You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Bundesliga fit start for May 9

  2. "Di dead no fit bury diasef"

  3. Coronavirus: 1334 positive Covid-19 cases for Cameroon

    Cameroon Public Health Emergency Centre for dia daily briefing don confirm 1334 positive cases of Covid-19.

    Out of de 1334 positive cases, 668 pipo don recover, 174 dey for hospital and 43 pipo don die since weh Cameroon announce dia first case for March 6.

    For dis Ramadan fasting period, health authorities di advice say make Muslim community pray for house.

    Dis period go start for taim weh kontri and de world di suffer from Covid-19 and e no go bi laik before weh bi di pray for mosque, no bi possible, authorities tok.

    Imams dem don di beg kontri pipo for respect rules for fight dis sick, fast and stay for house and break fast following goment rules.

    Wash hands wit soap and running wata, sneeze for elbow, keep distance and make plenti pipo no gaga for one place.

    Nine out of ten regions affect and e good for take de situation serious respect rules, avoid contact wit any one with flu signs and stay for house.

  4. US Senator Elizabeth Warren brother die from coronavirus

    Former America Democratic Presidential Candidate, Senator Elizabeth Warren elder brother, Donald Reed Herring don die from coronavirus.

    Di lawmaker wey confam di death say Herring die for Tuesday afta im catch di Covid-19 virus.

    Herring na US Air Force veteran wey fly combat mission for Vietnam. He die at di age of 86.

    Senator Elizabeth say she dey grateful to di nurses and frontline staff wey take care of her brother but e dey hard say no family dey near am to hold im hand, tell am say “I love you” one more time.

    Burial no dey for those wey love am to gada together, Warren tweet say “I go really miss you my dear brother”

    Di former presidential candidate no use anytime tok say any member of her family dey sick wit coronavirus.

  5. Coronavirus: 40 health workers don test positive for Nigeria

    Over forty health workers for Nigeria don test positive to coronavirus.

    Di Minister for Health, Osagie Ehanire give dis informate during di presidential taskforce on COVID- 19 briefing on Thursday.

    Oga Ehanire say some odas dey for 14 days quarantine sake of dem dey exposed and no fit contribute dia skills to di health sector.

    E advise workers especially those wey dey frontline make dem always dey protect themselves wen dem dey treat patients.

    “I beg, make una dey careful. Make una no try treat any patients if you no get adequate PPE” Di Minister for HealthOsagie Ehaniretok dis one as e dey refer to health workers.

    As im dey tok about di kontri testing capacity, di minister say di high number of new cases na sake of di better quality testing di kontri get.

    “Di NCDC laboratories get di capacity to test 1,500 samples for 13 laboratories inside one day”

    “We dey test average of 600 samples everyday because na all di samples wey dem collect, dem dey send go test”

    Di minister say di testing equipment fit no dey work as e supposed to because of how dem dey collect di sample and how dem dey transport am, but all dis go change for better if dem put money for logistics.

  6. Di Chelsea football star wey dey buy masks for Sierra Leone traders

  7. President Buhari become ‘Champion of COVID-19 response’

    Di Presidents of West African countries under di aegis of ECOWAS Authority of Heads of State and Government don appoint Nigeria President Muhammadu Buhari as Champion of di COVID-19 response.

    Di personal assistant to di president on New media, Bashir Ahmad put am for tweet

    President Buhari bin participate for di Extraordinary Session of di Heads of State and Government of di ECOWAS on Thursday through teleconferencing.

    Di meeting na to discuss di current COVID—19 situation for di region and di impact of di Pandemic on ECOWAS sub-region.

    Meanwhile, di Presidents for di extraordinary summit dey call say make dem cancel all dia gbese.

  8. See di one month old baby wey recover from coronavirus

    A one-month-old baby wey be di youngest coronavirus patient for Thailand don recover.

    Doctors bin use four antiviral drugs to cure di baby, one Reuters report bin quote di paediatrician wey treat am.

    "Di strategy wey dem dey use treat di child na to give am medication for 10 days. We conduct a check on am every day and three to five days after that. Im X-rays show signs of gradual recovery," Visal Moolasart of di Bamrasnaradura Infectious Diseases Institute for Bangkok tok.

