Nigeria Centre for Disease Control don announce say dem don get additional two new coronavirus testing laboratories for Lagos and Ogun state Dis don bring di total number of testing labs for Nigeria to 17.
Dis go help NCDC increase di number of pipo wey dem go test everyday.
Di Archbishop of Camerooncommercial capital, Douala, don deny report say im don find cure for Covid-19.
Local tori pipo bin report say last week Bishop Samuel Kleda bin offer to treat pipo for free. Kleda say na lie, even though im don dey study some plants for long time.
New Zealand don begin ease some restrictions after dem spend almost five weeks for lockdown. Schools and businesses fit reopen now but must observe social distancing.
For di second time in two weeks, High court for Malawi don stop di goment from putting lockdown order to prevent di spread of coronavirus.
Malawi currently get 36 cases of coronavirus and three pipo also don die.
France go soon make wearing of face masks compulsory wen pipo wan enter public transport and for secondary schools wen dem reopen.
According to Prime Minister Edouard Philippe, Schools go open again on 11 May starting with primary schools and kindergarten. Shops and markets go also reopn on di same date.
Still on France, di kontri don ban all sporting events including playing without fans until September.
Dis one mean say di top two divisions for France wey bin dey hope to resume on 17 June don end.
If di Tokyo Olympics games no happun for 2021 we go cancel am, na so di games oga Yoshiro Mori tok.
Health experts dey fear if di Games fit hold without any vaccine or cure wey dem don find to treat covid-19.