fight against coronavirus.

    Apart from domestic waka, tins wey dem go chop during ceremonies within di kontri and state party go only get small guest list.

    Prime Minister Narendra Modi bin announce on Monday, 11 May say dem go share moni to help businesses, farmers and labourers during di nationwide lockdown and increase economic activity. Im stress say India go need to dey depend on diasef.

    So far, India don report 78,003 cases of Covid-19 including 2,549 deaths, according to di Ministry of Health and Family Welfare.

  13. India president salary go reduce by 30% sake of Coronavirus, President Ram Nath Kovind go fight against the coronavirus outbreak

    President Ram Nath Kovind go collect only 60% of im normal salary so that di kontri go fit use di remaining fight coronavirus, local tori pipo dey report.

    Oga Kovind say ontop dis one, im go reduce waka-waka by plane and jolly-jolly ceremonies dem, say im dey lead by example with dis action.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    For April, di goment decide say lawmakers and ministers salary sef go reduce by 30% for one year, including for Prime Minister Narendra Modi.

    Di kontri currently dey on total lockdown and although some economic activities dey allowed for some areas, major economic problems and unemployment don boku.

    India so far report over 78,000 cases of Covid-19, including 2,549 deaths, according to the Ministry of Health and Family Welfare.

  14. Africa players to watch as Bundesliga dey return dis weekend

  15. Coronavirus: Cuban doctors in SA ready for posting

    US bin don criticise di arrival of di doctors

    Wia dis foto come from, Getty Images

    More than 200 doctors from Cuba don finish dia mandatory quarantine for Pretoria, capital of South Africa and dem readi to begin work for di kontri.

    Dem arrive Johannesburg, on 26 April, and dem put di team under compulsory two-week quarantine for on hotel for Pretoria, local tori pipo tok.

    On Thursday, for Cuban embassy website statement, dem say dia quarantine don end and dem ready to do di "difficult task".

    Di US bin don criticise South Africa for accepting di doctors and bin accuse Cuba of making moni from di pandemic - but Cuba don deny di allegation.

    Some South Africans don also criticise di move. Dem tok say di kontri for hire local doctors instead.

  16. Ghana coronavirus case rise to 5,530

    Coronavirus case for Ghana

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Coronavirus case for Ghana

    Ghana covid-19 cases don enta 5,530 dis Thursday according to di kontri health authorities.

    Di number of pipo wey don die don increase to 24 from di 22 wey e be before and patients wey don recover from di virus na 674.

    Health authorities tok say na community transmission dey increase di number of infections, dem advise make pipo follow di safety protocols.

  17. 98-year-old woman recover from coronavirus for Lagos

    Govnor Babajide Sanwo-olu
    Wetin we call dis foto, Lagos State Govnor Babajide Sanwo-olu

    Lagos state goment say dem don discharge one 98-years-old woman from dia isolation centre.

    Govnor Babajide Sanwo-olu reveal dis one for e tiwtter handle as im tok say di woman "na di state oldest covid-19 patient".

    Di woman dey part of 25 pipo wey dem discharge from dia isolation centre on Wednesday 13 May.

    Lagos State na di most affected state for Nigeria with coronavirus as dem don record 2041 cases according to di Nigeria Centre for Disease Control.

    But govnor Sanwo-olu add say dem don discharge 528 pipo wey dem don “successfully manage” dia sickness.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  18. Lagos state wan lockdown again? See wetin we know

  19. 'Rivers State get 10 new covid-19 cases, not 16’

    Small confusion bin comot for Rivers State after Nigeria Centre for Disease Control, NCDC, for dia daily coronavirus update say di state get 10 new cases.

    Governor Nyesom Wike for state broadcast bin say di state record 16 new cases on Wednesday 16 May, 2020

    But di Rivers State Public Health Emergency Operations Centre (PHEOC) don clarify di mata say na 10 new cases na im dey di state as NCDC bin announce.

    For tweet dem explain say 6 retests wey dem do for pesins wey already dey on admission come back positive so na 25 active dey di State.

    Dis mean say di total cases of coronavirus wey di State don record na 33 and out of dat number, 25 dey active, five don recover and dem don discharge dem. Three pesins don die.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  20. Coronavirus don kill 2,410 pipo for Africa

    Coronavirus data for Africa

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Coronavirus data for Africa

    African Union Centre for Disease Control and Prevention say coronavirus pandemic don kill 2,410 pipo for Africa and pipo wey don catch di infection don reach 69,947.

    Even wit dis high numbers, many African kontris don dey relax di lockdown wey dem put in place to check di spread of di disease.

    One popular Congolese gynaecologist and Nobel laureate Denis Mukwege dey worry say di continent still neva reach di worst of di infections.

    Schools for Niger, Cameroon and South Africa dey ready to re-open, South Sudan authorities say pipo fit go back work.

    Even thouhh Ghana now don get more dan 5, 000 cases and domestic flights and oda commercial activities don resume for di kontri.

    But most African kontris still dey enforce compulsory social distancing and di wearing of face masks for public places.