    Currently dem get 2,826 confam cases for Thailand and 49 pipo don die from di virus.

  9. Coronavirus: ‘No be Police dey sabotage border security’ - New Rivers Police Commissioner

    Di new Police Commissioner for Rivers State, Joseph Gobum Mukan say no policeman dey allow pipo pass border against di closure of border rule wey dey Rivers State.

    Im tok dis one as im address tok tok pipo for Port Harcourt for di first time since im resume work officially on Monday.

    Im tok say no be only Police dey man di borders so make dem do proper investigation to find out wetin happun.

    Governor Nyesom Wike wen im dey sign di third executive order sake of di coronavirus palava wey set up special taskforce to man di state borders, bin observe say some kain sabotage dey for some Federal security agencies wey dey di borders as pipo still dey pass border, dey break di order wey close all borders for di State.

    CP Mukan say im dey committed to enforce di Inspector General of Police order to maintain law and order.

    and protect lives and property of pipo for di State.

    “Do wetin I do and do wetin I tok, na so I go take lead by example because na open door policy I go run and I pledge to work well with di Rivers State goment to make sure say pipo live and do business peacefully for di State.” Na so CP Mukan tok.

    Im add say im go adopt community policing to gada better informate and go tackle crime before e happun with ogbonge intelligence policing system.

    Im come order Area Commanders, DPOs and oda HODs to monitor dia officers well wey dey enforce compliance on restriction orders for coronavirus so e no go spread, and all di complaints wey don come against dem, im go address am.

  10. How to keep your customer dis coronavirus period

  11. 72 Nigerians for Guangdong province, China test positive

    Seventy-two Nigerians for Guangzhou city, Guangdong Province, China, wey dey wait to return back to dia kontri don test positive to coronavirus.

    Authorities release di results of 56 of dem on Tuesday, and although dem test positive, dem no dey show any symptoms at all.

    Before dis time, sixteen Nigerians bin don test positive to di virus making di total number 72.

    Chinese authorities say 65 pipo bin get contact wit some of di infected pipo and dem dey try trace dem.

    Inside note wey di Foreign Affairs Office for Guangzhou Municipal People’s Goment, send give Nigeria embassy for China and Chinese embassy for Nigeria, dem say “according to di infomate wey Guangzhou Municipal Health Commission on April 21, dem currently get 16 confam cases and 56 positive test case among Nigeria pipo wey dey Guangzhou, plus 65 case of contact.

    “We dey invite di Consulate General of di Federal Republic of Nigeria wey dey Guangzhou to supervise Nigeria kontri pipo for Guangzhou, so dem go obey di law of di Pipo’s Republic of China to prevent and control di infectious disease.”

  12. In case you just dey join us

    Dis na di latest tori from around Africa.

    • Lagos state commissioner for health, Prof. Akin Abayomi dey encourage pipo to take responsibility and begin wear face mask
    • Super Eagles captain Ahmed Musa say im and e family dey on 14 days self isolation afta dem return from Saudi Arabia.
    • International Monetary Fund (IMF) don approve $363m aid package to help di Democratic Republic of Congo fight coronavirus.
    • WHO sama warning on top yellow fever outbreak for Ethiopia
    • Two police officers for Mozambique enta kasala ontop accuse say dem beat one man to death.
    • Chelsea footballer Antonio Rüdiger don begin one campaign to gada money buy face masks for traders for Sierra Leone.
    • Ghana Police Service order some 8,000 police officers on frontline of covid-19 fight say make dem self quarantine.
  13. Antonio Rüdiger wan buy masks for market traders for Sierra Leone

    Chelsea footballer Antonio Rüdiger dey start one campaign to gada money buy face masks for pipo wey dey sell for market for Sierra Leone.

    Rüdiger say im dey hope say di masks go protect dem and stop di spread of coronavirus.

    He tweet say im foundation go join bodi wit Mary-Ann Kaikai of Madam Wokie Fashion and di charity Lunchbox Gift to provide 60,000 face masks.

