How Nigerians, world leaders celebrate Buhari

INEC, di electoral joinbodi for Nigeria don declare President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress, APC, di winner of di 2019 presidential elections.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo

  1. Final Presidential Election Results for Kogi State

    Final Presidential Election Results for Kogi State
  2. Breaking, Main opposition PDP dey address tori pipo ontop di election as dem see am

    Main opposition PDP dey address tori pipo for Abuja now.

    Di national chairman Uche Secondus dey tell tori pipo wetin dey worry di party ontop di election as dem see am.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  3. Breaking, Senator Nwaoboshi Peter win for Delta North Senatorial districts

    Senator Nwaoboshi Peter from PDP na im win for Delta North Senatorial districts.

    Delta North Senatorial districts get 9 LGA:

    Aniocha North, Aniocha South, Oshimili North, Oshimili South, Ika North East, Ika South, Ndokwa East Ndokwa West and Ukwuani.

    Registered Voters : 850,967

    Accredited Voters: 239,737

    APC: 36,350

    PDP-186,423

  4. #NigeriaDecides2019result Collation Center for Abuja don resume

    INEC Chairmo Prof. Yakukubu Mahmood say dem go resume wit Ondo state and Kogi

  5. Breaking, Why PDP agent no gree allow INEC to announce result of Godswill Akpabio Senatorial district

    Returning Officer, Dr. W. A Olusende (left) try to explain why im for like announce Akwa Ibom North West senatorial district result for INEC headquarter as im dey fear for im safety.
    Wetin we call dis foto, Returning Officer, Dr. W. A Olusende (left) try to explain why im for like announce Akwa Ibom North West senatorial district result for INEC headquarter as im dey fear for im safety.

    PDP party agent no agree make dem announce di result of di Akwa Ibom North West senatorial district wey concern Senator Godswill Akpabio as im argue say e no align with wetin constitution tok as dem suppose announce di result for di District wey di election happun.

    Dis one mean say di Returning Officer go return to di place wia im run from on Sunday to come announce am for INEC headquarters for Uyo sake of say jaguda pipo threaten im life.

  6. Breaking, Bari Mpiggi win Rivers South East Senate seat

    Barinaadaa Mpigi of di PDP don win Rivers South East senatorial district.

    INEC Returning Officer, Prof. Bisi Mmom declare am winner with total of 247,180 votes.

  7. PDP no agree wit di Presidential election results results from Kano

    "We dey note down all di problems with di figures wey INEC dey announce and after dem finish we go challenge dem because e get many wards wey issues dey.”

    Dis na quote from PDP chairmo for Kano State nort west Nigeria Engr Rabiu Bichi.

    Rabiu Bichi.

    Wia dis foto come from, Rabiu Bichi/Facebook

  8. Jimi Agbaje say PDP no go accept some of di presidential results from Lagos

    Jimi Agbaje
    Wetin we call dis foto, Jimi Agbaje

    PDP Govnorship candidate for Lagos State, Jimi Agbaje say dem no go accept some of di presidential results from Lagos

    Agbaje say violence and intimidation from di ruling party plenti for areas wia PDP get strong leg like Oshodi and Ojo.

  9. Breaking, Cross River South Senatorial Election Result

    Southern Senatorial District

    PDP - 77478

    APC - 63250

    ADC - 420

    Returning office Prof James Ekpoke Former VC UNICAL

    Senator Gershom Bassey na im win as Senator for Cross River South

    Senator Gershom Bassey.

    Wia dis foto come from, Jeremiah Archibong

  10. #NigeriaDecides2019result Collation Center for Abujadon go break

    INEC ok say dem go for 30 minutes break to resume results announcement by 5pm

  11. Kasala don burst for INEC Benue office?

    E be like say kasala wan burst for INEC office for Makurdi as youths wey di support di ruling APC pack demselves for car di shout 4 plus4 come block di INEC gate.

    But military and police pesin quickly block di entry to di INEC office and begin to pushure di bad boys.

    Because of di kata-kata security pipo no allow BBC journalist to take pishure or video

    Kasala don burst for INEC Benue office?
  12. Nasarawa State

    Nasarawa State
  13. APC don take Kwara State

    Kwara result
  14. , Atiku don win FCT

    Abuja result
  15. Army armored tanks don block road for Bayelsa protesters

      • Author, Gift Andrew
      • Role, BBC Pidgin Reporter, Bayelsa State

    Armored tanks of Nigerian army don block road for Yenegoa, Bayelsa state capital for south-south Nigeria wia members of opposition People’s Democratic Party dey do protest.

    Dem say dem dey vex unto say Nigeria election bodi INEC no follow due protest to announce results for some parts of di state.

