Una good morning!
Una welcome to our live coverage of di coronavirus palava and how e dey affect di world.
But first make our proverb of di day ginger you.
You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.
Daniel Semeniworima
Una welcome to our live coverage of di coronavirus palava and how e dey affect di world.
But first make our proverb of di day ginger you.
Chief Judge of Rivers State for south south Nigeria, Justice Adama Iyayi Lamikanra don release one woman and 61 men from prison to decongest prison sake ofcoronavirus.
Di discharged inmates include 46 convicted and 16 awaiting trials pesins from Port Harcourt, Degema, and Ahoada prisons.
Justice Lamikamra during di jaildelivery tell dem to obey law and no do anything wey fit bring dem come back to prison.
Di oil rich state don record three cases of Covid-19 disease and as at 24 April, 2020 na one active case dey.
Dis active case, according to health authorities, test possitive to di new coronavirus Covid-19 afta e take care of pesin wey die of 'strange sickness'.
Many oda states for Nigeria don also release inmates sake of Covid-19.
Watch today episode of awa special 60 seconds video to teach pipo how to make informed decisions about dis coronavirus palava.
Some Muslims for Cameroon don get kwanta wit police as di holy month of Ramadan dey start
Na sake of say dem disobey goment order wey ban large gathering of pipo on top dis coronavirus pandemic.
Police bin drive worshippers from 13 mosques wey dey di West, Central and Far North regions of di kontri wey tanda gidigba say dem must gada do prayer, di tori dey quote wetin one policeman tok for statement.
Awah Fonka, govnor for di West region, tell VOA say im give order to police to drive worshippers comot for mosques wey dey inside Foumban, Foumbot and Bafoussam towns by fire by force.
Cameroon don record more dan 1,430 Covid-19 infections, including 43 deaths from di respiratory illness.
Dancing pallbearers for Ghana say after Covid-19 pandemic dem go start charge dollars for international burial gigs.
Benjamin Aidoo, de group leader talk BBC Pidgin say although de rates for Ghana go remain de same, dem go begin charge international clients inside dollars.
“Now I go viral, I dey everywhere when dem lit de ban wey de pandemic end, I go charge high…moving outside Ghana e go change into dollars” Mr Aidoo talk.
De coronavirus pandemic shut down countries den economies bring de world to a standstill. Chaw govments around de world close dema borders, ban public gatherings, lockdown everybodi plus 'stay home' order to citizens in order to reduce spread of Covid-19.
While millions of people across de world dey under lockdown, boredom dey set in which dey make some people step out to town, while others dey find entertainment online.
De dancing pallbearers from Ghana who dey dance plus coffin on dema shoulder turn major source of entertainment den coronavirus sensitisation message de world over.
Thousands of social media users create plenty internet memes plus de dancing pallbearers, de message behind de pallbearers meme be simple: "stay home or dance plus us."
Chinese company start dey sell dancing pallbearer dolls or like $50 dollars den tins.
De group say dem no make money yet on de viral videos but after de pandemic end, dem go work on dema brand so say money go flow.
Now dem get manager and lawyer from Kenya to handle dema contracts to ensure say dem no go lose out on de internet fame dem get dis year.
British pipo wey wan leave Nigeria return to UK go pay more moni.
British Hgh Commissioner to Nigeria, Catriona Laing tok dis one as she dey give update about di arrangements wey dem dey make to cari dai kontri pippo go back home.
Ticket for di flight wey British Airways go operate go cost almost £500, na so Laing tok.
But she say, any pesin wey wan make dem evacuate am from Nigeria go pay slightly higher price dis time, for flights wey go travel on April 28, May 1 and 5.
“On di payment, flight go get slightly different price dis time £491 from Abuja and £505 from Lagos and I dey fair, sake of you go pay for dis flights.”
She say UK goment dey give priority to pipo wey dey at risk and pipo wey dey live for UK wey go short time visit to Nigeria before federal goment close airports.
Pop superstar Beyonce dey worried say “coronavirus dey kill plenti black pipo for America”.
Pop superstar Beyonce go donate $6m (£4.9m) to helep support coronavirus relief efforts.
Beyonce foundation BeyGood announce di donation for one statement say dem go donate di moni to small community organizations and mental health services across cities for America.
"Black Americans plenti wey belong to di essential workforce wey no get di opportunity to enjoy work from home and African-American communities don dey severely affected for di crisis," she tok for Instagram video.
"Di virus dey kill black pipo at a very high rate here for America. Please protect yourself, we be one family and we need you." She add am.
South African President Cyril Ramaphosa somehow provide a lighter moment of unity for di kontri wen im struggle to wear face ask for live television during im address on Thursday.
At di end of im speech about plans to ease lockdown restrictions, Ramaphosa fumble as im dey try put on im ankara fabric mask
‘Cyril Ramaphosa and dat mask go be di meme from today until Covid-57,"psychologist and writer Suntosh Pilla tweet.
Di moment "bin lift di national mood" according to business mogul Vusi Thembekwayo, wey suggest online mask challenge.
South Africa president don announce say im go relax some lockdown restrictions starting from next month.
E give economic reasons. But President Cyril Ramaphosa still warn say make most pipo siddon for house, dem still ban public gathering and di kontri border still dey closed.
From 1 May, di kontri go allow some businesses to reopen, and one-third of dia employees fit return to work.
Some schools go also reopen but with strict limits on di number of pipo wey go dey class.
Di kontri bin get one of di ogbonge coronavirus lockdown restrictions for di world, but security forces dey struggle to enforce am.
Di kontri don record 3,953 cases of di virus and 75 pipo don die from am.
President Ramaphosa say di one month-long lockdown work and e don slow di way di virus dey spread but pipo need to eat and to earn dia living.
Di hope to get one antiviral drug to treat Covid-19 don spoil afta report say remdesivir, di drug, fail im first clinical trial.
One Chinese trial bin show say di drug no dey successful, according to draft documents wey World Health Organization do mistake publish.
Di research show say researchers study 237 patients, dem administer di drug to 158 and compare dia progress with di remaining 79, wey dem give di inactive drug.
After one month, 13.9% of di patients wey dey take di drug die compared to 12.8% of those wey dem give di inactive drug. Dem stop di trial early because of di side-effects.
"Dem no associate remdesivir with clinical or virological benefits," di summary of di report tok.
However, di US company wey dey behind di drug, tok say di documents no fully represent di study and di result dey inconclusive.
Court for Kano, northwest Nigeria don fine 15 imams wey police arrest for leading prayers during lockdown N10,000 each and community service.
Tok-tok pesin for Kano state high court Baba Jibo Ibrahim tell tori pipo say court give out di fines to di imams on Thursday.
Kano Police Command tell BBC say dem arrest di imams for various places for Kano as dem dey lead prayers when everybody suppose dey house as per di lockdown wey dey in place.
Kano don enter second week of lockdown after di one day break wey govnor Abdullahi Ganduje give pipo to comot buy things for Ramadan expire today.
Una welcome to our live coverage of di coronavirus palava and how e dey affect di world.
But first make our proverb of di day ginger you.
Di first human trial in Europe of one coronavirus vaccine don begin for Oxford.
Dem inject two volunteers, di first out of eight hundred pipo wey dem recruit for di study.
Half of dem go receive di covid 19 vaccine, and half, a control vaccine wey go protect against meningitis but no be coronavirus.
Di design of di trial mean say dos wey volunteer no go know di vaccine dem dey get, although doctors dem go know.
Elisa Granato na one of di two wey receive di first injection and she tell BBC say ''I be scientist, and i bin want try to support di scientific process whenever i can.