Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Butler wey serve 11 US presidents die from coronavirus

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
    Wilson Roosevelt Jerman

    Wia dis foto come from, Courtesy of family

    One former White House butler wey don work for 11 presidents during im 50 years career don die from coronavirus at di age of 91.

    Wilson Roosevelt Jerman career start for 1957 during di president Eisenhower administration for White House.

    Di First Lady dat time come promote am, and from dat time he begin work as butler.

    For im last position, he serve as a maître d' for di Obama White House.

    "Im willingness to go above and beyond for di kontri wey im love, na legacy," Na wetin former America First Lady, Michelle Obama tok.

  2. 'Nigeria go definitely enta recession sake of COVID-19'- see wetin e mean & how e go affect you

  3. Una goodnight!

    Na here we go march break ontop our live coverage on di coronavirus palava and how e dey affect di world.

    No forget to scroll down for Thursday tori dem.

    We go see again tomorrow!

  4. Five business wey dey hammer inside dis coronavirus period

  5. ...And tori from Nigeria and other parts of Africa

    • Nigerians wey dey stranded for Thai airport since March go come back home.
    • Doctors for Lagos Nigeria on Thursday suspend dia warning strike wey dem begin on Wednesday sake of how security agencies maltreat dia members wey dey essential duty during curfew time.
    • Authorities for Ekiti State south west of Nigeria say one 75 year-old woman don die from complications from coronavirus.
    • Govment of Ghana on Thursday clarify say dem no request for de herbal medicine wey Madagascar develop as COVID-19 'cure' for testing.
    • Botswana go allow businesses and schools to reopen after dem complete dia phased easing of restrictions, but dem go follow strict rules. Di kontri dey lockdown for 48 days and dem bin start easing two weeks ago.
    • One two-day-old baby don die from coronavirus for South Africa
  6. Cameroon confirm highest Covid-19 cases, 528 for one day

      • Author, Bongben Jisi
      • Role, BBC Pidgin, Cameroon

    Cameroon Health Minister, Manaouda Malachie don announce say kontri don confirm 528 cases dis May 21.

    Dis number na one of de highest since kontri confirm first case for March 6.

    Just now kontri don confirm 4261 cases and eight pipo die today.

    Health officials say kontri pipo still need informate on how dis sick start, weti de sick bi, how e di spread and how for prevent am.

    As coronavirus di daso spread for de whole kontri , e good make kontri pipo get correct informate so dat deh go observe measures weh goment put for place.

    Wear masks for public, wash hands wit soap and running wata, keep distance wit pipo, no gada for public place and stay for house if deh no get anytin for do for outside.

    Goment say e focus na for monitor dis sick for communities, district health centres, villages and for quarters.

    Also, authorities say deh go make sure say deh follow and find de virus and test early for protect families and de kontri.

  7. If you just dey join us...dis na di latest tori from across di world

    • Millions of pipo for UK stand for dia domot dey clap for health workers sake of to dia support for dem as dem dey fight coronavirus.
    • Di number of confamed cases all ova di World since di outbreak of coronavirus don pass five million.
    • More than 328,000 pipo don die with Covid-19, and 1.9 million pipo don recover. Dis na according to data from Johns Hopkins University.
    • Scotland go reopen all schools from 11 August.
    • Greece tourist season go begin in June, and international flights to popular places go resume in July. Dis na according to di kontri prime minster. Greece don record 166 pipo wey die from coronavirus and 2,850 confam cases.
    • Di US Centers for Disease Control and Prevention (CDC) report say as e be, confam cases of coronavirus for US dey stand at 1,551,095 and di number of death done rise to 93,061.
  8. Slovaks get only 24 hours to visit dia neighbouring kontri and return

    Slovakia

    Wia dis foto come from, Reuters

    From Thursday, Slovaks fit visit eight Kontries - including four of di kontri five neighbours – dem no need show dia negative Covid-19 certificate or go into quarantine wen dem return. But dem give dem one condition: Dem gatz return back within 24 hours.

    Dia kontri pipo and legal foreign resident of Slovakia fit visit Czech Republic, Poland, Hungary, Austria, Croatia, Slovenia, Germany and Switzerland as long as dem return back dy di same time di following day.

    Prime Minister Igor Matovic say di move na to facilitate business meetings and family reunions. Those wey go take advantage of di scheme go get to fill out form for di border including di time of departure, wey di police go check wen dem return.

  9. Muslims go mark Eid-al-fitr celebration for house? Dis na wetin we know

  10. Face mask fit protect you from Covid-19?

  11. Ekiti record second Covid-19 death

    Authorities for Ekiti State south west of Nigeria say one 75 year-old woman don die from complications from coronavirus.

