You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Nigeria, Egypt and oda African kontris don begin vaccine trial for Coronavirus

    Di Africa Centre for Disease Control (CDC) don put out some of di trials wey dey go on for Covid-19 treatment and vaccination for Africa.

    For one joint briefing online with doctors for Shanghai hospital, di CDC tok say in comparison to di rest of di world e get few treatment wey dey happun for di continent.

    Dr Taji Rajudeen outline di trials wey dem don do so far:

    • In Egypt, e get about 13 trials wey dey happun. Scientists tok say dem still dey conduct about two trials for di vaccine.
    • In Zambia, dem get one ongoing trial with hydroxychloroquine.
    • South Africa dey part of di WHO solidarity trial, and dem dey chook eye for Chloroquine, Interferon, Remdesivir.
    • For Nigeria, e get one trial wey dey in progress-still on wetin fit cure di virus.
    • Tunisia get two trials wey dey go on.

    Di Africa CDC dey try to bring together di different research consortiums for di continent to see how dem go fit change di narrative so that Africa go dey more involved.

    Fifty-two African kontris don confam positive cases of Covid-19 and ova 37,000 patients dey get treatment.

  2. Nigeria goment offices go open from Monday, but wit strict time to operate

    Office of Nigeria presido don tell civil servants wey dey level 14 and above to resume work on Monday 4 May.

    For inside letter wey come from di office of di Head of Service of di Federation, offices go open Monday, Wednesday and Friday and dem go close by 2pm each day.

  3. 16 Almajiris wey enta Kaduna State from Kano test positive for COVID- 19

    Di Kaduna State goment don confam 16 news cases of coronavirus for di state.

    Di commissioner for health for di state, Dr Amina Mohammed-Baloni, give dis informate for inside statement on Thursday 30 April.

    She explain say di new cases na Almajiris wey enta di state from Kano, and dia test result come back as positive from di 40 pipo wey do test for di virus.

    Dis informate dey come few hours afta di kontri centre for disease control report 196 new cases for di kontri.

    Di state health agency for inside tweet explain say di 17 new cases wey di NCDC bin report for Kaduna na mistake as one pesin wey don already test positive do di test again. Di commissioner tok say dis new infections don rise di number of active cases for di state from 9 to 25.

    Dr. Mohammed-Baloni tok say di high figure wey di state get na from pipo wey dey track come di state from neighbouring states.

    Di commissioner say health officials dey monitor suspected cases wey sneak enta Kaduna even as dem ban inter-state travel.

    Di State Standing Committee on COVID-19 don beg security agencies to block every entry points enta Kaduna.

  4. , Lagos Deputy Govnor Dr. Olufemi Hamzat dey Live for Covd-19 Tok Your Own

    You sef fit ask di Deputy Govnor question, just call (+234) 017006597

  5. Ghana Covid-19 cases cross 2000

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin

    Covid-19 infection continue dey rise for Ghana as cases reach 2,074 today.

    From de last case count, check like 403 new cases wey come add to de total infections for Ghana.

    One more person wey get de virus die, dis push de total infections go 17.

    Epicenter of de virus spread dey Greater Accra wey record 1,795 cases.

    So far 12 out 16 regions for Ghana wey record Covid-19 cases.

    President Akufo-Addo reveal say de ban on social gathering still dey in force wey e no sheda clear when dem go lift am.

    2��*�,

  6. Cameroon ten regions don confam cases of Covid-19

      • Author, Bongben Jisi
      • Role, BBC Pidgin, Cameroon

    Cameroon Health Minister, Malachie Manaouda announce for night say far North don register e first case of Covid-19, and say deh di trace de contacts.

    Just now, coronavirus dey for de whole kontri as number ten region don confirm dia case, inside 26 new cases for total 1832 cases, 934 pipo recover and 61 pipo don die.

    As de cases di increase some doctors for Cameroon don di make chest scan for get moni instead of test.

    Some pipo pay about FCFA73,000 for dis test for some private hospitals.

    Health Minister don warn say deh go punish dem if deh continue wit dis practice even if patient get right for chose weti weh e want.

    Malachie say de only way for confirm Covid -19 na for test, and dis test and treatment bi free for hospital.

    Specialised centres dey for de whole kontri and authorities say make doctors for private and public hospitals refer all cases for Covid-19 for de centres.

