Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Updates from Nigeria and di rest of Africa

    • Nigeria coronavirus cases don pass 5,000. NCDC say di total number of confamed cases tanda for 5,445.
    • Lagos state get 2,278 cases of Covid- 19, di highest for di kontri while Anambra and Yobe states get two cases each, di lowest for di kontri.
    • NCDC don tok sorry give Plateau and Akwa Ibom states goments afta dem make mistake for di states Covid - 19 test results.
    • Nigeria goment don evacuate 620 Nigerians wey hook for obodo oyinbo sake of coronavirus.
    • One patient for Eritrea don recover fully from coronavius afta im test result come back negative.
    • Di number of Covid-19 recoveries for Ghana shoot up big time as 1,460 people recover, according to di Ghana Health Service.
  2. 'Blood clots' dey develop for patients wey dey seriously sick wit coronavirus

    Up to 30% of patients wey coronavirus hook well-well dey develop dangerous blood clots according to medical experts.

    Di clots wey dem also call thrombosis fit dey contribute to di number of pipo wey dey die.

    Patients for all over di world dey affected by many medical complications from di virus, some of which dey very deadly.

    Di virus don also increase cases of deep vein thrombosis - blood clots wey dey usually dey for leg. E fit become mata of life and death when di fragments break, enta di body go di lungs, e go block di blood vessels.

  3. Eritrea declare say coronavirus no dey dia kontri again

    Eritrea presido Isaias Afwerki

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Eritrea presido Isaias Afwerki don dey power since 1993

    One patient for Eritrea don recover fully from coronavius afta im test result come back negative.

    Dis wan go make am a total of 39 confam cases wey don recover, di Eritea goment announce.

    Dis 39 cases na di total number of pipo for di kontri wey catch coronavirus and with dis 15 May report from di Ministry of Health, na im be say Eritrea dey 100% free of coronavirus.

    Also, none of di pipo wey test positive for Covid-19 die from di disease.

    For statement wey goment release, dem warn pipo not to relax on wetin don make dem achieve di record and to continue to dey follow guidelines.

    Eritrea na kontri wey dey di Horn of Africa region wey don produce famous pipo like Hollywood star Tiffany Haddish and music producer Swizz Beats.

  4. In case you just dey join us...

    Dis na di latest ontop coronaviorus from around di world

    • Di number of pipo wey dey die sake of coronavirus don dey reduce small-small for kontris wey dey Europe as dem begin dey relax dia lockdown measures. Portugal, Spain and Greece dey among di kontris wey don relax dia measures.
    • Germany wey be Europe biggest economy don enta recession afta report show say dia economy reduce by 2.2% for di first quarter of di year sake of di coronavirus pandemic.
    • Nelson Teich don become di second Brazilian Health minister to leave im job inside one month sake of quanta wit di President Jair Bolsonaro on how goment dey respond to di coronavirus outbreak.
    • President Donald Trump say US go reopen weda vaccine dey or not as im announce plan to deliver coronavirus vaccine before di year end.
    • UK goment say di kontri infection rate dey increase and e don dey near point wia di vius go dey spread well-well.
    • More than 4.5 million cases of coronavirus na im don dey di world now according to Johns Hopkins University, one third of these cases don recover.
  5. Bundesliga live matches don return - See how you fit watch am

  6. Coronavirus: Trump say US dey reopen weda vaccine dey or not

    America President Donald Trump

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, America President Donald Trump

    America Presido Donald Trump tok say weda dem see vaccine or not im must reopen di US.

    He say normal life must return to America pipo even though vaccine no dey.

    Oga Trump for one news conference on Friday announce plan to develop one coronavirus vaccine before di year end.

    Di vaccine project wey im call “Operation Warp Speed", go be like World War Two wen di kontri produce di first nuclear weapons for di world.

    He say di project go start wit di study of 14 promising vaccines. E go be di biggest scientific project wey di kontri don eva see before.

    But sabi pipo dey doubt if di vaccine fit ready inside one year.

  7. Look for lockdown 'sex partner' Netherlands advise singles

  8. Italy go lift coronavirus travel ban

    Italy relax lockdown

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Italy relax lockdown

    Italy goment don sign one decree wey go allow pipo fit travel enta and comot di kontri from 3 June as dem begin reduce di coronavirus lockdown measures.