    Dem say di number of active cases of di virus as at May 21 for di state na five. So far 13 pipo don recover from di disease while two pipo don die.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  12. Nigerian states wey wan reopen church and mosque

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, BBC Pidgin, Abuja

    In di past few days, states like Cross River, Nasarawa and Benue states don announce say dem go begin open places of worship.

    Di Benue state goment order Churches and Mosques make dem begin dia activities from Thursday.

    Di goment make dis announcement afta di state Executive Council meeting and di committee on Covid 19 meet for goment house for Makurdi.

    Di Cross River state Governor, Prof. Ben Ayade on Wednesday also give executive order to say make churches and mosques open from Sunday, May 24, 2020.

    Di govnor for statement say im make di decision because of di spiritual economy wahala wey di covid 19 pandemic don cause.

    Di state goment explain say make all di church and mosque pipo dem wear mask plus make dem no pass di number of dia siting capacity

    Also di Nasarawa state and Adamawa state goment don join to re-open places of worship .

    But di Chairman of di Presidential Taskforce, Boss Mustapha don shake head say e dey unwise for di state goments to allow pipo to gada togeda as dat one fit spoil all di success wey dem don get in di fight against di virus.

    E say all di state must follow di guidelines and ensure say make no gathering pass 20 pipo.

    Oga Boss say as e be now, to gada pipo plenti for one place fit increase di number of coronavirus cases for di kontri as di kontri already dey community level transmission.

  13. Landlady remove roof and door from house of tenant wey dey owe rent

  14. Man Utd say coronavirus don make dem lose £28m

    Manchester United

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Manchester United say di coronavirus pandemic don make dem lose up to £28m – and dem dey expect say di final figure go dey higher.

    United reveal their third-quarter results for 31 March on Thursday.

    Chief financial officer Cliff Baty say dem go hand back £20m for TV revenue to broadcasters even if dem complete di Premier League season.

    United lose additional £8m for di final three weeks of March, wen dem postpone three of dia matches.

    Na total of 11 United matches dem don postpone because of di pandemic.

    Baty tok for conference call afta dem release di latest financial results, e explain say di Premier League television broadcasters go get £20m back from di club because of changes for dates and kick-off times sake of di pandemic.

  15. Traditional medicine, Chloroquine trial, see di latest ontop coronavirus for Lagos state

  16. Confirmed cases of coronavirus don reach five million worldwide

    Di number of pipo wey don catch coronavirus for di world don reach five million, according to informate from Johns Hopkins University.

    And di number of pipo wey di virus don kill currently stand for 328,172 deaths.

  17. Two-day-old baby die wit coronavirus for South Africa

    South Africa don record di highest number of coronavirus cases for Africa

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, South Africa don record di highest number of coronavirus cases for Africa

    One two-day-old baby don become di youngest pesin to die wit coronavirus for South Africa afta e mama wey don test positive born am prematurely.

    Dis na di kontri first death of newborn baby.

    South Africa Health Minister Zweli Mkhize say di premature baby get lung problems and require ventilation immediately afta dem born am.

    “Di mama bin test positive for Covid-19 and di pikin come later test positive for Covid-19 as well. E dey important to understand di complex nature of di underlying condition of prematurity,” na so Mkhize tok.

    South Africa wey get di highest coronavirus infections for Africa don record 18,003 covid-19 cases and 8,950 don recover.

  18. Breaking, Lagos doctors don suspend dia warning strike

      • Author, Gift Andrew
      • Role, BBC Pidgin Lagos Reporter

    Doctors for Lagos Nigeria on Thursday suspend dia warning strike wey dem begin on Wednesday sake of how security agencies maltreat dia members wey dey essential duty during curfew time.

    For statement, di joinbodi of doctors, Nigeria Medical Association NMA say police and di Lagos State goment don respond to dia demands and dem go dey monitor to ensure say dia members dey protected.

    NMA direct members to resume work by 6pm Thursday evening.

    Di doctors bin direct dia members to proceed on strike on on 20 May sake of say security men arrest and maltreat dia members during curfew time on Tuesday 19 May, 2020.

    E take di intervention of Lagos goment and police authorities to release di affected members.

    DOCTOR

    Wia dis foto come from, NCDC

  19. Ghana Minister say dem no request for Madagascar Covid-19 herbal cure

  20. Di 'new way' to attend music concert

      • Author, Ogechi Obidiebube
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
    Pipo wey dey inside moto dey watch show

    Wia dis foto come from, EPA

    As social distancing na di main tin now, some music lovers for Sydney, Australia drive go one concert wia singer Casey Donovan bin perform.

    But di surprising tin be say di fans no come down from dia moto.

    Na from inside dia moto dem stay to attend di show.

    Di singer bin perform inside heavy rain as di audience siddon inside dia cars for sports centre car park.

    Di way di audience fit listen na either dem on dia radio or whine down dia window.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post