You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.

Take me to the main website

Children fit spread coronavirus if schools reopen?

All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.

Live Coverage

Daniel Semeniworima

  1. "Stay for house to ‘know your wife better during dis pandemic", Kenya President dey advice men

    President Uhuru Kenyatta don ask Kenyan men to take dia time during di new coronavirus pandemic to stay for house and sabi dia wives better.

    Tori be say, currently, majority of Kenyans no fit comot for house afta goment say make non essential workers stay for house.

    As im dey tok for State house on Friday during Worker's Day, celebration, President Uhuru ask Kenyans to get better relationship with their families. Tori pipo for CitizenKe report am.

    "To stay for house dey hard but e no dey easy, but dis na chance to get to know our grandparents, our pikin wey dey house,” President Uhuru tok.

    “Make we no dey always look di negatives, opportunities dey to get to know each oda now and better things fit come from am.“ he add am.

  2. Breaking, Nigeria don climb pass 2000 cases of Coronavirus, Nigeria don record 238 new cases of COVID19

    Nigeria on Friday 1 May, 2020 record 238 new cases of COVID19.

    See di break down from Nigeria Centre for Disease Control:

    92-Kano

    36-FCT

    30-Lagos

    16-Gombe

    10-Bauchi

    8-Delta

    6-Oyo

    5-Zamfara

    5-Sokoto

    4-Ondo

    4-Nasarawa

    3-Kwara

    3-Edo

    3-Ekiti

    3-Borno

    3-Yobe

    2-Adamawa

    1-Niger

    1-Imo

    1-Ebonyi

    1-Rivers

    1-Enugu

  3. See Nigerian prophets wey dey 'climb mountain for Covid-19' and how pipo dey react

  4. Una na Good Night!

    Na here we go march break ontop our coverage of coronavirus.

    We go see una tomorrow.

    Make we leave you wit dis Twitter post from NCDC & remember to wash your hands always and stay safe.

  5. Rivers State fit do quick testing as dem get 3000 kits

    Rivers State don get PCR Machines and 3000 testing kits and reagents to do local Covid-19 test for di State.

    Two oil companies bin don donate di Gene expert PCR machine and Polimaris Chain Reaction (PCR) Machine wey go work with di testing kits and reagents wey former Governor of Rivers State, Dr. Peter Odilidonate to do test for Covid-19 for di State.

    Before di state go send samples to Irrua Specialist Centre for Edo State for testing but with dis equipments, dem fit do more COVID19 test faster.

    Governor Wike say dis na di time for pipo and companies for di State to join body fight di coronavirus to save lives as di virus no sabi political party or ethnic group and e no dey respect any pesin.

    Di state Commissioner for Health, Prof. Princewill Chike add say dem dey di cluster stage of di disease with di 13 cases wey di State don record wia 9 cases dey active, so dis machines go help di monitoring team test more pipo faster for di state.

  6. Chroloquine fit fight coronavirus?

  7. Exclusive: Doctor wey manage Nigeria first case of coronavirus don test positive to COVID-19

  8. UN, WHO send 3,000 staff go Kano to respond to di pandemic

    United Nations and World Health Organisation don send 3,000 staff go Kano to respond to di pandemic.

    Chairman of di Presidential Taskforce on Covid-19, Boss Mustapha, make di announcement for Abuja on Friday as im dey give lattest update on do coronavirus pandemic.

    Oga Mustapha say di collabo wey federal and state taskforce dey do for di state don dey show small beta result as dem increase testing, contact tracing and isolation for Kano state.

    “Although di number of cases wey dey come from Kano reach to worry, wetin dey happun around di world show say dem dey discover cases wey dem bin no discover before and dem create big opportunity for detection and isolation, care and management.”

  9. I no die o! – Na’Abba

    Former Speaker of Nigeria House of Representatives don come out to say im still dey alive afta rumours spread say coronavirus kill am.

    Inside one video, Oga Ghali Umar Na’Abba, use im mouth do announcement say tori wey dey spread say im die na lie.

