You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Breaking, President Buhari reduce lockdown measure for Abuja, Lagos and Ogun

  2. Breaking, Coronavirus: President Buhari don order total lockdown of Kano, days afta many deaths from 'strange sickness'

  3. Lagos don discharge 15 coronavirus patients

      • Author, Damilola Banjo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

    For south west Nigeria, Lagos state goment don discharge 15 COVID-19 patients after dem test negative two times for coronavirus.

    Di state ministry of health give announcement on Monday.

    Di patients dem discharge include 11 females and four males, wit one Indian, from di isolation facilities at Yaba and Onikan in Lagos.

    Lagos State don discharge total number of 138 COVID-19 patients.

    1273 pipo get coronavirus for Nigeria and 40 pipo don die

  4. Coronavirus: Lockdown for parts of Port Harcourt till further notice

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Lagos

    For southern Nigeria Rivers State Governor,Nyesom Wike for State broadcast don announce anoda complete lockdown for parts of Port Harcourt and Obio/Akpor Local Goment Areas.

    Di areas affacted include Elekahia, including di entire stretch of Rumukalagbor-Elekahia link road; Rumuomasi, including Stadium road; and Rumuobiokani till further notice starting from Tuesday 28 April 2020.

    Dis one dey join di complete lockdown wey still dey on from Mile 1 to Mile 3 axis for Port Harcourt because say pipo wey dey stay dia no gree comply with di regulations wey di State Goment put to check di spread of coronavirus.

    Di Governor warn landlords to comply odawise dem go demolish any building wey open for business.

    Di oil rich state of Rivers wey dey di Niger Delta region, record three new cases of di new coronavirus Covid-19 disease on Sunday 26 April, 2020.

    .

  5. Policeman chop arrest for attending house party

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

    One Ugandan policeman wey give permission to one businessman to hold party and im sef attend di party, don chop arrest.

    Dem charge am for disobedience of lawful orders and say e dey commit act ofnegligence wey fit cause di spread of Coronavirus, one tok-tok pesin for police tell BBC.

    Dem detain Samson Lubega, one police commander for Agago, northern Uganda after im attend di party of pesin wey don visit UK and don travel go Dubai, tori pipo for Daily Monitor report di mata.

    President Yoweri Museveni bin ban social gatherings for Uganda to prevent di spread of coronavirus..

  6. INEC still dey reason Edo and Ondo States Govnorship election inside Coronavirus spread

      • Author, Damilola Banjo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

    Nigeria Electoral commission say dem never change plan on top election for Edo and Ondo States

    Di Independent National Electoral Commission (INEC), di organisation wey dey conduct election for Nigeria, don tok say dem never postpone or even rearrange schedule of election activities for Edo State inside south-south and Ondo State for southwest Nigeria.

    Di commission tok say di election go still hold on 19 September and 20 October, 2020 as dem earlier put for timetable wey dem release for 6 February.

    Dis na according to di latest informate wey Festus Okoye, di National Commissioner and Chairman, Information and Voter Education Committee, give.

    Di organisation tok say dem dey mindful of the coronavirus palava for di kontri and dem dey monitor wetin goment and health authorities dey do to stop di spread of di virus.

    INEC add say if dem need to change di timetable for di election, dem go give di infomate.

  7. Coronavirus cases don pass three million all over di world, plus oda latest Covid-19 updates

    Coronavirus don reach 185 kontris and di total number of confamed cases for di world don pass three million according to di latest data from Johns Hopkins University.

    But how di US University take dey collect dia data?

    Di numbers wey John Hopkins dey collect na from different sources wey include di World Health Organization (WHO), di European Centre for Disease Prevention and Control, goment health departments from around di world, local media reports and from one big online community of healthcare professionals.

    Di data dey show for online map as cases dey happun and dem dey update am throughout di day, di university tok.

    Na one civil and systems engineering professor for Johns Hopkins, Prof Lauren Gardner develop di map or dashboard and dem share am online for di first time for 22 January.

    One graduate student Ensheng Dong help build and maintain am, but as di virus dey spread, more pipo for di University join hand.