    Dem accuse members of di ruling All Progressive Congress APC say dem pursue some PDP members from polling booths during Saturday election come go thumbprint ballot papers.

    Di protesters match from di peace park wey dey front of Bayelsa state goment house to INEC headquarters but army no gree make di protesters pass.

    For di two local goment results wey INEC don announce for presidential elections for Bayelsa state, na PDP dey lead wit high margin.

    Wetin we call dis Video, Protesters dey gada for Yenegoa, Bayelsa State capital
  16. Watch as INEC dey announce live result of FTC presidential election

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  17. INEC neva announce Godswill Akpabio result

    INEC oga for Akwa Ibom state, Mike Igini say dem neva announce complete results for Akwa Ibom north west senatorial district (Ikot Ekpene) as dem never use eye see di returning officer for dat district since Sunday night.

    Tori be say di man take off afta e be like say trouble wan start as im dey announce di result for Sunday night. Sake of dat, oga Mike Igini don ask am to come present im result for INEC headquarters.

    Di collation centre for Uyo don go on break wit only one LGA wey remain wey dem neva announce. Di LGA na Essien Udim, hometown of Sen Godswil Akpabio.

    Akpabio
  18. Jimi Agbaje say PDP no go accept results "dem dey don tamper wit"

    Jimi Agbaje dey tok with tori pipo

    Govnorship candidate of di PDP for Lagos State, oga Jimi Agbaje say dem no go accept results dem dey don tamper wit.

    Im say violence and intimidation from di ruling party plenti for areas wia PDP get strong leg like Oshodi and Ojo.

    Im say card readers no even work for some and say na strategy to do magomago.

  19. Dem don begin drag cloth for INEC collation centre for Rivers State

      • Author, Karina Igonikon
      • Role, BBC Pidgin, Lagos
    Wetin we call dis Video, Dem dey drag cloth for Rivers State collation centre

    Plenti drama follow di collation of results for di presidential elections for Rivers State.

    Many party agents greedie for di results from some local goment areas like Asari Toru and Emohua wia di Returning Officers and di Electoral Officers no agree for di results.

    Di State Collation Officer for di Presidential Election SCOPE for Rivers State, Prof. Enefiok Essien SAN, come say make dem step down results from Emohua because of too many irregularities wey full am.

    Oda results wey dem submit on Monday include:

    LGA: Ogu/Bolo

    Returning officer: Sonari Otobo

    Electoral officer: Ezenwa Alozie

    Total No. Reg. voters: 52, 965

    Total Accredited:11,150

    Valid votes: 10, 561

    Rejected votes: 446

    APC: 2148

    PDP: 8221

    Total votes cast: 11,007

    Note: Di returning Officer say dem no cancel any Ward Presidential results.

    _____________________________________________________________________________________

    LGA: Opobo/Nkoro

    Returning officer: Prof. Clifford Ofurum

    Electoral officer: Samuel Udezi

    Total No. Reg. voters:52,069

    Total Accredited: 8070

    Valid votes:7443

    Rejected votes:218

    APC: 3706

    PDP: 3571

    Total votes cast:7661

    Notes: Di returning officer say dem cancel 3 wards. For ward 3, im receive result come see say unit overvote as di number of accredited voters according to di card reader no match wen im mention am, dem go manufacture number and na similar tin of overvoting wey happen for di oda ward 9 and 11.

    _____________________________________________________________________________________

    LGA: Khana

    Returning officer: Okechukwu Francis

    Electoral officer: Okechukwu Obiozo

    Total No. Reg. voters:167,958

    Total Accredited:100,289

    Valid votes:97,400 (computer calculate 97,287)

    Rejected votes:1087

    APC: 5329

    PDP: 89843

    Total votes cast: 98,487

    Notes: Of di 19 wards for Khana, election happun for only 17 wards and election no take place for ward 6 wey get 15 units and anoda ward sake of security palava. APC party agent say di turnout dey questionable as e dey too massive, so e dey cooked. PDP agent say di heavy military presence for PH and Obio Akpor fit make pipo not to come out.

    ______________________________________________________________________________________

    LGA: Asari Toru

    Total No. Reg. voters:41,278

    Total ccredited: 26,642

    Valid votes:26,742 (computer calculate 26,349)

    Rejected votes:300

    APC: 18,180

    PDP: 3175

    Total votes cast:?

    Notes: Party agents observe say many of di figures wey di Returning Officer give change from di one im give on Sunday. PDP Party agent Austin Opara also observe say all di parties get figures so im dey suspect say di figures na fake and dem just allocate figures give all di political parties. Dem don take small break to resume by 5pm Monday.

    ______________________________________________________________________________________

  20. Buhari 2 Atiku 0

    Buhari

    Wia dis foto come from, Bayo Omoboriowo