You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. Trump get ‘high confidence’ say coronavirus come from one 'lab for Wuhan', But US intelligence say di virus no be man made

    US President Donald Trump don lash out again, dey accuse both China and di World Health Organization ontop di pandemic.

    Im say im get “high degree” of confidence say di virus come from one Chinese lab – adding say im no dey allowed to tok whether China “make mistake” or do “sometin on purpose”.

    US intelligence officials bin tok before say Covid-19 “no be virus wey man manufacture or genetically modify”.

    Trump bin don suggest say China no warn di US because dem wan dabaru im re-election bid.

    Im also blast WHO say “shame suppose dey catch dem” as dem “be like mouthpiece for China”.

  2. One million pipo don recover from Covid-19 worldwide

    Figures wey dey comot from today headline show say at least one million pipo don recover from coronavirus out of three million cases around di world.

    Covid-19 get low death rate wey mean say almost all di three million cases go later recover, even though for some cases, e fit take long time.

    But how many go really recover?

    Dat one depend on how many pipo wey catch di virus go die - something wey we still no know.

    Medical journal The Lancet dey suggest say di death rate high pass influenza own (0.1%) and e low pass Sars (9.5%).

    But because say testing dey different from kontri to kontri, na only di ratio of deaths to confam infections we fit see.

    Wen dem dey test only pipo wey dia symptoms dey strong well- well, di death rate go normally high pass 1%.

    For reality, e dey likely say many pipo go catch di virus and dem no go even record am – meaning say di death rate dey lower dan wetin “official” ratios fit dey suggest.

  3. Sports round-up: Premier League players dey 'fear'

    • Manchester City striker Sergio Aguero say players dey 'fear' say dem go need to return to action in di middle of di coronavirus palava. Dem suspend Premier League since 13 March - but clubs say dem remain committed to play di season 92 remaining fixtures
    • Paris St Germain don collect di award of di Liguw 1 title afta dem announce say di season no go resume.
    • Rugby league for England go collect £16m in government loans to help dem recover from di impact of di pandemic
  4. South Africa dey relax some lockdown restrictions

    South Africa dey relax some of im lockdown restrictions today.

    Some businesses go dey allowed to reopen, restaurants go fit deliver food, and families go dey allowed to leave dia house go exercise.

    But in some areas, South Africa five-week lockdown go remain just as strict as e dey before.

    Di sale of alcohol go still dey banned. Dis restriction don help keep di kontri hospital wards empty.

    Goment go also deploy more troops for di streets and impose overnight curfew.

    Security forces don face tok say dem dey do anyhow. Now, dem fit deploy tens of thousands of extra troops to patrol di streets.

    Goment – wey so far don collect accolade say dem move fast to fight di virus – go now need to balance di need to keep di infection rate down with di risk of growing frustration and hunger inside kontri wey already dey face issue of inequality and get economic struggles.

  5. NCDC report 204 new Covid-19 cases in a day

    Di Nigeria Centre for Disease Control report 204 new cases of Covid 19 for di kontri, to make di total confam cases 1932.

    According to di NCDC, 71 percent of all di cases na from three states, wit di highest number from Kano state wey get 80 new cases, Lagos wey get 45 new cases and Gombe wey just record 12 cases.

    So far, 319 pipo wey bin get di virus for Nigeria don recover and 58 don die.

  6. Una good morning!

    Welcome to our every day live coverage ontop coronavirus and how e dey affect di world.

    Make dis proverb ginger you today.

  7. Una na Good Night!

    Na here we go march break ontop Thursday 30 April, 2020 coverage of coronavirus. Friday 1 May, 2020 na anoday day.

    Make we leave una wit dis Twitter post from NCDC & remember to wash your hands always.

    From Moseph, Annette, Ronke, Yemisi and Daniel, una bye-bye.

  8. Coronavirus: Kenya surprise widow wey cook stones for her children

    Kenyans don rally round one widow wey dey cook stones for her eight children to make dem believe say she dey cook food for dem.

    Peninah Bahati Kitsao wey dey live for Mombasa hope say, sleep go catch dem as dem dey wait for dia food.

    Na one of her neigbhour wey di mata shock, call tori pipo to come see wetin her eyes dey see.

    Madam Kitsao dey always wash cloth for pipo, but di lockdown and social distancing sake of coronavirus no gree her fit get work again.

    Afta Kenya NTV interview her, di widow don receive money through fone and for bank account wey Ms Momanyi helep her open as she no sabi read and write.

    Di widow dey live wit her eight children inside two-bedroom house wey no get water or electricity.

    She say di generosity wey she receive na "miracle".

  9. "Many pipo for Lagos wey test positive to Covid-19 no fall sick" - Lagos Deputy Govnor

    Lagos goment don tel pipo for di state make dem follow guidelines wey dem release to stay safe as dem dey try relax di lockdown.

    Deputy govnor, Babajide Hamzat naim tok dis one wen BBC Pidgin do tok tok wit am on Thursday to hia update ontop Covid19 mata for di state.

    E say di number wey dey increase now for people wey test positive na sake of say dia health workers dey do plenti testing, and dey cover plenti areas.

    Ontop face mask mata, E tell Lagos pipo say if pesin get enough face mask, make dem share give others as di one wey goment go share no go fit reach every body.

    E add say "many pipo for Lagos wey test positive to Covid-19 no fall sick".

    Oga Hamzat say goment go share safety equipment give market pipo so dem go dey protected to sale dia good.

  10. Coronavirus: Russian PM Mishustin test positive for virus

  11. Breaking, Cameroon relax rules even as Coronavirus cases hit ceiling

      • Author, Leocadia Bongben
      • Role, BBC Pidgin, Yaounde
  12. Coronavirus: Los Angeles offer free virus testing for all dia residents

  13. Nigeria election office no go resume for 4th May

      • Author, Annette Arotiba
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
  14. DR Congo confam cases of COVID- 19 for Prison

      • Author, Annette Arotiba
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
  15. Di rare picture of minister wey back him baby during Zoom meeting

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
  16. COVID-19 Latest updates

  17. Papa wey reject son become COVID-19 Ambassador

      • Author, Olaronke Alo
      • Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
  18. Coronavirus treatment: I don approve make dem use chloroquine take treat COVID-19 – Bauchi Governor