    Plenty media houses dey use di dashboard to report tori and na one of di sources wey BBC dey use. Since dem make am available for January, di University say pipo wey dey ask for dia data don pass one billion.

    Latest Coronavirus update

    Ghana President Nana Akufo-Addo don announce plans to construct more than 90 hospitals to help health system for di kontri during dis coronavirus outbreak.

    Di pandemic don expose di weakness for di kontri health system following years of under investment, according to di president,

    New York City go soon open 64 KILOMETERS of streets to di kontri pipo so dem fit get more space for social-distancing outside.

    Di mayor of di cityBill de Blasio tok say dem go first open streets wey dey around parks sake of say areas around parks dey dey crowded.

    Prime Minister Boris Johnson don tok say di UK dey point of "maximum risk" and im no go relax lockdown restrictions on coronavirus quickly.

    Oga Johnson just return to office after e spend days for hospital.

    From today, pipo for Czech Republic fit travel go anywhere dey want, according to dia Priame Minister Andrej Babis.

    But di prime minister con dey wonder where dem go even go as train and plane no dey work anywhere and plenty kontris for di world don close dia borders

    Kenya health minister Mutahi Kagwe don allow restaurants to reopen

    But im issued guidelines wey dey mustto follow as dem dey sell.

    Kagwe add join say dem go test all restaurant workers before dem allow dem open.

    Lorry don dey pile up for Kenyan-Ugandan border.

    Dis na as Kenya begin to dey test drivers for coronavirus before dem drive dia lorry enter di kontri.

    Some Premier League footballers don return to training grounds today.

    Tori be say plans to resume di English Premier League season go start dis week.

    Arsenal and Brighton na two of di clubs wey don already open dia training grounds to players for individual workouts.

    Borussia Dortmund chief executive Hans-Joachim Watzke don claim say di Bundesliga no go survive if di season no resume in di next few months.

    Di coronavirus pandemic force di Bundesliga to postpone last month but sport pipo dey tok say di club fit resume to dey play games without fans.

  8. See six new symptoms wey CDC add to coronavirus Covid-19 disease

      • Author, Annette Arotiba
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

    Di Centers for Disease Control and Prevention (CDC) don add six new symptoms to di coronavirus Covid-19 disease symptoms wey bin dey ground before.

    Di new symptoms na:

    1. Muscle pain

    2. Chills

    3. Repeated shaking wit chills

    4. Headache

    5. Sore throat

    6. Loss of taste or smell

    Dis one join wit di odas wey dem don announce before like fever, cough, shortness of breathe or wahala to breathe.

    As coronavirus cases don dey reach 3 million for di world, new informate about di disease dey change.

    Di CDC advice say di list go continue to dey grow but make pipo go hospital if dem notice say dem no fit breathe normal, get chest pain and di colour of dia lips or eyes dey change.

  9. “To ease lockdown Nigeria need extreme caution” - Peter Obi

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

    Nigeria opposition politician, Peter Obi say to relax lockdown for any part of di kontri, dem go need extreme caution.

    Di former vice presidential candidate of di main opposition PDP for Nigeria 2019 general election yan dis one on Monday as di four weeks lockdown wey President Muhammadu Buhari bin order for di kontri dey expire

    Oga Obi say till date di kontri don only test around 10,000 pipo for COVID19, and dis data no fit give us di true reflection of di status of di pandemic for di kontri.

    Many states fordi kontri don dey in lockdown for almost one month and 32 states out of di 36 states wey di kontri plus di kontri capital, Abuja don confam di virus.

    Since 27 February, 2020 wen di first case land Lagos, di Nigeria Centre for Disease Control, NCDC say dem don test 10,918 pipo for coronavirus for di kontri.

    Many odas like Oga Peter Obi dey wonder how dem wan manage di remaining two hundred million pipo wey dey Nigeria population.

    As at 26, April 2020, di kontri get 1,273 confam cases of Covid-19 and di virus don spread to 32 out of di 36 states.

    Di virus don kill 40 pipo and na Lagos for south west of di kontri get di highest number of cases with 689.

