How Nigerians, world leaders celebrate Buhari

INEC, di electoral joinbodi for Nigeria don declare President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress, APC, di winner of di 2019 presidential elections.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo

  1. I neva see PDP Returning Officer afta police nab am - Gov. Ortom

    Benue State govnor, Samuel Ortom tell BBC News Pidgin on Sunday evening say im neva see di PDP chief returning agent Dr. Cletus Tyoka afta police pick am for im house on Saturday morning.

    Di govnor say dem bin arrest am on top accuse say e dey mobilise thugs to disturb di election.

    But di governor say di accusation be lie and e dey call on di inspector general of police make e look into di mata and release oga Tyoka.

    Benue State govnor, Samuel Ortom
    Wetin we call dis foto, Benue State govnor, Samuel Ortom
  2. Wia President Muhammadu Buhari di APC Presidential Candidate dey?

    Dis na wia President Muhammadu Buhari bin spend him time earlier today.Na for inside dis farm for im hometown, Daura, Katsina State na im im dey monitor latest tori ontop #NigeriaDecides.

  3. INEC Presidential election result collation drama for Benue

    Benue State govnor Samuel Ioraer Ortom cry enta INEC Benue Office on Sunday evening on top accuse say military don hijack result from Gboko.

    E storm do INEC Headquarters for Makurdi wit oda PDP leaders for di state like former Senate President David Mark.

    Benue State govnor don cry enta INEC Benue Officer on top accuse say military don highjack result from Gboko. E storm do INEC Headquarters wit oda PDP leaders for di state.
  4. INEC final Presidential Election result Collation Centre don open for Abuja

    Na for here inside International Conference Centre Abuja wiai INEC Chief Returning Officer of di 2019 general election Prof. Mahmood Yakubu go declare di winner.

    INEC Chairman don announce how im go declare di presidential election result

    Na by 11am on Monday dem go start to declare results from across di 36 states and FCT Abuja, oga Yakubu tok.

    International Conference Centre Abuja

    Wia dis foto come from, INEC

    Wetin we call dis foto, #NigeriaDecides Results Collation Centre open for International Conference Centre Abuja on Sunday evening around 6:30pm.
    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  5. Live presidential election results from Uyo, Akwa Ibom

    Akwa Ibom get 31 Local Goment Areas.

    Na 1,993,362 voters collect dia PVCs to vote for di state.

    Na inside dis state wey Senator Godswill Akpabio of APC and Govnor Udom Emmanuel of PDP dey show who get power pass.

    SOME RESULTS:

    Mbo LGA with 9 wards

    APC - Muhammadu Buhari - 5299

    PDP - Atiku Abubakar - 4750

    Total valid votes - 10218

    Rejected votes - 271

    Collation officer - Prof Effion Etim Okon Returning officer - Asuquo Bassey

    Presidential result for Ibeno LGA with 9 wards

    APC - Muhammadu Buhari - 1011

    PDP - Atiku Abubakar - 6373

    Total valid votes - 7,898

    Rejected votes - 413

    Collation officer - Dr Lawrence Usit.

    Tori be say APC reject di result ontop accuse say na ojoro di Collation officer do.

  6. Some INEC presidential election result collation centers

    Our tori pipo tanda for di 36 states of Nigeria to get all di confam results from di general election.

    As at now, dis na foto of some of di election collation centre

    INEC collation centre for Bayelsa dey quiet
    Wetin we call dis foto, INEC collation centre for Bayelsa dey quiet
    INEC collation centre for Bayelsa dey quiet
    Wetin we call dis foto, INEC collation centre for Bayelsa dey quiet
    Dem don start to announce presidential results for Akwa Ibom starting with Mbo Local Government Area.
    Wetin we call dis foto, Dem don start to announce presidential results for Akwa Ibom starting with Mbo Local Government Area.
    BBC
    Wetin we call dis foto, Dem don begin announce result for Benue Collation centre.
  7. Live presidential results from Kano

    Na 44 Local Goment Areas dey Kona state for north-west Nigeria.

