Nigeria junior Minister for Health, Olorunnimbe Mamora, don
tok say di goment go pay for di Madagascar herbal medicine.
Senator Mamora confam dis give BBC Pidgin wen im apear for Covid-19 Tok Your Own interview on
Tuesday.
Madagascar claim say dem don formulate one herbal medicine
wey dey cure coronavirus, according to di kontri President Andry Rajoelina.
Last week, di kontri send sample of di Covid-Organic herbal
medicine go oda African kontri and Nigeria follow carry im own for Guinea
Bissau wey di drug land.
Some local tori pipo for Nigeria dey tok say Madagascar dey
demand 170,000 Euro for Nigeria as money for di nergs wey dem send.
Even though Mamora say im no fit confam di amount wey
Nigeria go pay for di medicine, e tok say di drug no be for free dey send am
give Nigeria.
Mamora tok say Nigeria collect di drug to do solidarity for
anoda African Kontri wey dey claim say dem don find cure for coronavirus.
“Wen dem first send dis thing (Covid-Organic herbal medicine),
dem first send am to Guinea Bissau. Na dia we con collect our won consignment
wey dem bring for Nigeria. SO, di thing dey Nigeria as we dey speak.
“I no fit tell you di thing wey dem dey ask for but I no say
di thing wey dem send, no be free. We know where di consignment dey but di
amount wey em dey ask, I no fit confam am now,” na wetin Mamora tok.
For now, President Buhari don tok say im no go allow make dem give
any herbal medicine give Nigerian except dem test am.