Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Cyprus wan pay di holiday costs of infected tourists

    Pesin dey beach

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Pesin dey beach

    Cyprus don promise to to cover di holiday costs of anyone wey test positive for di virus afta dem travel go dia.

    Inside one letter wey show on Wednesday, di government say e go pay for accommodation, medicine and food for patients and dia families.

    Tourists "go only need to bear di cost of dia airport transfer and repatriation flight".

    Na part of di package of measures wey we wan use take make sure say visitors come back to di island, wey don report only few cases.

    According to Johns Hopkins University data, di country don confirmed 939 infections and 17 deaths.

    Tourism account for about 15% of di country GDP last year, and so di government wan to bring back travellers as soon as possible.

  2. Five tips from di world best teacher on how to teach your pikin for house

  3. Zambia health minister test positive for Covid-19

    Zambia Ministry of Information

    Wia dis foto come from, Zambia Ministry of Information

    Zambia Health Minister Chitalu Chilufya don test positive for coronavirus, im be di second cabinet wey get Covid-19.

    Last week, di Information Minister Dora Siliya announce her test result for public in order to fight di stigma wey dey associated with di virus, na wetin she tell BBC.

    Tori be say dem announce di health minister test results during one press conference as dem dey update di nation on di latest figures.

    For di last five days, Zambia don record 137 new cases, dis don bring di total number to 1,057.

    Seven don die from di disease.

  4. Lockdown generation 'fit dey affected for decades'

    Girl wey wear face mask dey press phone.

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Di coronavirus pandemic don damage economies and cause increase in unemployment around di world - and e affect young workesr in a way wey no balance, according to one UN agency.

    One report by di International Labour Organisation (ILO) say more dan one in six pipo under di age of 29 don stop work since di start of di health crisis, and e hit young women pass.

    Covid-19, fit affect di career opportunities of di lockdown generation" for decades to come.

    "Pipo go get permanent scars from di effect of di pandemic," according to di head of di ILO, Guy Ryder.

    While di virus dey currently responsible for more dan 350,000 confirmed deaths worldwide, e dey also destroy jobs, education and create challenge for those wey dey seek to enta di labour market, di ILO tok.

    obs, disrupting education and creating obstacles for those seeking to enter the labour market, the ILO says.

    Di agency dey call for urgent large scale programmes to support young pipo.

  5. In case you just dey join us...

    See di latest global headlines

    • Di European Commission dey set up fund wey worth €750bn (£670bn; $825bn) to help di EU tackle wetin dem call di "unprecedented crisis". Covid-19 don hama economies across di 27-nation EU bloc, but several southern states bin get big debts even before di crisis.
    • Meanwhile, France don announce €8bn rescue plan for im car industry, wey di pandmic affect well-well. Dem don also stop doctors from using di anti-malarial drug hydroxychloroquine for Covid-19 patients because of potential health risks
    • Latin America don become di new epicentre of di global crisis.Brazil daily death rate now na di highest for di world, and one study dey warn say di deaths fit increase five-fold by August.
    • Di total number of cases worldwide now don pass 5.5 million, while more dan 349,000 pipo don die.
  6. Premier League dey closer to returning

    Pesin dey roll ball for field

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Premier League clubs don vote to resume contact training as dem go closer to restarting di season, wen e dey safe to do so.

    Dem suspend England top flight on 13 March because of di pandemic but non-contact training resume on 19 May.

    One statement from di Premier League tok say dem agree to di change "in consultation with clubs, players, managers, di PFA, LMA and di government."

    E add: "Strict medical protocols dey in place to ensure di training ground na di safest environment possible and players and staff go continue to dey test for Covid-19 twice a week."

    Dem go publish di results of d third round of coronavirus tests later on Wednesday. So far eight people from Premier League clubs don test positive from 1,744 tests.

