World Health Organisation don warn say to begin remove
coronavirus lockdown measures too early fit "make am increase"
infection again.
Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus say kontris need to dey careful about easing restrictions, even as some dey struggle with di economic impact.
E say news about di slow spread of di epidemic for some European kontris dey "welcome".
But "sharp increase" for oda kontris including Africa na cause for concern.
1.6 million cases of coronavirus na im dey for di world and 97,000 pipo don die.
Dr Tedros say di WHO dey work with kontris to form strategies to ease restrictions.
"I know say some kontris dey already plan di transition out of stay-at-home restrictions. WHO want see make dem lift restriction as much as anyone," na so im tok for online news conference for Geneva.
"At di same time, lifting restrictions too quickly fit bring back di disease . Di way down fit dey dangerous as di way up if we no manage am properly."
Im tok dey come as di goment for Spain, wey dey part of kontris wey don suffer di most, dey prepare to allow some non-essential workers for sectors including construction and factory production to return to dia jobs on Monday.
Spain record dia lowest daily death toll in 17 days on Friday, with 605 deaths. According to di latest figures, Spain now get 15,843 registered deaths related to di virus.
However, di goment don tell pipo to kontinu to observe social distancing rules as di kontri dey celebrate Easter weekend.
Speaking on Friday, Dr Tedros welcom signs wey show say di spread of di virus dey slowdown for some of di kontris wey di virus affect di most for Europe - namely Spain, Italy, Germany and France.
Di number of pipo wey don die for Italy rise by 570 on Friday, down from daily figure of 610 di day before, and di number of new cases also slow small to 3,951 from 4,204.
But Dr Tedros warn say di virus now dey spread fast for some oda kontris and highlight Africa, wia im tok say di virus don reach villages.
"We now dey see some cases and community spread in more than 16 kontris" on di continent, im tok.
"We anticipate serious hardship for already overstretched health systems, particularly in villages, which normally no get di resources of those in cities."