Trump wan reveal coronavirus origin
- Author, Olaronke Alo
- Role, Broadcast Journalist, BBC Pidgin
US President Donald Trump don tok say im go release details to support di theory say dem release coronavirus from one laboratory for di Chinese city of Wuhan where di COVID-19 pandemic bin start from.
"We go dey report as e be over a period of time," di president tell tori pipo for di White House on Tuesday.
Dem bin link di early cases of di to one food market for Wuhan late last year and di head of di US national intelligence has reject dj conspiracy theories say dem bin wan use di virus as weapon.
But information wey Washington Post see say diplomats don send two warnings to Washington about one Chinese research facility, over fears say di institute's research on bat coronaviruses fit bring a new Sars-like pandemic.
China rejects di idea and dem don criticise di way US dey respond to di crisis.