  7. France comot hand from hydroxychloroquine coronavirus treatment

    Hydroxychloroquine inside bottle

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Wetin we call dis foto, Nigeria na one of di few kontries wey claim say hydroxychloroquine dey work for dia patients

    Doctors for France don dey banned to use hydroxychloroquine to treat coronavirus patients after French goment get advice from two sabi joinbodi say e fit cause serious health palava.

    French virologist Didier Raoult bin don promote di drug, wey normally na for malaria, rheumatoid arthritis and lupus, afta e meet President Emmanuel Macron to discuss am as treatment for Covid-19.

    US President Donald Trump tok say im dey use di drug to prevent di illness. Brazil President Jair Bolsonaro sef don endorse am, but no clinical studies don recommend am as coronavirus treatment.

    In fact, health officials for many kontris don draw ear give pipo say hydroxychloroquine fit cause heart problems.

    Dis announcement from France dey come days afta World Health Organisation suspend all tests into hydroxychloroquine as Covid-19 treatment.

    But e no stop di Nigerian goment wey confam on Tuesday say dem go kontinue wit medical trials.

    So, wetin we sabi about hydroxychloroquine? Read am here.

  8. Live from PH - Life afta coronavirus Rivers lockdown

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
  9. Family member of Senegal president test positive for Coronavirus

    Di brother of Senegal president don announce say im don test positive for coronavirus.

    Aliou Sall, wey be di mayor for Guédiawaye, say im dey collect treatment for Dalal Diam hospital for di capital, Dakar.

    Im wife wey also test positive for di virus dey di same hospital.

    Mr Sall thank health workers wey dey di hospital for dia professional work and e ask di publi to pray for am.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

    So far Senegal get 3,161 cases of coronavirus.

    Di kontri dey state of emergency wey go end on 2 Jun and dusk-to-dawn curfew don dey to prevent di spread of di virus.

  10. Ghana Covid-19 cases cross to 7,000

    Confirmed Covid-19 infections case count for Ghana rise catch 7,117.

    Total infections cross de seven thousand mark after health authorities record 153 new cases.

    Meanwhile, recovery cases to dey rise as 220 people test negative for de virus after weeks of treatment.

    Total number of recoveries now catch 2,317.

    De country record two more deaths which push de death toll go 34.

    Ghana capital, Accra still dey remain epicentre with 5008 out of de total case count for de country.

    Ghana Covid-19 case dey rise
  11. SA go reopen places of worship, do national prayer

    Muslims dey pray

    Wia dis foto come from, Reuters

    Wetin we call dis foto, Some religious leaders bin don move service go online streaming afta church and mosque close for march.

    South Africa President Cyril Ramaphosa say places of worship go open again on 1 June but e go come with strict rules to prevent di spread of coronavirus.

    Churches, mosques, temples and confam places of worship go need to practice social distancing for dia members.

    Only 50 or less pipo go dey allowed to attend service depending on di size of di worship place.

    All worshippers go also need to wear masks and sanitise.

    President Ramaphosa acknowledge say religious leaders get important role for di community, including counselling and prayers.

    E say di pandemic don affect pipo religious life well-well and na wetin make am consider to reopen places of worship be that.

    Di president announce 31 May as di day wey di kontri go hold national prayer

    Some religious leaders bin don move service go online streaming afta church and mosque close for march.

    South Africa so far don get 24,264 cases of coronavirus, di highest for Africa.

  12. Covid-19 death for Nigeria don almost reach 250

    Di number for pipo wey don die from Covid-19 don rise reach 249.

    For di latest update wey di NCDC bin report, Lagos still get di highest number of confamed positive patients with 161 out of di 276 new cases.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  13. Una Goodmorning!

    Good Morning awa yard pipo! How una dey. And happy children's day to our pikins dem.

    Make we begin with dis proverb from Ezeka Elvis Ihueze. How una reason am. Oya go drop your own for we comment section for our Facebook, Twitter and Instagram page.

    POTD
  14. Una goodnight!

