Coronavirus: Nigeria go test 2 million pipo within three months - NCDC
Nigerian goment for di daily briefing of di Presidential Task Force on COVID-19 on Tuesday say dem dey target to test up to 2 million pipo for COVID-19 disease for di kontri in di next three months.
Di Director-general of di Nigeria Centre for Disease Control (NCDC), Chikwe Ihekweazu tok am for di kontri capital, Abuja say dis na part of di aggressive plans to take contain di spread of di virus,
He tok say dis go mean say dem go test up to 50,000 pipo per state within dis period.
Im assure say goment dey committed to expand di testing laboratories wey dey di kontri.
17 total number of testing laboratories na im presently dey di kontri.
Di kontri don confam 1337 cases of di virus out of about 10,000 pipo wey dem don test for di virus.