    Dem go also gree make pipo fit travel go different states for di kontri.

    Dis move na one major step wey di goment dey take to reopen di economy afta dem lockdown for two months.

    Italy get one of di highest number of pipo wey die wit coronavirus for di world but di infection rate don dey reduce.

    More than 31,600 pipo don die wit di virus for di kontri, di third highest figure afta US and UK.

    Italy na di first kontri for Europe to impose nationwide ban wen dem begin see high cases of coronavirus for di northern regions for February.

    But dem begin relax those measures small-small wen dem allow dia factories and parks to reopen 4 May.

    Shops and restaurants go open for 18 May but dem must do compulsory social distancing.

    Catholic churches also dey prepare to resume Mass for di same day but strict social distancing go dey and worshippers must wear face masks. Oda faiths go also dey allowed to hold religious services.

  9. 1,460 Covid-19 patients don recover for Ghana, Dis latest recovery figure mean say 786 people test negative after dem go through treatment

    Facemasks wey dey for Ghana national colours

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Ghana testing ratio high pass many oda African kontries

    Di number of Covid-19 recoveries for Ghana shoot up big time as 1,460 people recover, according to di Ghana Health Service.

    Dis latest recovery figure mean say, 786 people test negative after dem go through treatment.

    Meanwhile, infection rate go up small plus 108 new cases, which push country total go 5,683.

    De country record 4 more death cases which dey peg death toll at 28.

    So far de capital, Greater Accra record de highest Covid-19 cases, with over four thousand cases, region with de least number of infections be Bono with one case.

    Check Covid-19 figures according to regions for Ghana

    Greater Accra Region – 4,248

    Ashanti Region – 798

    Central Region – 210

    Eastern Region – 99

    Western Region – 87

    Western North Region – 57

    Volta Region – 34

    Northern Region – 31

    Oti Region – 26

    Upper East Region – 26

    Upper West Region – 21

    North East Region – 2

    Bono Region – 1

    One man dey preach as woman dey waka pass for Ghana

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Ghana announce two-week lockdown for di kontri two main regions on 28 March
  10. Una good morning

    Welcome to our live coverage of di coronavirus and how e dey affect di world.

    But before we continue, make una use dis proverb start ginger una morning.

    No be one road lead to market

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, African Proverb in Pidgin from contributor
  11. Nigerian rapper Falz take us behind di scene of im life for lockdown

  12. Una good night!

    Na hia we go march break.

    Makw we leave una wit Friday episode of awa special programme COVID-19 in 60.

    We torchlight fake news palava during dis coronavirus and how to sabi am plus know wia to find correct news wey conconcern COVID-19.

    Afta you watch dis video, you fit find all di latest authentic tori wey concern coronavirus mata for BBC.

    Wetin we call dis Video, Covid-19 in 60 seconds: Fake news fact check
  13. Osagie wan find wetin dey kill for Kano State

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, BBC Pidgin, Abuja
    Osagie Ehanire

    Wia dis foto come from, Twitter

    Nigerian Minister of Health, Osagie Ehanire say medical experts from di federal goment plus di ones from Kano state don develop one forensic tools to take investigate di recent mysterious death wey happun for Kano.

    Di minister wey yarn dis one for di daily PTF briefing, say di situation for Kano don dey stabilize as both team dey cooperate plus all di labs don dey function well.

    He explain give say daily testing don go up to 350 daily.

    He praise di goment of Kano as dem open up plenti isolation and treatment centres.

    E also yarn give say di gbege between di Benue State index case Susan Okpe and di goment go soon end as she don agree to run anoda test.

    Susan don dey isolation for more than 50 days afta result for Benue state show say e get covid 19 afta she return from the UK for her mother burial.

    She claim say no be her result and since den she refuse to take anoda test until now.

    Di minister say im hope dem go release am if her result show negative.

  14. Wia di Chinese doctors wey dem send come Nigeria dey now?

      • Author, Faith Oshoko
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
    Chinese medical experts

    Wia dis foto come from, Others

    Nigeria authorities don tok say di goment no sabi wia di 15 Chinese medical sabi pipo wey land di kontri for April dey.

    Di Chinese team bin enta Nigeria to help with di fight against coronavirus.

    Infact goment officials like Health Minister Osagie Ehanire go airport to welcome dem.