    Health Minister advice population say now more dan ever na de taim for follow rules very well especially for wear masks, call 1510 if deh get symptoms.

  7. South Korea record zero local infections of Covid-19

    South Korea don report zero local infections for di first time for 75 days (although dem get four imported cases).

    Make we look back to how South Korea comot from di hotspot to success story:

    • 20 January -Dem report di first confam case of Covid-19, and na one Chinese woman.
    • 4 February - South Korea begin to deny entry to foreigners wey dey travel from Hubei province inside China - di epicentre of di outbreak.
    • 18 February - South Korea confam dia 31st case - one member of di Shincheonji religious organisation wey continue to attend large church gatherings.
    • As di kontri tests large numbers of church members, di number of cases come increase.
    • 24 February - 15 kontries impose travel restrictions to and from South Korea 29 February
    • Di daily total number climb go 909 pipo wey dey infected.
    • 2 March - By dis date, more dan 4,200 cases na im dem confam with about 60% of dem coming from di church.
    • 15 April - Upon di pandemic, South Korea hold election.
    • 22 April - as cases stabilise to single-digit daily infections, di goment say dem go start to lift restrictions.
    • 30 April - South Korea report no new local infections for di first time since 15 February. Total cases inside di kontri for now na 10,765, and while dem wan ease some restriction - officials dey warn of possible second wave.
  8. Prisoners set fire for Sierra Leone jail afta coronavirus riot

    Some inmates for one prison inside Sierra Leone don dey try to break out and escape afta one inmate wey enta di prison recently develop symptoms of coronavirus.

    Dem kill one warden and several odas injure for di riot wey happun for Pademba road prison for di capital, Freetown.

    Dem light fire burn di jail sef. Pademba road prison get capacity to fit keep about 300 prisoners but currently na more than 1,000 inmates dey dia.

    Di kontri bin don suspend criminal courts for one month as part of effort to reduce di spread of Covid-19 inside jails.

    Na like 104 confam coronavirus cases dey inside Sierra Leone and four pipo don die. Sierra Leone dey among di last African kontries to report coronavirus cases.

  9. Guinea Bissau PM don test positive for coronavirus

    Di health ministry for Guinea Bissau say di Prime Minister Nuno Gomes Nabiam don test positive for coronavirus.

    Interior Minister Botche Cande and two oda ministers also get Covid-19.

    Oga Nabiam tok say plenti members of one inter ministerial coronavirus committee get di disease.

    Guinea Bissau get poor healthcare system because of mismanagement and lack of resources.

    Di kontri don so far confam 205 coronavirus cases and one death

  10. Nigeria record 196 new cases of Covid-19

    Nigeria don record 196 new cases of coronavirus, bringing di total number of infection inside di kontri to be 1,728.

    According to di Nigeria Centre for Disease Control (NCDC), out of di new infections, 87 na from Lagos, 24 dey for Kano, while 18 dey for Gombe.

    Dem also record 17 for Kaduna, 16 for FCT, 10 for Katsina, eight for Sokoto, seven for Edo, six for Borno and one each inside Yobe, Ebonyi and Adamawa states.

    NCDC say di coronavirus don spread now go 34 out of di 36 states of di kontri including FCT.

    307 pesin na im dem don discharge while 51 deaths na im dem don so far record.

  11. Una good morning!

    Welcome to our live coverage of coronavirus and how e dey affect kontries around di world.

    But first check out our proverb for today.

  12. My self-isolation tori: 'E be like say na small prison'

  13. Make we take break

    Yes o! na here we go stop all di tori dem for Wednesday 29 April, 2020 as e concern coronavirus across di world.

    No worry, you fit still scroll down to read all di authentic tori dem we don give una today and Thursday 30 April na anoda day.

    Until then, make we live una wit dis special video from we to you - abeg stay for house!

    Frome Olu, Ronke, Annette, Moseph, Yemisi and Daniel, una good night!

  14. Wetin be ‘community transmission’ of Coronavirus? - Di ansa dey here

  15. Tanzanians dey vex sake of say dem no get Covid- 19 update

      • Author, Annette Arotiba
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

    Tanzania President, John Magufuli don encourage pipo to gada do mass worship as way to stop di spread of coronavirus.