    So far 239 don recover from di disease.

  10. 'Index case for Bayelsa na middle aged woman wey dey hypertensive and diabetic'

      • Author, Karina Igonikan
      • Role, BBC Pidgin

    Di index case of coronavirus for Bayelsa State for southern Nigeria na middle aged woman wey dey hypertensive and diabetic.

    Di State Health Commissioner, Dr. Inodu Apoku tell BBC Pidgin say dem catch her case because of di serious work dem do to closely monitor patients for di state because she no get any history say she travel comot for di state and no show di typical signs of di disease.

    Im say she don dey receive treatment for dia treatment centre and dem don close down di hospital wia she bin dey receive treatment and put evribodi for dat hospital for isolation under dia surveillance, even as dem don start contact tracing.

    Di commissioner say di number of pesins for di contact tracing dey very wide but dem also don collect samples from her husband and three pikins for test.

    As way to stop di spread of di virus, Bayelsa State Goment bin don impose dusk to dawn curfew wey dem extend for anoda two weeks, last Friday 24 April, 2020.

    Di State Chief Judge, Justice Kate Abiri don also set up mobile court on Covid-19, with four magistrates wey go start sitting on Monday, April 27, 2020 for Swali Ultra modern market. Offenders go pay fine or do community service.

  11. Ghanaians 'question' govment promise to build 88 hospitals in one year

  12. Nigeria don test 10,918 pipo for coronavirus

    Nigeria Centre for disease control say dem don test 10,918 pipo for coronavirus for di kontri.

    As at 26, April 2020, di kontri get 1,273 confirmed cases of Covid-19 and di virus don spread to 32 out of di 36 states.

    Di virus don kill 40 pipo and na Lagos for south west of di kontri get di highest number of cases with 689.

    So far 239 don recover from di disease.

  13. UK Prime Minister don return back to work afta im recover from Covid-19

    UK Prime minister don return to Downing Street to take charge of im kontri response to coronavirus outbreak.

    Di prime minister go lead di regular morning cabinet meeting on Covid-19 before im go do tok-tok with senior ministers and officials.

    Foreign Secretary Dominic Raab,wey bin dey stand in for di PM, say Oga Johnson dey "good to go".

    Im arrive back to No 10 on Sunday evening and dey face serious pressure from Tory lawmakers to lift di ban on di kontri lockdown.

    Di latest official figures wey dem release put di total number of deaths for hospital as 20,732, afta dem announce 413 on Sunday.

  14. Nigeria don get 91 new cases of coronavirus

    Nigeria don get 1273 confam cases of Covid-19 on top new numbers wey NCDC don carry come out.

    So far forty pipo don die from di virus.

    Ebonyi and Bayelsa states na some of di states wey don get dia first confam case.

    Dis na di states: 43 for Lagos, 8 for Sokoto, 6 for Taraba, 5 for Kaduna, 5 for Gombe, 3 for Ondo, 3 for FCT, 3 for Edo, 3 for Oyo, 3 for Rivers, 3 for Bauchi, 2 for Osun, 1 for Akwa Ibom, 1 for Bayelsa, 1 for Ebonyi and 1 for Kebbi.

  15. Una good morning!

    Una welcome to our live coverage of di coronavirus palava and how e dey affect di world.

    But first check out our proverb for today.

  16. Deaths in Kano: Wetin we know so far

  17. Na here we go march break!

    Na here we go end our coverage ontop coronavirus and how e dey affect di world. No forget to join us again tomorrow.

    Good night!

  18. In case you just dey join us...

    Dis na di latest ontop di coronavirus and how e dey affect di world.

    • Spain don record im lowest daily death toll since 20 March, na 288 pipo die.
    • 413 pipo don die for UK hospitals, di total death don be 20,732.
    • PM Boris Johnson go return to work on Monday, meanwhile UK Foreign Secretary Dominic Raab don draw ear ontop advise to reduce di lockdown
    • Sweden say na "tori" say di goment never take "serious steps"
  19. See some popular pipo wey don die for Kano state