How Nigerians, world leaders celebrate Buhari

INEC, di electoral joinbodi for Nigeria don declare President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress, APC, di winner of di 2019 presidential elections.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo

  1. Welcome, di day many pipo dey wait for don come

    Na hia we go start our tori dis Saturday, wey be special day for many Nigerians. From 8am, pipo go begin vote to elect president and national assembly members.

  2. Until tomorrow..

    Na dis pishure of gallant police men from Kano wey don ready for di election we go use take march break today.

    Make una join us again tomorrow by 6:00 am to get all di election tori as e go dey happun live.

    Police men in Kano

    Wia dis foto come from, Kano Police command

    Wetin we call dis foto, Police men in Kano
  3. For dying minute, INEC comot di names wey APC national give dem for Cross Rivers

    INEC don remove all di candidates wey APC national submit give di commission for Cross Rivers State.

    INEC announce dis one give tori pipo on Friday night, hours before di election.

    Wit dis judgement, Niger Delta minister, Usani Usani go become di governorship candidate for di state while odas from im faction too go follow enter ballot.

    Dis one dey come as Federal high court recognise the Etim John wey be di state chairman, im faction as di authenticate one for di state.

    Di state APC bin get two factions, one wey di APC national working committee recognise, Mathew Ojong faction and di Etim john, di state chairman faction.

    APC bin hold two primaries for di state, di APC national one and di oda one wey di Etim john organise wey cause kasala.

    INEC REC for Cross Rivers Dr Frankland Briyai
    Wetin we call dis foto, INEC REC for Cross Rivers Dr Frankland Briyai dey brief tori pipo about di mata
  4. Loud explosion for Enugu state

    Loud explosion sound for di busy Otigba junction for Enugu, South East Nigeria on Friday evening, night before di general elections for di kontri.

    Pipo wey carry eye see and ear hear wetin happun tell BBC off camera say nobody die but passengers inside di yellow bus run come down wit different level of injury.

    As at di time BBC tori pesin reach di place di explosion sound, she sight pipo clothes and belongings wey scata full ground.

    Di site of di explosion
    Wetin we call dis foto, Di site of di explosion
    Di site of di explosion
    Wetin we call dis foto, Di site of di explosion
  5. Police don arrest APC lawmaker ontop attack on Kwankwaso convoy for Kano, Two pipo die for di kata-kata wey happun on Thursday wey bin make APC and PDP point each oda finger

    Car dey burn

    Wia dis foto come from, Inside Arewa

    Wetin we call dis foto, Police confam say jaguda pipo burn 20 cars come damage anoda 18.

    Police for Kano don arrest House of Representatives member Abdulmumuni Jibrin, afta katakata between di ruling All Progressives Congress and di Peoples Democratic Party supporters kill two pipo.

    Katakata burst wen jaguda pipo attack former Kano state Governor Rabiu Kwankwaso convoy on Thursday for Kano.

    Police gbab Jibrin wey dey represent Kiru/Bebeji Federal constituency for Kano State togeda wit di Chairman of Bebeji local goment where the incident happun.

    Police tok tok pesin for Kano DSP Abdullahi Haruna say jaguda pipo burn 20 cars come damage anoda 18 badly, say anoda 2 pipo dey critical condition for hospital.

    Police say dem arrest Jubril because serious claim dey say naim send im supporters that he instructed his to stop PDP pipo wey bin dey go Kwanar Dangora.

    PDP and APC bin point each oda finger say na dem cause di kasala.

  6. Buhari dey good to go

    Nigeria President Muhammadu Buhari don land Katsina state, North West of di kontri for wia im go cast im vote on Saturday.

    Governor Aminu Masari and some senators plus oda important personality dey ground to receive am before di president head to Daura im hometown.

    President Buhari bin travel go Katsina last week Thursday wia im first campaign before im move go Daura to wait for di election before dem postpone am.

    Muhammadu Buhari and oda VIP's

    Wia dis foto come from, Twitter/@BashirAhmaad

    Wetin we call dis foto, President Muhammadu Buhari don land Katsina to cast im vote
  7. Last minute travel to vote, 'We no want our PVC to waste’

    Although rush no too dey motor parks like last week, some pipo still travel again to dia village to make sure say dem vote on Saturday.

    John for Benue state tell our tori pesin say last Saturday im waste about eight thousand naira to travel from Abuja to Gboko before dem postpone di election but say im still dey im village to vote to ensure say im PVC no waste.

