Port Harcourt and Obio Akpor local goments wey be di two main bizness districts for Rivers State southern Nigeria go dey on total lockdown from May 7th until further notice.
Govnor Nyesom Wike na im tok dis one for inside state broadcast today.
Di Rivers State Govnor say di decision na to further stop di spread of Coronavirus for di oil rich state inside di Niger Delta region.
E add say hotels, guest houses and beer parlours go remain closed.
For broadcast on Monday, Governor Wike also declare say:
• On no account wey any motor go waka or more than two
pesons gada for dis two local goment, except pipo wey dey on essential services
with appropriate authorization and all shops, trading or business activities,
including currency exchange, must also close until further notice odawise
Goment go seize di property.
• Any pesin, group or institution wey violate di lockdown
and curfew for dis Local Goment Areas go face di law come direct di immediate
arrest and prosecution of Chief B.A. Worgu and Mr. Isaiah Abraka say dem
organize night markets and disobey Goment order.
•Because of di threat by oil and gas company workers for
di State as di newest case of Covid19 for di State na oil worker wey just come
in from Akwa Ibom State on 29 April, dem don review all entry waivers and
permits wey dem bin grant Oil and Gas Companies say from now onwards dem go
look such request on case by case basis, come add say workers for crew change
or oda essential operations must first submit details of dia manifests to di
State taskforce on COVID-19 for proper vetting of dia virus status before they
fit allow dem to enter di State.
•Evri pesin must wear face mask before dem comot for dia house.
• Ban all private motor parks and taxi come order say no
commercial taxi driver go carry more than three passengers per trip and no
commercial bus driver go carry more than 40% of di full capacity of di bus
while Keke NAPEP must carry only two passengers. Private vehicle go carry only
three pesins for di car and evribodi go wear face mask and carry hand
sanitizer.
• Taskforce dey wey go arrest and prosecute any pesin wey
no wear face mask and impound and auction any motor with pipo or passengers wey
nowear facemasks and pick or drop
passengers for private parks wey dem don ban.
• Goment go give one hundred thousand naira (N100,000.00)
to any whistle blower who give informate wey go help dem arrest and prosecute
of any pesin, hotelier or motorist wey violate these directives.
All dis dey di latest Executive order im sign sake of
Corona virus disease.