Di Returning Officer for Asari Tori LGA Glenn Ukomadu wey suppose make some correction for di mistake wey dey dia results sheet don miss.
Im second no fit find am again.
More Presidential results for Rivers State
No. of Registered voters: 60,662
Valid votes:17,963/(Computer count - 17,969)
Total votes cast:18,383/Computer count - 18,388
LGA: Ogba-Egbema-Ndoni - ONELGA
No. of Registered voters: 152,163
Valid votes: No dey available
Rejected votes: No dey available
Di Returning Officer for Onelga, Dr. Uwoma Onwukwe describe APC as ‘di Almighty APC’ and pipo wonder.
Di state Returning Officer Prof. Aniefiok SAN come tell am say make im no describe any party but make im just call di party and dia number.
Some party agents raise objection for di way im describe APC as Almighty APC say im dey bias.
Notes: Dem cancel di whole of Ward 9 wey get 10 polling units and oda 16 units from oda wards because of irregularities because di total number of people wey vote pass di number of people wey dem accredit and also because of violence wey happen dia.
Some party agents raise objections as tins no too square.
Total Reg. voters: 118,125