    Na here we go march break ontop our live coverage of di coronavirus and how e dey affect di world.

    Make una join us again tomorrow for more live updates.

    No forget to scroll down for Tuesday tori dem.

    Una goodnight!

  15. Kenya research institute wan 'help' test Oxford University Covid-19 vaccine

    As researchers dey run to find vaccine for Covid-19. One of di leading teams based for Oxford University - wia dem dey test di possible solution - wey dem call ChAdOx1 nCoV-19 - on more dan one thousand UK based volunteers.

    Now, di Kenya Medical Research Institute don confam say dem go join help dem for dia search. Di four hundred volunteers go need to dey over 18 and go dey work as health professionals for di coastal town of Kilifi.

    Controversy bin don dey around di testing of vaccines for Africa, but di researchers insist say dem go seek regulatory approval before dem begin any trial… and say Kenyan participation is dey key if di vaccine go dey suitable for use for di continent.

  16. See rules pipo must follow as Wike cancel lockdown for Port Harcourt and Obio-Akpor till further notice

  17. See how sex workers for Germany plan to protect dia customers from coronavirus

  18. Zaakpon women protest 'naked' against arrest of Prodest Hotel Manager

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
    Zaakpon women

    Wia dis foto come from, Allwell Ene

    Some women for Zaakpon, Khana local goment area for Rivers State don protest 'naked' to demand di release of dia pikin Dr. Bariledum Job Azoroh wey be di manager of Prodest Hotel, Alode Eleme wey Governor Wike demolish some weeks ago say dem disobey Executive order wey ban hotels from operating.

    Di Goment bin arrest di Prodest Hotel Manager afta dem demolish di hotel on 10 May, 2020 come charge am go court say make dem put am for Isolation Centre wey dey di Yakubu Gowon Centre to observe weda or not im get coronavirus.

    Rivers State Commissioner for Information Paulinus Nsirim for statement on 24 May 2020 bin reveal say di manager follow for di 27 new cases wey test positive to Covid 19 virus and dat one justify why di State Goment go demolish di hotel.

    But wen BBC Pidgin contact di owner of di hotel, Gogorobari Needum Promise, im say im dey hospital dey take treatment say e no fit comment on di mata.

    Di Prodest Hotel Manager Dr. Bariledum Job Azoroh dey di coronavirus treatment centre for Rivers State.

  19. Spain go mourn pipo wey die from Covid-19 for 10-day

    Spain

    Wia dis foto come from, EPA

    Spain go begin 10-day mourning period from Wednesday, na wetin goment tok-tok pesin Maria Jesus Montero tok.

    She tell tori pipo say flags for all official buildings and military ships go fly at half mast, to remember di pipo wey die from coronavirus for di kontri.

    At di end of di 10 days, dem go hold memorial ceremony.

    "Dem no dey with us physically anymore, but dem go dey our memory forever and will honour dia memory because dem deserve am, with official tribute from di head of state," na wetin Ms Montero add put.

    Na total of 26,834 pipo wey die from di virus for Spain, according to di informate wey US-based Johns Hopkins University release.

  20. Kano goment deny tori of 'empty' isolation centre

      • Author, Mansur Abubakar
      • Role, BBC Pidgin, Kano

    Kano state goment for northwestern Nigeria say na di richest man for Africa, Aliko Dangote, get di empty isolation centre wey some pipo dey share for social media.

    Muhammad Garba wey be commissioner of information and member of di covid 19 taskforce tell BBC say, dem neva dey use di place wey dey for Sani Abacha Stadium because Dangote neva finish work and handover di place to Kano goment.

    “Dat video na just bad pipo wey wan just spoil Kano name, di isolation centre for Sani Abacha Stadium na work in progress and na Dangote dey do di work if e finish e go handover to goment as e promise.”

    “Dangote bin promise to give 500 bed isolation centre to Kano as e be say Abacha stadium no fit carry all, e come do 287 for oda places and den do 213 for di stadium.”