You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Children fit spread coronavirus if schools reopen?
All di latest tori ontop coronavirus from all ova di world.
Live Coverage
Daniel Semeniworima
New NCDC Bill for Nigeria, dis na three important facts you need to know
COVID-19: Govnor Sule order Nasarawa House of Assembly to close down, afta one honourable die of cororonavirus
Article Information - Author, Dooshima Abu
- Role, BBC Pidgin, Abuja
Di Nasarawa state goment on Sunday decide to close di House of Assembly for di north central state for Nigeria, to speed up contact tracing of all those wey come in contact wit one honourable wey die of coronavirus.
Tori be say Honorable Adamu Suleiman die of COVID-19 but na afta e die dem find out.
Hon. Suleiman bin dey represent Nasarawa Central and e be di first pesin to die of di virus for di state.
Honourable Suleiman die on Thursday for Keffi town afta e fall sick and dem admit am for Federal Medical Centre.
Gov. Abdullahi Sule wey give di announcement on Sunday for Lafia, say closing down go epp all di assembly members to isolate sharp sharp
And e go also epp to quickly get dia samples for testing in order to prevent di spread of di virus for di state.
Nasarawa, north Central Nigeria don get eight cases of COVID-19 and di govnor say di state dey do all tins to make sure say dem check di spread of di virus.
Di governor yan tori pipo say di victim bin sick and dem admit am for di Federal Medical Centre for Keffi, wia dem collect im sample as e dey show signs of covid 19.
“Before di result go comot, di member don die die and dem come bury am according to Islamic rights for Nasarawa Local Government Area.
“But wen im result came out on Saturday, e show positive to COVID-19".
But before then, plenti pipo bin don attend im burial and dem no know say e die from COVID-19.
“Di member participate for all di Assembly sittings, and dis one don complicate our situation, e explain”.
COVID-19 Latest tori across di world
Nigeria Centre for Disease Control say dem dey fear say di number of coronavirus cases for di knotri go increase for di next few months.
NCDC dey tok dis one as di lockdown wey federal goment bin impose go end dis night by 11:59pm.
Tanzania Presido John Magufuli don tok say di coronavirus test kit for di kontri dey faulty.
Di Presido yan dis one afta dem test goat and paw-paw say dem dey positive for di disease.
E tok dis one today say dis result dey come afta e ask security forces to test di kit to make sure say dem be quality ones.
Di Philippines don press pause for dia program to bring back dia citizens wey trap for oda kontris sake of coronavirus.
Di reason na because space or quarantine centres for coronavirus patients don finish inside di kontri.
Brighton don comot bodi from di plan to play di remaining premier league matches for neutral grounds, dem say e go affect di value of di competition.
But di Premier League organizers say neutral grounds go be di only way to finish di competition sake of coronavirus.
Tanzania go import herb wey Madagascar say fit cure coronavirus
Tanzanian President John Magufuli on Sunday tok say im go contact Madagascar and e go send plane to di island nation to pick di tonic herb wey dem say go cure Coronavirus.
President Magufuli dey speak during di swearing in of di new minister- for legal and constitutional affairs- after di previous minister die suddenly on Friday.
Di president also say samples from francolin bird, goat, papaya and jackfruit come back positive.
Madagascar Presido Andry Rajoelina dey promote one herbal drink wey get Artemisia and oda local plants as cure for di coronavirus.
Presido Rajoelina recently unveil di herbal tonic and some African kontris don already place orders.
But di World Health Organization plus even di kontri national medical academy don tok say no treatment or cure dey ground for Covid-19.
Di WHO confam say treatment trials dey underway across five African countries but no mention di now ‘controversial’ Malagasy ‘cure.’
Tanzanian authorities don dey accused of not taking di pandemic serious.
I need plenti 'litres and litres' of oxygen to survive - UK Prime minister
How una dey?...If you just dey join us.....
Di confam number of coronavirus cases for Nigeria still dey rise with 220 new cases, but as e be so, make you dey wash your hand.
Make you take this our proverb ginger this Sunday morning. Wetin you tink.
How close we dey to get dat special treatment injection for COVID-19?
Kaduna confam 50 cases of Coronavirus from Almajiris wey dem deport to di state
Di Kaduna State Ministry of Health on Saturday evening confam 16 more cases of Coronavirus.
Dis dey bring di total number of confam cases for di North West State of Nigeria to 66.
Di ministry confam say 15 out of di new cases na Almajiris wey dem send come back di state.
And dis dey bring di total number of recorded cases from di almajiris to 50.
Governor El-Rufai bin put lockdown order to stop pipo wey dey come from neighbouring state, Kano and other part of di kontri to enter di state.