    Kano get di second largest number of voters for di whole of Nigeria inside dis general election.

  8. First presidential election result from 18 LGAs for Cross River don land

    Presidential result for Akpabuyo local goment of Cross Rivers State.

    Code 03 total number of Polling Units - 129

    RESULTS

    ÀPC -Muhammadu Buhari - 4429

    PDP - Atiku Abubakar - 7767

    SDP - Donald Duke - 88

    Total valid vote- 12637 Void votes - 1001 Returning officer- Prof,Maurice Asuquo

    Cross Rivers State Returning officer  Professor Akii Ibhadode dey write di result.
    Wetin we call dis foto, Cross Rivers State Returning officer Professor Akii Ibhadode dey write di result.
  9. Voting no happun at all for parts of 12 states - INEC

    Chairmo of di Independent National Electoral Commission( INEC) Professor Mahmood Yakubu tell tori pipo on Sunday afternoon say :

    1. Di commission dey happy wit how di exercise go generally for di kontri.

    2. Di commission still dey committed to make sure say noting do di ballot.

    3. E don look di challenges of di exercise last night come change di voting period for di areas wey dey affected.

    4. E accept say di card reader bin get some technical wahala for some states, upon say dem try make sure say di machine work well well.

    5. Note am down say INEC officials and materials late come some oda states.

    6. Voting no happen at all for some places because of card reader wahala and katakata. Dem be: Abia, Bayelsa, Benue, Zamfara, Plateau, Sokoto, FCT Abuja, Rivers, Imo and Lagos. Dem don submit report about Rivers.

    7. Dem kill some Adhoc staff by shooting for Rivers state and Osun state.

    8. National Collation Centre go open by 6pm local time, collation of results from states go start wen di state returning officers reach Abuja.

    9. Only INEC fit declare results – even tho plenti results dey spread for social media.

    10. Di commission go try dia best to make sure say di collation of result and declaration of di election happen sharp-sharp.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  10. INEC go conduct elections today for 39 units across Bayelsa

    INEC for Bayelsa state say dem dey conduct elections today for 39 units across di state sake of card reader issues, late arrival of materials and violence.

    Dia tok tok pesin Wilfred Efogah tell BBC pidgin say na for Ogbia and Sagbama area e dey happun.

    Meanwhile collation of election results for state level never start by 4:30 pm Sunday evening as soldiers block road to INEC head office for Yenegoa, dem no allow anybodi to pass even journalists.

    Collation for state level suppose happun for Yenegoa local goment council, but as at wen dis report drop, police no allow anybodi to near di hall, dem say na until collation start na im pipo go fit enta.

    Road to INEC Collation center for Yenagoa, Bayelsa
    Wetin we call dis foto, Road to INEC Collation center for Yenagoa, Bayelsa
    Road to INEC Collation center for Yenagoa, Bayelsa
    Wetin we call dis foto, Road to INEC Collation center for Yenagoa, Bayelsa
  11. You sef fit chook mouth tell us wetin dey happun for your area

    As Nigerians dey wait for results of Saturday election, pipo dey dey tok left, right and center on top di mata.

    We don even see say for Twitter supporters of di two main challengers dey share tori wey concern di election.

    No worry you sef na for dis page you go see only confam tori as e dey hot.

    You fit use #BBCNigeria2019 send us confam tori of wetin you don see for your area.

    BBC Election Photo
    Wetin we call dis foto, We don even see say for Twitter supporters of di two main challengers dey share tori wey concern di election. APC dey tweet say #BuhariIsWinning while PDP dey tweet say AtikuIsWinning but INEC still dey count results.
  12. "E dey like say I for kill mysef because I no vote"

    Wetin we call dis Video, "E dey like say I for kill mysef cos I no vote"
  13. Breaking, Election still dey happun for some parts of Nigeria - INEC

    Skip X post, 1
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 1

    Skip X post, 2
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post, 2

  14. INEC collation centre don open for Cross Rivers State

      • Author, Fiona Equere
      • Role, BBC Pidgin

    Collation centre for Cross Rivers State don open but na only Akpabuyo local goment result dey ground.