    Tori wey bin go round be say Oga Na’Abba die for London hospital afta dem do am operation.

    But di former Speaker dimiss di fake news for video wey Nigeria President Muhammadu Buhari assistant on New Media, Bashir Ahmed bin share.

    Im say “I dey alive and i dey very healthy.”

    Im use di opportunity say sorry to all di pipo wey lose dia friends and family for di deadly pandemic.

  10. Nigeria goment to deploy 14 Health specialists to Kano

    Di Nigeria health authority yarn give say a team of 14 specialists go arrive Kano state, north west Nigeria on Saturday.

    Di Minister of Health, Osagie Ehanire wey tok dis one for di daily Presidential Taskforce briefing say di multi-sectoral team of specialists come from NCDC, NPHCDA, Dept. of Hospital Services, Dept. of Family Health, Infectious disease specialists from Irrua, Edo state, and Media, Special Adviser and dia work na to help launch training for Kano state.

    “ Di main focus of di intervention na on training and capacity building of State healthcare workforce along various specialties on a massive scale”. “ On case management, medical, nursing and cleaning staff shall be trained or re-trained” di minister explain.

    Oga Osagie say di primary health care office( NPHCDA) go engage dia extensive network for Kano state to drive testing demand for grassroots through community mobilization, so that NCDC testing strategy go dey kampe.

    Di DG NCDC, Dr Chikwe Ihekweazu say so far di daily testing capacity don increase as di agency test about two thousand pipo on Friday -wey be di largest testing so far.

    E say as e be now, no state for Nigeria get adequate bed space to treat pipo wit covid 19. Oga Chikwe also explain give say so far di agency don trace 12 thousand pipo since di outbreak for Nigeria.

  11. Ghana extend land, air den sea border closure by one month

      • Author, Favour Nunoo
      • Role, BBC Pidgin

    President Nana Akufo-Addo extend border closure for Ghana borders by one month.

    De border closure go affect land, air and sea travels, but cargo goods go fit enter de country.

    According to Prez Akufo-Addo dis decision go take effect from 4th-31st May, 2020.

    “Dis restrictions no go be permanent feature of wanna lives. But dem be essential for wanna survival now” he explain.

    Prez Akufo-Addo announce dis decision during en virtual May Day address to recognize workers for Ghana.

    Despite say today be May Day celebrations, Ghana no hold any event sake of Covid-19 pandemic.

    Covid-19 cases for Ghana reach 2,074 out of which 212 people recover wey 17 die.

  12. Zimbabwe free more prisoners ontop coronavirus amnesty

    Zimbabwe don grant clemency to more prisoners, ova di coronavirus pandemic.

    According to a goment statement, those wey dey face life sentences and wey don serve at least 20 years of that sentence fit get be release.

    Dem release about 1,500 prisoners in March but prisons remain overcrowded, with a total of 20,000 inmates against 17,000 capacity wey di prison fit take

    Di amnesty bin free all female prisoners except those dem convict of violent crimes. All juveniles and those wey get terminal sickness no dey released.

    Men wey don serve at least a quarter of their three-year prison sentence go also dey free.

    Zimbabwe don grant more than one dozen amnesties ova di years to reduce di amount of pipo wey dey prisons, but e remain overcrowded.

    According to official figures, coronavirus bin slow to spread for Zimbabwe, but fear dey say di kontri health facilities no go fit cope if numbers increase.

  13. Australians for Africa need to ‘shaperly comot’

    Australia High commissioner to Nigeria, Claire Ireland don advise her kontri pipo wey dey Africa to take di next available flight comot if e dey possible.

    Madam Claire say her message na specifically to Australians wey dey for West Africa kontris like Nigeria, Benin, Cameroon, Gambia, Niger and Gabon.

    She tok dis one for inside tweet wey she post for social media.

    Dis decision according to her na because “Australia goment no fit guarantee access to medical service or safe exit if di situation worse.

