How Nigerians, world leaders celebrate Buhari

INEC, di electoral joinbodi for Nigeria don declare President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress, APC, di winner of di 2019 presidential elections.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo

  1. Goodmorning and welcome

    Proverb

    Na hia we go begin dis Tuesday Live Page as tori dey happun across Nigeria afta Saturday presidential and national assembly elections.

    Attention don shift go Abuja, wia INEC go announce results from all di 36 states and di FCT.

    BBC Pidgin tori pipo wey dey ground across Nigeria, still dey keep eye to bring you di latest. No forget say we dey Twitter, Instagram and Facebook as BBCNewsPidgin.

    Take dis proverb for dis Tuesday, take hold bodi first.

  2. INEC collation centre for Abuja go resume by 10:00am on Tuesday

    INEC chairmo Prof. Mahmood Yakubu don adjourn di collation of results to 10:00am on Tuesday February 26.

    Prof. Yakubu say dem go start wit di declaration of result from Plateau state afta which im say hopefully dem go get to all di oda states of di federation wey dem neva still declare.

  3. Final Presidential Election Results for Ebonyi State

    Ebonyi State Presidential result
    Wetin we call dis foto, Ebonyi State Presidential result
  4. Final Presidential Election Results for Enugu State

    BBC
  5. #NigeriaDecides2019result Collation Center for Abuja don resume

    Afta 10 states, INEC don start again to call results, beginning with Enugu state.

  6. Buhari dey early lead afta INEC declare 10 states

    President Muhammadu Buhari dis evening go do surprise visit for im Presidential Campaign Office inside Abuja.

    Results wey INEC don announce so far
    Wetin we call dis foto, Results wey INEC don announce so far
    Buhari inside APC Situation room for Abuja

    Wia dis foto come from, APC

    Wetin we call dis foto, Di APC presidential campaign council don accuse di main opposition party, PDP and dia supporters say dem dey assault di democracy for Nigeria.
    Buhari inside APC Situation room for Abuja

    Wia dis foto come from, APC

    Wetin we call dis foto, Inside statement wey di campaign council release, APC say di opposition dey spread fake results for social media wey dey declare Atiku Abubakar as president wen INEC neva even announce di result.
    Buhari inside APC Situation room for Abuja

    Wia dis foto come from, APC

    Wetin we call dis foto, Di APC presidential council warn PDP make dem stop to dey behave like small pikin.
    Buhari inside APC Situation room for Abuja

    Wia dis foto come from, APC

    Wetin we call dis foto, APC say dem get full confidence wia INEC dey say di results go dey free and fair. Dem tell Nigerians make dem dey patient as INEC go soon finish di results wey dem dey announce.
  7. Breaking, Buhari win Kano hands down

    FINAL RESULTS FOR KANO (PRESIDENTIAL)

    APC - Muhammadu Buhari = 1,464,768 (78.9%)

    PDP - Atiku Abubakar = 391,573 (21.1%)

    APC clear all 44 local goment for Kano

    Na ruling party APC win all di 44 local goment wey dey Kano after Presidential elections collation of result end for di state.

    Di result no surprise pipo since na state wey President Muhammadu Buhari dey always win since e start to contest for Presidential in 2003.

    But dis time around some pipo expect tougher fight for am on to say former Kano Governor Rabiu Kwankwaso wey get many supporters for di state dey with PDP.

    Muhammadu Buhari

    Wia dis foto come from, Bayo Omoboriowo

    Wetin we call dis foto, Muhammadu Buhari wen e cast im vote for Daura, Katsina State
  8. Nigeria police vex why jaguda pipo assault Deputy Commissioner of Police for Bayelsa

    Acting oga pata of Nigeria police Mohammed Adamu don send team to enta Bayelsa state for south south Nigeria to find out why jaguda pipo assault one Deputy Commissioner of Police for di state.

    On Sunday, jaguda pipo storm one river jetty for Brass Island and attack di DCP wey dem post to supervise election for dia.

    For statement wey di tok tok pesin of Police for Bayelsa state Asinum Butswat release, e say di team work include to find winch pipo commit di crime, arrest dem and carri dem go court.