  14. Social distancing: See wetin two metres look like

  15. In case you just dey join us...

    Dis na di latest updates from around di world.

    • European leaders go do video meeting today as dem dey ready to sign 540bn pounds emergency fund to protect European workers, businesses and kontris wey coronavirus outbreak affect well-well.
    • Bosnia-Herzegovina na one of di few kontris wey no gree children comot outside sake of coronavirus. Now one court for di kontri say di order wey no allow make children and pensioners dey waka as dey like dey against di law. Authorities get five days to comot dat order.
    • 440 pipo for Spain don die sake of Covid-19 in di past 24 hours. Dis wan don increase di death rate for di kontri to 22, 157.
    • Belgium don report anoda 230 deaths in di past 24 hours, most of dem na pipo wey dey for care homes.
    • Finnish Prime Minister Sanna Marin don begin work from house afta one staff wey dey work from her official house get contact wit pesin wey catch coronavirus.
    • Turkey don begin four-day lockdown for across dia 31 provinces. Some stores and workers no go follow join di curfew.
    • Spain coronavirus death toll don pass 22,000.
  16. Finland PM dey self isolate

    Finland Prime Minister Sanna Marin dey self-isolation afta one pesin wey dey work for her house go near pesin wey dem confam say get coronavirus.

    Statement from her office say di prime minister don do di coronavirus test and she no dey show symptoms for di virus.

    Di 34-year old bin gada attention all over di world wen she become di youngest pesin to be head of state, she take over office for December last year.

  17. Trump don sign order to suspend immigration green card - See who e go affect

  18. Police gbab two pipo wey escape from quarantine inside bar

    Police for Kenya don arrest two pipo wey escape from coronavirus quarantine for di capital, Nairobi.

    Dem dey among dozens of pipo wey show for trending video of pipo wey dey jump fence of one quarantine centre to escape.

    Dem arrest di two pipo as dem dey drink for one bar for Roysambu area, north of di city, and dem carry dem go back to di quarantine centre.

    Di two dem arrest tok say dem plan to escape since dem no gree test dem. Dem also complain say dem tell dem to pay dia pay di quarantine bills and dem no fit afford am.

  19. 8,000 frontline police officers dey self quarantine for Ghana

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin

    Ghana Police Service order some 8,000 police officers on frontline of covid-19 fight say make dem self quarantine.

    Police say health officials take samples of de officers for testing, dem go know dema results while dem dey under self-quarantine.

    During de three-week partial lockdown on parts of Ghana, govment put these 8,000 officers for street top make dem enforce de lockdown.

    Director of Public affairs, Superintendent Shiela Abayie-Buckman talk say “we encouraged dem to self-quarantine and shun dey mingle plus people.”

    “Around Accra, Tema, Kumasi we dey look at not less than 8,000. De Police Hospital take dema samples” she add.

    Ghana Covid-19 cases dey stand at 1,154, 120 people recover, wey 9 people die.

  20. WHO don warn pipo about 'Madagascar herbal cure' for coronavirus

    World Health Organization (WHO) don tok say no proof dey of any cure for Covid-19 afta Madagascar president launch one herbal coronavirus "cure".

    Madagascar national medical academy (Anamem) don also say dem dey doubt weda dis herbal medicine wey Andry Rajoelina tear rubber fit cure or prevent di disease.

    Dem say di herbal medicine get di potential to damage pipo health as e be say dem neva give any "scientific evidence" about di medicine.

    Dis week, Madagascar president bin launch one locally made herbal tea wey im claim say na for both prevention and cure for coronavirus, upon di fact say health experts don say no cure or vaccine for di virus yet.

    Im call dis herbal medicine, Covid-Organics, and dem produce am from artemisia plant - wey be di source of one ingredient wey dem dey use for malaria treatment.

    Dem also add oda Malagasy plants for di medicine. But WHO tok for statement to BBC say dem no recommend "self-medication with any medicines as prevention or cure for Covid-19".

    Di organization re-quote wetin dia head Tedros Adhanom Ghebreyesus bin don tok before say "no short-cuts" to finding effective medicine to fight coronarvirus.

    International trials still dey go on to find beta treatment, WHO add.