    But for Kano, last minute rush to travel no dey and some drivers tok say pipo wey dey serious to travel don already go yesterday and dis morning, di ones wey remain na short short journey.

    Kano Line Motor Park
    Wetin we call dis foto, Kano Line Motor Park no too busy like dat
    Traveller for motor park
    Wetin we call dis foto, John one of di pipo wey travel last week before dem postpone di election
    Tyekula na one of di pipo wey travel
    Wetin we call dis foto, Tyekula for Benue tell BBC Pidgin say im feel fulfilled sayim travel to cast im vote.
  8. 'Raise your hand'

    To reach plenti communities for Bayelsa state, South South Nigeria, you must pass water.

    Our tori pesin for Bayelsa say securtiy no take chances as dem dey keep watch for di waterside area dem too.

    As you dey pass you must raise your hand, declare yourself to show say you pure and you no carry.

    Pipo ontop canoe raise dia hand as dem pass military checkpoint onotp water for Bayelsa
    Wetin we call dis foto, Pipo ontop canoe raise dia hand as dem pass military checkpoint onotp water for Bayelsa
    INEC dey load bats wit election materials
    Wetin we call dis foto, INEC dey load election materials to cross river for Bayelsa State for here, dem hire plenti boats to epp carri di materials.
  9. BBC Pidgin dey live

    BBC News Pidgin pre election yans wit Nigerian musician and activist Ade Bantu.

    Follow us ontop social media for Facebook, Instagram and Twitter for @BBCNewsPidgin

    You fit also join di conversation wit di hashtag #BBCNigeria2019

  10. Market women for Benue state dey ginger

    Some market women for Benue state tell our tori pesin how dem reason di whole election mata.

  11. Election Friday shopping?, Market dry well-well

    Unlike last week wey some pipo rush do Election Friday shopping as our tori pipo take eye see for different parts of Nigeria, dis week just dey normal as if say di postponement kill spirit well-well.

    Market for Kano
    Wetin we call dis foto, For Kano, nothing like rushing as some market pipo tell BBC Pidgin say dis week just dey normal say dem never sell much today unlike last week.
    Umar Ahmed na Yam seller for Uyo, Akwa Ibom state
    Wetin we call dis foto, Umar Ahmed wey dey sell yam for Akpan Ndem market for Uyo, Akwa Ibom state say im never sell up to 5 tubers of yams today.
    Market woman for Uyo, Akwa Ibom state
    Wetin we call dis foto, For madam Grace Ekpenyong for Uyo, Akwa Ibom state, "election go come and go but na her business concern her and she no dey happy say she no go open tomorrow."
    Pipo dey market for Afikpo, Mile one Diobu, Port Harcourt Rivers state
    Wetin we call dis foto, For Afikpo Market for Mile One Diobu, Port Harcourt, even though say pipo jam pack di market, dem say na just normal market dem come say di election go come an go.
  12. INEC don put Zamfara APC candidates name back ontop Ballot, INEC bin excuse di candidates afta court rule say wuru-wuru join di primary elections wey produce dem

    APC candidates dey good to go for Zamfara.

    Di Independent National Electoral Commission (INEC) say di candidates of di All Progressives Congress go participate for di National Assembly, govnorship and state House of Assembly elections for di state.

    INEC tok dis one inside statement wey Chairman of Information and Voter Education Committee Festus Okoye sign and release on Friday.

    Di commission say dia decision follow di result of di judgement wey Court of Appeal for Abuja give on Thursday wey push go corner di judgement of di Federal High Court for Abuja wey rule say APC fail to conduct primaries so dem no go fit front candidates.

    INEC bin remove APC candidates for Rivers and Zamfara from Ballot ontop say primaries wey dem do no make head.

    With dis development now APC Zamfara dey good to go.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  13. 'We no comot pipo name'

    John Adi
    Wetin we call dis foto, John Adi na Electoral Officer for Oredo local goment, Edo State.

    Some of di pipo wey bin train as INEC ad hoc staff say dem no see dia name for list even for Edo State. But John Adi, electoral officer for Oredo local goment, tell our tori pesin say no be say dem remove pipo name add odas.

    According to am, di tin wey happun be say dem announce training for 2600 pipo, but pipo wey show pass 3200.

