INEC election materials for Edo State
For Edo State, south-south Nigeria, all di election materials don reach di 18 local governments areas since Thursday, according to ogas for INEC.

INEC, di electoral joinbodi for Nigeria don declare President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress, APC, di winner of di 2019 presidential elections.
Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo
For Edo State, south-south Nigeria, all di election materials don reach di 18 local governments areas since Thursday, according to ogas for INEC.

INEC don finish distribution of elections materials to di 23 local goment areas for Rivers State.
Dem start distribution since Wednesday wen dem begin batch dem into do different LGAs den on Thursday dem start to carry dem go di different local goment.
Head of Voter Education and Publicity Inec Rivers, Edwin Enabor tell BBC Pidgin say two motor for Andoni and Gokana Local goment bin break down so afta dem repair di motor, two of dem comot dis morning
ECOWAS Observers don arrive Cross River state we spot some of them for Inec office for Calabar

Some INEC adhoc staff for Cross River state dey para say them no see dia name for dis week list.
Di pipo wey gather for front of the INEC office for Calabar tok say na dem go training and na dem di election office send last week before dem cancel di election.


INEC for Cross Rivers State, south-south Nigeria say dem go use over 15000 ad hoc staff for di election.
Di election join body say dem don provide buses and every-every wey go carry di ad hoc staff dem go dia different local goment area, including mat too.




Dis police officers dey tie empty water bottles to dia gun to serve as life jacket for di guns in case dia boat get accident ontop river.
Dem follow for officers wey dey go work across di river.



Bashir Ibrahim and Auwal Mohammed na two adhoc staff for Kano north west Nigeria wey just get informate say dem don replace dia names inside di list of workers wey suppose follow INEC workd
Dem feel terrible and dey dey wait for explanations.

Plenti party agents and corps members from different local goments tanda outside INEC office for Yenegoa to follow escort materials to dia area make e for no loss.



Wia dis foto come from, Pipo full Bayelsa INEC office gate

Less than 24 hours to Nigeria general election INEC for Bayelsa state never distribute any sensitive material to any local government area as at 10:30am Friday morning.
INEC Resident Electoral Commissioner Monday Udoh Tom say dem don receive over 95 percent of all di materials dem need for di election, but dem dey expect di remaining five percent.
“We get enough security pipo on ground wey go escort di sensitive materials go local goments, all di materials dey safe and we go send out soon”
E say di remaining five percent no go fit make di election no hold.

INEC for Cross Rivers State, south south Nigeria say dem don move all di sensitive materials from Central Bank of Nigeria office go all di local goment area for di state for di election on Saturday.
Tok-tok pesin for di Independent National Electoral Commission Aneh Etekpi-Kanu tell BBC Pidgin say dem start to move di material on Wednesday from CBN office. Cross Rivers State get 18 local goment area dem.

All di sensitive material for Saturday election for Benue State, north central Nigeria don land di 23 local goment areas for di state.
Di INEC commissioner, Nentawe Yilwatda say na from Wednesday na im dem start to distribute di material to all di Council area.
Wen BBC visit Tarka and Gboko local goment dem, electoral officials dey try sort di materials dem to deploy to di polling unit.
Many of di pipo dia say dem dey ready kampe to come out to vote on Saturday despite di postponement of election by INEC.


Akwa Ibom NYSC members want make INEC treat dem like dia own pikin
Nigeria Youth Service Corps (NYSC) dey beg make Nigeria election body INEC treat dem well before, during and after di elections.
Di Youth corpers say dem no want wetin happun last week to repeat itself as some of dem tell BBC pidgin say dem sleep for open field.
Aniebet Udom wey tok to BBC say "e go dey good if dem provide transport for dem to dia place of posting and better place wia dem go sleep."
For Femi Adebesin, na security im want as im go like "return back to e house di way im take go."
Meanwhile some of di corpers wey tanda for INEC office want dia pay for last week elections wey INEC postpone as some of dem bin don travel go dia area of posting before dem hear di news about di postponement.

Last set of materials dey leave for Doguwa local government of Kano State, north west Nigeria.
Items include sleeping mats for adhoc staff and ablution kettles wey Muslims fit use do prayers.

Nigeria election body INEC for Delta State don distribute all di sensitive materials go di 25 local goment areas for di state.
Bukola Ojeme, di INEC tok-tok pesin for Delta State, south-south Nigeria, tok say dem begin di distribution from Thursday night till dis early Friday morning.
Good Morning!!!
Una welcome to dis live page wia BBC News Pidgin reporters across Nigeria go give you di latest tori about 2019 Presidential and National Assembly election you suppose know.