    Na 18 loca goment areas dey inside di state.

    Cross Rivers collation centre
  15. Breaking, PDP and APC dey blame each oda for Akwa Ibom katakata

      • Author, Moseph Ekine
      • Role, Broadcast Journalist Pidgin

    Two of di political parties for Saturday election for Akwa Ibom don accuse each oda for di kasala wey burst for some wards.

    Jaguda pipo scata polling units for Ibiono Ibom, Essien Udim, Etim Ekpo and fire gunshots for Itam according to local tori pipo.

    All Progressives Congress govnorship candidate, Nsima Ekere tell news men say "im no know why di opposition party go use thugs to intimidate pipo as di pipo need to vote who dem want."

    Tok tok pesin for di People's Democratic party, Ini Ememobong for im response tok say "na desperate APC members no want make pipo vote count." For now, INEC nave announce any result for di election or wetin be dia plan for places like Itam for Uyo wey election allegedly no hold.

  16. Former Finance Minister Ngozie Okonjo-Iweala

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  17. Breaking, 41 local goment areas for Kano State neva bring result to collation centre

      • Author, Mansur Abubakar
      • Role, BBC Pidgin, Kano

    Only three local goment areas out of di 44 for Kano state don submit result to di state collation centre.

    INEC Kano Public Affairs oga Garba Lawal explain give dis one, as pipo dey continue dey wait to hear result of Saturday voting.

    “As I dey tok, five LGAs say dem dey road dey bring result, but as at dis morning na only one LGA bring, so we dey wait," im tok.

    Oga Lawal say so far na only three LGAs don bring result come and dem no go start to announce result until dem get 10 LGA results.

    Kano INEC
  18. Benue collation centre don set

      • Author, Dooshima Abu
      • Role, Benue, Nigeria
    Inec official
    Wetin we call dis foto, INEC oga for Benue State dey double-check im paperwork

    INEC collation room don set for Makurdi, di Benue State capital but results neva land.

    Although Benue INEC office don arrange dia collation centre, 23 local goment of di state neva begin bring results. INEC official wey follow BBC Pidgin tok say all di adhoc staff still dey collect di result from di wards and before dem go reach di headquarters e go take some time.

    Even though di result neva begin come,security officers full ground brekete and dem also don block di roads to prevent any jaguda pesin wey go try wan steal or do wuru-wuru for di area.

    Dem also dey do stop and search plus dem no allow any okada pesin to ride pass di area.

    For some of di local goment collation centres wey BBC visit around 9:am, some adhoc staff dey hurry to put finishing touch to dia work. For Makurdi local goment, na only two out of di 11 ward wey neva submit dia result.

    Okada riders
    Wetin we call dis foto, Security dey do stop and search around di INEC office for Makurdi
  19. , E get wetin Davido dey see wey odas neva see? 🤐

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  20. Presidential candidates tok sorry give families of those wey die or wunjure

    Kingsley Moghalu

    Wia dis foto come from, Moghalu Facebook

    Wetin we call dis foto, Kingsley Moghalu

    Presidential candidates of di Young Progressives Party and dat of di Alliance for New Nigeria; Kingsley Moghalu and Fela Durotoye don tok sorry give those wey dia pipo die for Saturday elections.

    Oga Moghalu tok say: "My sorry dey go to those wey dia loved ones die as dem come out to perform dia civic duty. Also those wey wound, those wey no fit vote due to ballots/boxes dem tiff and jaguda pipo; those wey dem force to vote candidate wey no be dia choice..."

    For im own, oga Durotoye tok say: "E dey break heart to hear about pipo wey die and wound because of election katakata across Nigeria. Many families no go fit sleep again forever as e go dey dia mind say pipo wey dem love don die. Nothing worth di pain dem dey feel now."