    Oga Adi say, wen dem try chase dey comot dem begin beg, so dem join evribodi for di three days training. But as e dey so, im get more Dan 1,800 Corpers for im local goment and all of dem must participate as ad hoc staff as dem already get agreement wit NYSC and as na 2600 pipo dem need to work as ad hoc staff, e no possible to employ pass di number.

  14. Election adhoc staff dey para for INEC headquarters for Calabar

    Adhoc staff wey bin get training but no fit find dia name on di list dey chant we no go free follow oga for Calabar, Cross River State Capital.

  15. NDLEA arrest man wey carry 244 PVCs for Akwa Ibom

    Pipo wey dey tackle illegal drugs matter for Nigeria, NDLEA say dem don arrest one man wey carry 244 PVCs for bodi inside Akwa Ibom State south-south Nigeria.

    Di Nigeria Drug Law Enforcement Agency say na for Mbo Local Goment Area dem arrest di man togeda with N310, 000 wey dem see for im hand.

    NDLEA say dem arrest di man during dia pre-election raid of some communities and dem don hand over di man to INEC for prosecution.

    Election materials for Akwa Ibom
  16. Special Friday Prayers for Nigeria election

    Sheik Abubakar Sheka say make politicians remember di sacrifice wey voters make to get dem into office.

    Inside one special Friday prayer for for peaceful elections inside Kano northwest Nigeria, di imam yan say make Nigerians no fight on top politics as any muslim wey kill anoda muslim na hell fire straight get am

    special Friday prayer for for peaceful elections inside Kano northwest Nigeria
    Wetin we call dis foto, Special Friday prayer for for peaceful elections inside Kano northwest Nigeria
    special Friday prayer for for peaceful elections inside Kano northwest Nigeria
  17. Representatives of political parties raise hand for INEC

    Representatives of political parties for Cross River state, south-south Nigeria don pass vote of confidence on INEC oga for di state.

    Castro Esama of Young people’s party wey speak on behalf of di parties wen dem dey meet with di REC talk say dem get confidence say the REC go provide level playing ground for all di parties

    Representatives of political parties
  18. Goment provide free bus for voters to travel across Rivers State

    One of di Free bus Rivers  provide for voters to Andoni local goment
    Wetin we call dis foto, One of di Free bus Rivers provide for voters to Andoni local goment
    Di bus go still being dem come back to Port Harcourt after di election
    Wetin we call dis foto, For State Broadcast on Thursday Rivers State Guvnor Nyesom Wike say dem go provide free buses wey go carry pipo go dia village so dem fit go vote.
    Di bus go still being dem come back to Port Harcourt after di election
    Wetin we call dis foto, Di bus go still being dem come back to Port Harcourt after di election
  19. Shooting dey happun near INEC office for Bayelsa

    Shooting dey happun near INEC office for Bayelsa
    Wetin we call dis foto, Tori be say at least one pesin fit don die and anoda injure for di shooting.

    Shooting dey happun near INEC headquarters Yenegoa, Bayelsa State.

    Tori be say at least one pesin fit don die and anoda injure for di shooting.

    Less than 24 hours to election, INEC neva distribute materials for Bayelsa

    It be like say boys bin dey rob at gun point and di military kolobi dem and kill one of di robbers and carried im deadi bodi comot.

    Na flying bullet Stray bullet kill one barrow pusher and injure two odas.

    Students of Niger Delta University
    Wetin we call dis foto, Students of Niger Delta University for Bayelsa State south south Nigeria no send di public holiday wey di kontri goment give to allow pipo to ready wella for di election as dem enta class on Friday to do lecture.
    Students of Niger Delta University
    Wetin we call dis foto, Students of Niger Delta University dey class room on Friday
  20. Election Observers for Kano

    Election observers for Kano

    Comrade Musa Baban Iya and Elizabeth Ayodele wey dey represent CILAC and Women For Better Life na some of di independent Observers inside Kano, northwest Nigeria.

    Dem say dem happy so far wit di preparations and dey hope for peaceful elections on Saturday.

    Mallam Murtala
    Wetin we call dis foto, Meanwhile Mallam Murtala still dey hopeful: Im name no follow for INEC adhoc staff list but im still waka go INEC office for Kano hoping say one of those wey dem bin select no go show face and dem go ask am to replace dat kain pesin. Im tell BBC Pidgin say im don work as Adhoc Staff for INEC since 1999 elections and this is na di first time dey missg out. Murtala bn apply but im dey blame INEC staff for some underground moves wen dem dey select pipo wey go work.