Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Egypt doctors accuse goment for di death of dia colleagues

    Doctors wear protective gear dey treat patient for hospital

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Egypt health minister say enough equipment dey to test medical staff

    Egypt Health Minister, Hala Zayd, don order say make dem torchlight how one doctor wey catch coronavirus for duty take die as pipo dey worry say di number of health workers wey dey die don dey increase.

    Tori pipo for Egypt say di order to torchlight di death of Dr Walid Yehia na from di President Abdul Fattah al-Sisi.

    Dis dey come afta doctors union for di kontri issue statement for Monday wia dey claim say di ministry of health na dem dey responsible for di deaths of 19 doctors and more dan 350 doctors wey don catch di virus.

    Di union, di Egyptian Medical Syndicate wey dey represent plenty doctors interest tok say di whole health system fit collapse if di health ministry continue to dey neglect wetin dem suppose do and meet di needs and dem no change how dem take dey relate wit medical staff.

    Egypt don record nearly 18,000 coronavirus cases and 783 deaths according to John Hopkins University figures.

  2. Why Nigeria go continue to dey use hydroxychloroquine despite WHO advice

  3. Africa get ova 110,000 confam cases of coronavirus

    Africa get ova 110,900 confam cases of coronavirus for di continent – more dan 44,500 don recover from di disease and 3,300 don die.

    South Africa na im get di highest number of infection for di continent with 22, 583 cases and 429 deaths.

    Na Lesotho get di lowest number of cases of Covid-19 for di continent with just two cases.

    Meanwhile Nigeria get 7,839 cases with 226 death. Ghana get ova 6000 cases of infection.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  4. WHO don stop trial of hydroxychloroquine for Coronavirus treatment

      • Author, Faith Oshoko
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
    Di chloroquine drug

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Dem first make hydroxychloroquine as malaria melecine

    World Health Organisation don tok say dem dey pause di study on weda hydroxychloroquine fit be treatment option for coronavirus afta study find say e dey cause heart palpitation alias make heart dey shake.

    Dis na from study wey "The Lancet" publish on weda di drugs dey work for majority for di coronavirus cases across several kontris.

    Di former anti-malarial medication start to scarce afta American presido Doanld Trump and Brazillian presido Jair Balsonaro start to dey hype am as cure for di coronavirus wey almost make di world do standstill.

    But WHO tok say di pause on di testing of di melecine na for di main time, dem go still continue later.

  5. Mozambique don record dia fist coronavirus death

    Map of di place wia di death from

    Mozambique don report di death of a 13 year old boy wey dey from di northern province if Nampula.

    Na di National Director if Public Health Rosa Marlene confam on Monday

    Di southern Africa kontri also just confam 15 new coronavirus cases wey go bring dia total number to 209 cases.

    Di new cases include one health worker from di northern province of Cabo Delgado.

    Na why authorities now don decide say dem go test all di 5,000 health workers from di province wey don dey worst hit for dis pandemic.

  6. Uganda dey start to ease dia lockdown restrictions today

    pipo wey go against lockdown

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, Uganda don dey under strict lockdown since March

    Uganda go start to dey begin to reduce lockdown restrictions rom today as demgo dey allow private cars to dey operate and restaurants and shops dem go fit open.

    But every pesin must to wear face mask for public.

    Presido Yoweri Museveni last week bin delay di ease of restrictions so dat ppo go fit get time to get dia face mask for ground ready. E tok say goment go give am free to all citizens wey do pass di age of six for free.

    Di restrictions ngo only reduce for 945 of di kontri 135 districts an 40 of dem still get restrictions.

    Gyms and night clubs no go fit open. But dem go reduce public transort restrictions on 4 June, di same dey dem dey announce guidelines for reopening of schools.

  7. 4.2 billion for Cameroon MPs cars but respirators, PPE lack for medical workers to fight COVID-19

  8. Una goodnight!

    Na here we go march break today on top our live coverage of di coronavirus and how e affect di world.

    No forget to scroll down for Monday tori dem.

    Make una remember to dey wash una hands. Covid-19 dey real.

  9. Wen schools for Nigeria go reopen? Wetin we know

  10. Albinos for Uganda dey worry about Covid-19

    Albino pipo for Uganda say dem dey at risk of skin cancer because dem no fit comot buy sunscreen sake of coronavirus lockdown.

    Pipo wey dey live with di condition for rural areas say travel restrictions don stop dem from travelling to di capital, Kampala, to buy di cream wey dey protect dia skin.

    Tori be say e no dey always possible to avoid direct sunlight because dem gatz leave dia house to provide for dia family.

    Olive Namutebi, di head of Albinism Umbrella Association for Uganda, she say she still dey wait for goment to respond afta she don appeal for help many times.

  11. Child marriage don rise for Ethiopia as schools dey closed

  12. Coronavirus: Americans gada for beaches to flex for Memorial Day weekend

    For Missouri, pipo flenjor for di   Lake of di Ozarks, break social-distancing rules

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, For Missouri, pipo flenjor for di Lake of di Ozarks, break social-distancing rules

    Americans don gada for beach and lakes to celebrate Memorial Day weekend, dem no mind di make plenty pipo no gada rule wey goment put sake of di coronavirus outbreak.

