·Imo don become di latest state for Nigeria to
record COVID- 19 disease.
Di south eastern state record 1 of di total of 87
new cases wey Nigeria Centre for Disease Control confam around midnight
For di breakdown 33 cases don add for Lagos and 4
for Kano.
·Meanwhile one person don die of coronavirus for
Lagos wey get di highest cases of di Covid-19 disease for Nigeria.
Dis state Ministry of Health announce dis for
Saturday and add say dem don discharge 10 oda pipo.
·For Kenya, one travel ban wey goment place in and
out of capital, Nairobi and three oda towns including Mombasa go extend by
anoda three weeks.
President Uhuru Kenyatta na im extend di dusk to
dawn curfew for another 21 days.
·South Africa goment say more than 1.5 million
pipo for di kontri go fit begin work
And dem go allow pipo wey dey deliver hot food to
continue dia business.
But dem say di strict lockdown restrictions go
still continue.
·South Africa dey plan to reopen dia agriculture
sector and allow some manufacturing and retail to resume.
Dis na di measure to help di kontri balanceproduction for dia economy and stop di spread
of coronavirus.
Yes, na di trade minister Ebrahim Patel tok dis
one on Saturday.
·New York wey be di epic centre of coronavirus
outbreak for America go begin allow pharmacies dey do test for Covid-19 virus.
Di govnor, Andrew Cuomo wey give dis informate,
say dem give permission to 5,000 pharmacies to make dem fit provide 40,000 Covid-19
test results for New York everyday.
·WHO don draw ear give governments all over di
world say make dem no sign anything give patients wey don recover say di
Covid-19 no fit catch dem again.
World Health Organization say in order to reduce lockdown restriction, some
governments dey give some pipo assurance wey no hold water.
·India don allow small local stores to reopen
after one month wey di kontri lockdown sake of coronavirus.
Di interior ministry say na only half of staff
wey dey work for di stores must come to work and dem must wear mask and observe
social distancing.
·Meanwhile, death toll for UK don pass 20,000
after di kontri add anoda 813 death for di last 24 hours.
Na di kontri Department of Health and Social
Caregive di informate.
·Chelsea don ask im first-team squad to support
pipo wey dey help odas instead of contributing money to di club during dis
coronavirus palava.
Premier League don dey suspended since
coronavirus and dis dey affect di club because dem no fit sell ticket for
matches.
·Arsenal football club say dem go allow dia
players begin train for Colney from next week
But dem go follow social distancing rule oh.