    Oga Magufuli tok say di virus dey satanic and no go get power inside church.

    Cases of coronavirus for di kontri don reach 480 according to di Prime Minister Kassim Majaliwa.

    He give dis update afta pipo hala for social media say, dem no dey hear anytin about Covid- 19 for di kontri.

    Di last time goment give update na one week ago when di case be 306.

    Dis lack of informate don make pipo wonder weda di goment dey hide di true number of cases wey dey.

  16. “Abeg make una stay for house”!!!, Special video tori from BBC Pidgin

    “Abeg make una stay for house and no forget to dey wash your hand wit soap and water”.

  17. Covid-19 in 60 Secs: Mentholatum no dey protect against COVID-19

  18. Sake of Covid-19 Indonesians dey soak dia bodi up for sun like never before

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin

    Sun worshipers for Indonesia dey soak dia bodi up for sun like never before.

    APF photo post for twitter on Wednesday show some of di worshipers lie down under sun wit hope say plentiful sunshine will drive coronavirus far away.

    But WHO don warn say evidence no dey to prove say sun fit comot coronavirus from humnan bodi.

    Tori be say from sojos wey no gree wear shirt to young pipo wey lie down under sun for dia parent compounds, Indonesians dey comot to collect sunrays like dem never do before as dem dey hope say e fit fight coronavirus.

    Na some claims for social media say sunlight and and di vitamin D wey e dey supply fit slow or kill di virus make pipo rush out to take up practice wey foreigners wey dey go Bali dey always do.

    Di hope bin get boost last week wen one senior US official say new research show say sunlight fit quickly destroy di virus.

    Dem never still proof di study but US President Donald Trump tok about am during one press conference.

    "I always dey avoid di sun before because I no wan tan,” Theresia Rikke Austria, one 27-year-old housewife for Indonesia cultural capital Yogyakarta tok.

    "But I dey hope say dis go strengthen my immune system.” she add am.

    Medics get their doubts, but dem say 15-minute burst of morning sunshine dey good for you.

    "To dey expose di body to collect direct sunlight dey good to get vitamin D, but e no go directly prevent di COVID-19 disease,” Dr. Dirga Sakti Rambe for Jakarta OMNI Pulomas Hospital tok.

    Vitamin D, wey come from fish, eggs, milk and sunlight exposure, dey important to maintain beta immune system, he tok.

    But add am say: "Sunbathing no dey kill di virus wey COVID-19 dey cause." Di rush outdoors don make Indonesian goment to warn pipo about di dangers of skin cancer, and e don call on di novice sun-seekers to still protect themself.

  19. Covid-19 latest updates

    Di Nigeria Presidential Task Force on Covid-19 say to reopen di kontri economy gradually go take six weeks o.

    For dia daily press briefing for di kontri capital, Abuja on Wednesday, dem tok say dem go break di reopening into 3 phases of 2 weeks each.

    One local goment chairmo for Nasarrawa State north central Nigeria say dem don send back nine passengers wey dem catch wan enta di area from Kano State, wey dey di north west region.

    Alhaji Abdulrahman Sani-Maigoro say dis measure na to prevent di spread of Coronavirus for dia state.

    Tunisia Health Minister Abdelatif el-Makki say im kontri don controll di "first wave" of coronavirus outbreak.

    Di North African nation wey e get less than 1,000 confam cases say e Deon ready to ease dia ova three weeks lockdown.

    One high court for Uganda don order members of parliament to bring back di five thousand dollars wey dem use dia hand allocate give themselves to take fight COVID-19.

    President Museveni say wetin dem do no carry good moral for hand say make dem carry di moni give di COVID-19 task force teams for dia area.

    Swiss authorities say e now dey safe for children under di age of ten to hug dia grandparents.

    Di European kontri don begin to ease dia coronavirus lockdown measures.

    TikTok, di app wey pipo dey use do popular video challenge dem, don dash $10billion to one big joinbodi wey go use am buy Covid-19 vaccines for Africa.

    Na ontop am di #dontrushchallenge blow

    Spanish football La Liga don dey work towards how clubs go resume training sharperly.

    Dis na afta di Spanish goment don give dem green light.

    Dem bin suspend football until further notice for March sake of coronavirus pandemic.

  20. Pfizer special injection to prevent COVID-19 fit ready by September