    Nigeria police vex why jaguda pipo assault Deputy Commissioner of Police for Bayelsa

    Wia dis foto come from, Other

  9. Breaking, Former Kano govnor Ibrahim Shekarau win senate seat

    Former Kano govnor Mallam Ibrahim Shekarau don win senate seat to represent Kano central for di next National Assembly.

    Returning officer for di senatorial district Prof Isa Sani yan say;

    APC Ibrahim Shekarau get 527,324 while im closest rival Madakin Gini of PDP get 279,321.

    Ibrahim Shekarau

    Wia dis foto come from, Other

  10. Final Presidential Election Results for Yobe State

    BBC
  11. Final Presidential Election Results for Abia State

    BBC
  12. Final Presidential Election Results for Ondo State

    BBC
  13. Breaking, Buhari defeat Atiku for Lagos

    Final result of Presidential Election in Lagos State as announced by Lagos State chief collating officer, Professor Felix Kolawole Salako.

    Total Valid Votes: 1, 089, 567

    Rejected votes: 67, 023

    Total votes Cast: 1, 156, 590

    AAC: 8, 910

    YPP: 5, 733

    ANN: 6, 946

    APC: 580, 825

    PDP: 448, 015

    BBC
  14. We no pay pipo to vote Buhari - Kano APC

    APC inside Kano state for northwest Nigeria yan say wetin PDP dey tok say dem pay money to voters to vote President Muhammadu Buhari no be true.

    For statement wey dem release dis Monday evening, APC add say make PDP no forget say President Buhari don dey win Kano tey tey for past elections so no need to pay pipo.

    Chairman, Publicity Committee, 2019 Elections

    Wia dis foto come from, Abubakar Ibrahim

    Wetin we call dis foto, Chairman, APC Publicity Committee for 2019 Elections inside Kanor Chairman, Publicity Committee, 2019 Elections
  15. Error plenti for Benue result - INEC Collation Officer, Di Drama, Comedy as collation officers submit election result

    Plenti plenti drama na im eye dey see for presidential collation centre for Makurdi, di Benue state capital as many collation officers no fit defend dia result.

    Some of di collation officers present result wey pipo wey vote pass pipo wey dem accredit.

    Di one wey make pipo laugh pass na di INEC Collation Officer from Makurdi, Livinus Tuleun.

    Na so dem come di ask am kwesion left right and centre e come explain say some polling unit, dem no use card readers and dat one make am difficult to add di numbers correctly.

    Odas e be like say dem no understand election mathematics as dem struggle wit calculators for hours to arrange dia election result.

  16. Breaking, Elections for Rivers East senatorial district don hang

    INEC Returning Officer Prof. Paul Eke don declare elections for Rivers East Senatorial district inconclusive.

    Sake of di violence wey happen for Okrika, Emohua and Ikwerre local goment for di election, di returning officers from dis local goment say dem no get complete results from some wards and units and irregularities for number of pipo dem accredit and pipo wey dem say vote.

    Tori be say di margin of difference too wide to declare result so di INEC Returning Officer for Rivers East Senatorial district, Prof. Paul Eke declare di election inconclusive.

  17. Senator Florence Ita-Giwa dey beat her chest for Cross River State

    Senator Florence Ita-Giwa say People's Democratic Party no fall hand for Cross Rivers State.

    So far PDP don win di presidential election for all di fourteen local goment area wey INEC don announce results inside Cross River.

    Madam Ita-Giwa tell BBC Pidgin say e too early to tok how di party perform nationwide.

  18. 91 EU observers position ontop #NigeriaDecide2019

    91 EU observers wey visit 261 polling units across 31 states during Nigeria general election say election workers no follow important procedures all di time.

    Dem tell tori pipo for Abuja say around 14% of dis areas di important material dey miss

    EU observers

    Wia dis foto come from, EU observers

  19. US ambassador say Nigeria election dey generally peaceful

    US ambassador to Nigeria, Stuart Symington don hail Nigerians wey come out to vote for di 2019 general election wey just happen on February 23.

    Oga Symington say di election bin dey generally peaceful even tho small katakata happen for some areas. Im tok sorry to di all di pipo wey lose dia family member for di election katakata.

    US ambassador to Nigeria

    Wia dis foto come from, US Embassy

  20. Final Presidential Election Results for Gombe State

    Final Presidential Election Results for Gombe State