  14. 'E be like dream wen dem sack me' - Nigerian workers narrate how coronavirus don affect dem

  15. If you just dey join us....See di latest from around di world.

    • Di world dey mark Workers day ontop lockdown and May Day rallies dey take place globally in support of workers' rights - but na for low key or social-distance way.
    • Federal goment of Nigeria don release new Covid-19 guideline say beginning from May 4, any pesin wey dem catch witout facemask for public dem go cari am go court.
    • South Africa's Treasury don draw ear give say between three and seven million pipo for di kontri fit lose their jobs because of di effect of di coronavirus pandemic on di economy. Di finance minister tok sat "di fact be say di lockdown don bring di economic activity to a standstill’’.
    • India don extend lockdown for another two weeks from 4 May. India be one of di first countries to impose heavy travel restrictions, including suspending most visas and stopping all international flights. More than 1,100 pipo don die afta contracting di virus.
    • Di UK government dey ready to help those wey dey affected by job cuts for Ryanair and other airlines. Di goment tok for Downing Street say dem go discuss “support” for aviation firms “as a last resort”.
    • UN don draw ear give say Millions of children dey at risk of missing "life-saving" vaccines, afta di "massive backlog" of shipments wey don build because of di coronavirus pandemic.
  16. Lockdown with my abuser: 'He tell me say e go kill me'

  17. Kenyan president defend why im send flowers to di NHS

    Kenya's President Uhuru Kenyatta don respond to criticism afta di kontri send plenty flower to UK National Health Service workers.

    Di president say di move dey strategic as di UK na huge market for Kenya flowers.

    "Dey say friends remember each other during trouble," he add.

    President Kenyatta say life dey afta coronavirus and when one British health worker go buy flower dem go want di one from Kenya as na di kontri wey recognise their efforts during di pandemic.

    Kenya's NTV channel get di footage of his speech:

    Some Kenyans for social media bin deyaccuse di goment of "misplaced priorities" for sending di UK flowers during di pandemic.

    One Dr Mutwiri Wilson tweet "Our president send flowers to UK, while for im own kontri, bed no dey for di poor Kenyans wey dey quarantine,".

    "Flowers to European nurses as Kenyan nurses dey threaten to strike due to lack of PPE," Yawa Jomoko write.

  18. “Anyone wey no wear facemask, dem go cari am go court''.- Nigeria goment

    Federal goment of Nigeria don release new Covid-19 guideline say beginning from May 4, any pesin wey dem catch witout facemask for public dem go cari am go court.

    Dis na part of di new guideline wey dem release for di new phase of containment wey go begin for May 4 reach May 17, 2020.

    Di guideline wey secretary to di goment of di Federation, Boss Mustapha sign, add oda informate on di kain activities wey dey allowed like how pipo di kontri pipo, states plus security agents behave for dis new phase.

    Oga Mustapha say, “anyone wey im tempreture high pass 38 degree centigrade must to go back to im house den call Nigeria Centre for Disease Control NCDC, to come check am.

    “Anyone wey no wear facemask or cover in nose and mouth, dem go ask am to go im house and dem go cari am go court.

    “Anyone wey break curfew and im case no be emergency situation, dem go cari am go court.

    “Anyone wey break di law of interstate movement as dem put am for dis guideline dem go cari am go court.”

  19. Coronavirus: British High Commissioner special message for UK nationals wey trap for Ghana

    Di British High Commissioner to Ghana don send special message for UK nationals wey trap for Ghana sake of COVID-19 palava

    Iain Walker say di UK in Ghana team don dey working around di clock wit die goment of Ghana, to organise di 4th charter flight for UK nationals wey dey still inside Ghana afta dem visit.

    Oga Walker say di flight go take off on 8 May from Accra to London.

  20. Spain coronavirus death toll rise to 24,824

    Spain coronavirus death toll rise to 24,824 on Friday as 281 more pipo die from causes related to di disease.

    Di day before, di death toll be 268.

    Di kontri health ministry add say di number of new Covid-19 cases rise to a total of 215,216 from 213,435 di day before.

    Spain, one of di worst affected countries, recently announce four-phase plan to lift dia tight lockdown measures and return to "new normality" by di end of June.