How Nigerians, world leaders celebrate Buhari

INEC, di electoral joinbodi for Nigeria don declare President Muhammadu Buhari of di All Progressives Congress, APC, di winner of di 2019 presidential elections.

Live Coverage

Daniel Semeniworima and Nduka Orjinmo

  1. , Former presido Goodluck Jonathan don show to vote

    Jonathan
  2. , INEC officials as dem show for polling units

    Wetin we call dis Video, Voting don start for most parts of di kontri
    Voters
    Wetin we call dis foto, For Port Harcourt, voters still dey wait for INEC officials to show as at 9:00am, one hour afta voting begin.
  3. If we no win, dat na wetin Nigerians want - Peter Obi

    Di vice-presidential candidate of di People's Democratic Party, oga Peter Obi don vote for im ward for Agulu village for Anambra State, southeast Nigeria.

    For short speech wey im make afta im vote, im say if im party no win, dat na wetin Nigerians want.

    Peter Obi
  4. , Voting neva start for Adams Oshiomole polling unit

    Dem still dey range things ast at 8:52am for di polling unit of di chairmo of di All Progressives Congress oga Adams Oshiomole.

    Voting
  5. , Pikin dem wey no fit vote for Kano State, get dia own thing wey no concern voting

    Footballer
  6. Voting neva start for many polling units for southern Nigeria states

    BBC tori pipo wey dey ground for southern Nigeria states dey report say voting neva begin by 8am.

    As at 8:25am, BBC tori pipo see INEC staff wey just dey arrive or still dey set up.

    For Cross Rivers, Rivers, Edo, Akwa Ibom, Bayelsa and Delta, different polling units neva begin vote even though voters dey ground.

    Trader
    Wetin we call dis foto, For dis polling unit for Port Harcourt, election officials neva show face
    Election officials
    Wetin we call dis foto, Dis na for Delta State wia for some areas, election officials just dey land
    election officials
    Wetin we call dis foto, For Bayelsa state, di polling officers dey set up
    voting
    Wetin we call dis foto, Dis na for Cross Rivers State wia voting neva begin
    voting
    Wetin we call dis foto, Polling station of presidential candidate of Social Democratic Party, Donald Duke wia voting neva begin
  7. Buhari don vote for im village Daura

    Nigeria presido Muhammadu Buhari and im Aisha don vote for dia polling station for Daura.

    Im vote for im ward wey be Sarkin Yara.

    Im tell tori pipo say im go congratulate imsef, becos im know say im go win.

    Buhari votes
  8. How payment of allowee, transport and security delay early start of vote for Makurdi

    INEC benue

    Election for Makurdi, Benue State capital for north central Nigeria start late for Walamayu ward as some adhoc staff say dem no go go dia polling unit go work except INEC pay dem dia N4,500 allowee.

    Di INEC staff bin suppose deploy to Wallamayu area and e get about 40 polling unit under am. Some oda group complain say dem no go fit go dia polling unit because no security official dey to join dem to di polling unit. Even transport to cari di material go do polling unit no dey.

    INEC official say na since 6: 30 am na im dem distribute material but motor neva dey to transport am. She also explain give say dem don pay a few adhoc staff but gatz suspend am because di tin dey take time. Dem don beg di adhoc staff make dem dem go dia polling unit as dem go go dia go pay dem dia moni.

  9. Voting don begin for some parts of Nigeria

    As clock nack 8 sharp, many polling units open for different parts of Nigeria.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  10. Voters don begin line up for Abuja

    Many voters don begin show for Dutse Alhaji, inside Abuja. Many of di voters say dem show early dis morning for di polling station wey dey one primary school before 6am to make sure say na dem first vote.

    voters
  11. , Election bodi INEC full ground to hear from you. If you see anything you go wan report, see dia numbers.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  12. , Election officials don arrive

    Members of di National Youth Service Corps wey be polling officers wey dey run things on election day don tanda for different areas for Nigeria.

    Corper
    Wetin we call dis foto, Campaign materials no suppose dey polling units, so dis polling officer dey do di needful.
    corper
    Wetin we call dis foto, Ballot boxes, chairs and tables and oda gbogbotibo wey dem go need to do work, follow di corpers land.
  13. No allow your PVC waste - RMD

    Nollywood oga Richard Mofe-Damijo aka RMD cari scope enta inside BBC Pidgin studio. Im dey ginger young pipo make dem remember di power wey dey dia hand.

    Wetin we call dis Video, Young pipo time don reach to take power from inside Party - RMD
  14. Na hia PDP candidate Atiku go vote

    Dis na di polling unit wia presidential candidate of di People's Democratic Party Atiku Abubakar go vote for Adamawa State. Pipo don begin gada to wait for voting to begin.

    Atiku PU
  15. One kontri, different cities.

    Market don open around di area wia PDP vice-presidential candidate Peter Obi dey live for Anambra State, southeast Nigeria. Di kweshun na weda dis pipo no go vote?

    traders
    Voters
    Wetin we call dis foto, For northern Nigeria state of Kano, di tori dey different. Pipo dey wait kampe for dia polling units, even before election officials arive.
  16. Bomb blasts for Maiduguri, gunshots for Yobe

    Pipo for Maiduguri, di Borno State capital for northeast Nigeria wake up wit sound of plenti bomb blasts on elecrtion day.

    Tori be say e reach seven explosions wey nack di city. Borno State don get plenti wahala from Boko Haram ova di years even as goment don claim "technical defeat" against di militant sect.

    As da one dey happun, pipo for Yobe State also for northeast, hear gunshots wey make dem run comot for di Geidem area wia pipo bin don dey line up for voting.

  17. First time voter

    Pipo don begin line up for Shagari Clinic polling unit for Yobe State, northeast Nigeria and one of dem na Ahmad Abubakar wey be first time voter.

    Abubakar
    Shagari PU
  18. , Voters don begin line up for Taraba State

    Taraba voters
  19. , Di positions Nigerians go vote for on Saturday.

    Nigeria election

    Wia dis foto come from, Getty Images

    Ballot papers

    Wia dis foto come from, Getty Images

  20. 5.30 am, Edo State south-south Nigeria

    Dis early mor-mor, staff of election bodi INEC for Benin, di Edo state capital don begin range voting things to begin waka. Na from 8am voting proper go start, but pipo go begin line up before then.

    INEC staff