Three local goment areas for Rivers State no get results for di presidential and national assembly elections wey hold dia.
Di local goments na Ikwerre, Okrika and Ahoada West.
Electoral officers for dis local goment dem - Efeturi Emabwoyam for Ikwerre, Leo Okon for Okrika and Nicky Cleopas Emotimi for Ahoada West, say di plenti violence and military invasion wey hapun dia make dem no fit collate di results.
But State Collation Officer Presidential Elections SCOPE, Prof Aniefiok Essien no accept di results from Emohua local goment because di returning officer Dr. Kpang Meelebari and di Electoral Officer Kenneth Etta no agree for di results.
Even afta di SCOPE tell dem to go organise dia report, political party agents no gree for di magomago wey full di results so di INEC oga patapata for di state come say di results no dey accepted unless di returning officer go provide all di polling unit results sheet wey im take get di results.
So far, 17 local goment don present results for di presidential and national Assembly elections and PDP dey win except for Asari Toru and Opobo/Nkoro wia APC get higher votes.