    For Florida, state police scata hundreds of pipo wey gada for Daytona Beach for Saturday.

    Plenty pipo break social distancing rule for Missouri as dem gada for bars wey dey for Lake Ozarks dey groove.

    US coronavirus task force Chief Dr Deborah Birx say di mata worry her as she see as pipo dey do I don’t care for dis coronavirus mata.

    Big crowds for Californiabgada for Newport Beach

    Wia dis foto come from, EPA

    Wetin we call dis foto, Big crowds for Californiabgada for Newport Beach

    Mayor of St Louis, Missouri, Lyda Krewson shook mouth for di mata. She say na irresponsible behaviour for pipo to take dat kain risk just because dem wan groove for weekend and jolly for di memorial day holiday.

    Tori pipo for di Associated Press tok say di crowd for Florida too plenty so authorities gats close di parking lots.

    Same tin for California as large crowds gada dey enjoy di beach. State officials say most of dem cover dia face wit masks and dem maintain social distance for di beaches and parks.

    For South Carolina, dozens of boats take part for di Make America Great Again parade off Charleston

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, For South Carolina, dozens of boats take part for di Make America Great Again parade off Charleston

    Memorial Day – na annual holiday dem dey do every last Monday of May to honour pipo wey die wen dem still dey service for di US military. E dey mark di unofficial start of summer.

    Di US get more cases of coronavirus pass anywia else for di world. E get over 1.6 million known infection and di pipo wey don die from di virus dey near 100,000.

    All di 50 US states don open partially afta months wey dem lockdown. Restrictions wey dey ground now depend on di kontri.

  13. How Nigerians dey reason online classes ontop coronavirus palava

  14. Coronavirus: Trump warn say im go move Republican convention

    America Presido Donald Trump

    Wia dis foto come from, AFP

    Wetin we call dis foto, America Presido Donald Trump

    America President Donald Trump say im go move di 2020 Republican convention comot from North Carolina sake of coronavirus ban for there.

    North Carolina still dey di phase two of reopening – as large gatherings still dey banned.

    Oga Trump say govnor Roy Cooper no fit give assurance say pipo go attend di venue of di convention for August.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    He say if im no get clear answer weda everybody go attend, im go move di convention go anoda place.

    Oga Trump bin don dey encourage states for weeks now make dem open.

    Di death toll for di US don dey near 100,000.

  15. Ghana Covid-19 recoveries pass 2000

    Coronavirus cases for Ghana

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Coronavirus cases for Ghana

    Covid-19 recovery cases for Ghana reach 2070 two months after de pandemic enter de country.

    Meanwhile de case count also dey rise steadily after Ghana Health Service record 125 new infections, which peg de total for 6,808.

    Total number of Covid-19 related deaths be 32.

    Ghana dey fight Covid-19 through enhanced contact tracing teams.

    Prez Akufo-Addo reveal say de central strategy for defeating de virus be through – tracing, testing and treating.

    Dis 3Ts dey happen across de country, including places like Accra, Kumasi, Cape Coast, Tamale, Ho, Takoradi den tins.

    Stakeholder consultations dey happen plus key players on de way forward towards easing of restrictions, so say social den economic life go return to normal for Ghana.

  16. Coronavirus for presidency: why Biya order Covid-19 test for all workers

    Cameroon President Biya don order all workers for presidency for do Covid-19 test, local reports for kontri don tok.

    Dis order kam after reports say president Biya e personal medical doctor, colonel Marius Etoundi die of Covid-19 complications for May 21.

    No bi only doctor die for presidency, oda report say first lady, Chantal Biya e driver die of Covid-19 last moon. Cameroon presidency get about 1000 workers.

    Cameroon relax measures for block dis sick two weeks ago and since den, cases di climb ceiling.

    Just now, Cameroon don confirm 4890 cases, 2860 active cases, 1865 don recover and 165 don die. Active cases di da-so high.

    Cameroon health minister, Manaouda Malachie say de situation don complicate.

    “Protect yourselves, families, respect rules for block de virus more dan before. Wear mask wen you di komot for house”, Manaouda tok.

    De situation di wowo for taim weh goment decide for open schools for examination classes for June 1.

    Teachers trade unions don send conditions weh goment get for respect before school start or deh go boycott.

    De trade unions, don ask Prime Minister, Joseph Dion Ngute for make sure say: all school pikin dem and teachers get masks and hand sanitiser, only 24 pikin dem for class, dis-infect schools every day, give special allowances…

  17. Covid-19 turn plenty young Muslim to Imams

  18. Davido, Tiwa, M.anifest, Burna Boy dey totori fans for Africa Day 2020 concert

  19. See wetin ISIS, Boko Haram and oda jihadist leaders dey tok about Covid-19

  20. Five tins wey don change for Eid al-fitr celebration sake of COVID-19