    But on Thursday, Ehanire tok say dem be di guest of one Chinese construction company and no be even all of dem be doctor.

    E sha say dem don learn some tins on how dem fit manage di virus for dia kontri.

    Dis tok-tok no follow wit wetin di Information Minister Lai Mohammed tok last week wen e say di Chinese doctors dey "help our doctors tor capacity building".

    Last month di Chinese Foreign Ministry tok-tok pesin Zhao Lijian say na Nigeria goment bin ask for di sabi pipo even as di Nigerian Medical Association bin halasay no ber good idea.

  15. African kontris wey don receive Madagascar coronavirus 'cure'

  16. Wetin we sabi about di 'herb' inside Madagascar coronavirus cure

  17. How to survive lockdown wen you dey trapped with your abusive partner

  18. Bundesliga coach wey break quarantine rule to buy toothpaste go miss im team game

    Augsburg head coach Heiko Herrlich

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Augsburg head coach Heiko Herrlich

    Augsburg head coach Heiko Herrlich go miss di restart of Bundesliga sake of say im break quarantine rule as im leave im hotel to go buy toothpaste.

    Herrlich, team go face Wolfsburg on Saturday, im tell tori pipo for news conference on Thursday say im go one shop, wey break di league rules.

    Teams dey prepare for di German league to restart dis weekend and tori be say dem quarantine dem.

    "I make mistake to leave di hotel," na wetin im tok inside statement.

    Dem appoint Herrlich, wey be 48 years for March 10 and di home match with Wolfsburg suppose be im first match in charge.

  19. Wear mask or face three month jail term for Ghana

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin
    Goment advise Ghanaians to begin wear face mask for public

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Goment advise Ghanaians to begin wear face mask for public

    Ghana dey explore legal options which go make failure to wear nose masks criminal.

    After govment use law criminalize dis, e go mean say wearing nose mask go be compulsory to all persons for Ghana as part of Covid-19 personal preventive protocols.

    Govment say people wey go fail to wear nose masks in public spaces go fit go jail for up to 3 months.

    Information Minister, Kojo Oppong Nkrumah talk say “legal options dey wey we dey consider to ensure strict enforcement of personal preventive etiquette like wearing of mask.”

    “Hopefully, we go announce de legal options soon,” he add.

    President Akufo-Addo after lifting lockdown on parts of de country announce say, Ghanaians for wear nose mask if dem dey public places.

    But de directive no sheda go down plus some people who still dey walk around in public without nose masks.

    BBC Pidgin talk plus some residents of Accra who dey town but no wear nose mask.

    “I know how I dey do myself for house wey I no go get de virus. I dey wash my hands, I use hand sanitiser but nose mask wey I no wan wear,” Bernard talk BBC Pidgin.

    Ghana President Nana Akufo-Addo

    Wia dis foto come from, TWITTER/GHANA GOVERNMENT

    Wetin we call dis foto, Ghana President Nana Akufo-Addo

    Another worker for Accra, Justice who talk say “I no dey want wear nose mask sake of I no like am. Also e dey make my customers feel like I dey sick.”

    Sake of de shortage of nose masks, Ghana govment partner local garment producers who dey make nose masks locally for health sector den frontline workers.

    Govment say people go fit wear nose mask which dem make from local fabrics wey vendors dey sell or any material which dey cover dema nose dem mouth well.

    Total coronavirus cases for Ghana dey stand at 5,530, out of which 674 recover wey 22 die.

  20. 50% of pregnant women, nursing mothers and oda sick pipo for Nigeria shun goment hospital

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, BBC Pidgin, Abuja

    Di Minister of Health, Osagie Ehanire say since Nigeria impose lockdown for di kontri, di number of pregnant women, nursing mothers and oda outpatient visits to hospital for di kontri don reduce by half.

    Oga Osagie wey yarn dis one for di daily Presidential Taskforce briefing for Abuja say data from di National Health Management Information Management system show say outpatient visit drop from 4 million to about 2 million.

    Also, antenatal visit drop from 1.3 million to 655 thousand while skilled birth attendance drop from 158,374 to less than 99 thousand.

    E say dis one wey di number of pipo wey dey go hospital don reduce get im own bad effect and dat di ministry go ensure say all hospital kontinu to deliver routine services for hospital.