He bin tok say na inter state travel dey increase di spread of di virus.
Nigeria confam 220 new cases of Coronavirus
Nigeria don record 220 new cases of coronavirus, making di total number of infection inside di kontrito be 2,388.
Nigeria Centre for Disease Control say di number of pipo wey don die from di virus inside di kontri don also increase to 85.
Una na Good Night!
Na here we go march break ontop our coverage of coronavirus.
We go see una tomorrow.
Make we leave you wit dis Twitter post from NCDC. Remember to wash your hands always.
If you just dey join us...See di latest from around di world
- Kano state goment for northwest Nigeria announce say pipo fit comot on Monday and Thursday from 10am to 4pm to buy food items.
- Lagos bin don discharge 22 more Coronavirus patients
- Greater Accra for Ghana dey lead Covid-19 infections as 1,852 cases out of total 2,169 dey de capital.
- Ethiopia ministry of health say dem neva find any new case of COVID19 in 24 hours-even as dem test 2,016 samples.
- US coronavirus deaths don pass 65,000- Johns Hopkins University
- Di US Food and Drug Administration don give go ahead for di immediate use of Remdesivir drug, wey doctors dey use treat Ebola, to treat coronavirus.
- Italy’s daily death toll today pass 474 afta e fall as low as 260 before. Di reason be say 280 deaths from di northern region of Lombardy in April no dey recorded.
Kano goment go relax lockdown for two days for pipo to buy food
Kano state goment for northwest Nigeria on Saturday announce say pipo fit comot on Monday and Thursday from 10am to 4pm to buy food items.
Govnor Abdullahi Ganduje na im make di announcement from goment house after meeting with di state covid 19 taskforce team.
Govnor Ganduje say major markets no go open unless supermarkets, Yankaba and Yan Lemo markets wia pipo fit go buy food.
Kano dey second only to Lagos for covid 19 for Nigeria with 311 cases and 8 deaths.
''Make all FCT workers wey live outside Abuja, remain for dia different states''
Authorities for Abuja, Nigeria capital say, dem go seriously make sure say pipo for di territory obey di new patial lockdown guidelines wey go begin from May 4.
Di FCT minister Muhammed Bello say, to avoid di spread of coronavirus, im don give order to security agents make dem arrest any pesin wey dem catch dey break di new guidelines plus cari am go mobile court.
Di minister say FCT go seriously make sure say pipo obey di overnight curfew wey go start from 8pm reach 6am.
E no end dia. In add say to prevent pipo wey get Covid-19 for oda states from entering dia territory wit do disease, dem go dey very strict wit di law on interstate travel.
In addition, im don order all di FCT workers wey live outside FCT to remain for dia different states until Dem lift ban on interstate state travel.
for dis reason, all di pipo wey dey work for FCT but dey live for Oda states must to remain for dia state till di ban end.
Lagos discharge 22 more Coronavirus patients
Even as di number of confam coronavirus cases dey increase, pipo dey also recover and di latest tori be say 22 more Covid-19 patients for Lagos don dey discharged.
Di Lagos goment announce for dia twitter page say out of di twenty two patients, eight na female and fourteen na males.
Dem discharge dem from di Isolation facilities wey dey Yaba, Luth and Lekki.
Greater Accra lead Covid-19 infections for Ghana
10 songs wey dey help di world with lockdown
NCDC warning as Lagos, Abuja and Ogun state ease lockdown
Di Nigeria centre for disease control don land with some ogbonge warning even as di Federal goment dey ease lockdown for Lagos, Abuja and Ogun States.
Dis na as e be say di number of coronavirus cases still dey go up for Nigeria even as Kano don take over from Lagos as di states wey dey get di most cases two days in a row.
Among di warning na
- Make pipo get where to wash hand or sanitizer
- Make gathering no pass twenty pipo
- make dem dey regularly check temperature off pipo for public place
- no travel within Nigeria
- make pipo dey always wear face mask for outside
- make dem dey contoll diway pipo dey move for markets
No movement for Lagos workers wey dey live for Ogun state
Ogun state govnor don tell pipo wey dey live for im state dey go work for Lagos say, dem no get permission to comot from di state or enta oda states as dem dey ease lockdown next week.
Dis new order dey inside di latest guideline wey di state goment give as federal goment order partial lockdown for di state.
For announcement wey govnor Dapo Abiodun make on top Facebook on Saturday, im say lockdown for Ogun state go end on Saturday May 10.
Lagos go begin partial lockdown on Monday, and business dem go begin open again.
How young pipo dey keep di spark alive ontop lockdown